By: Esther Ayoola
Members of Lagos State House of Assembly like dis, don join hand dey back oga Presido, Bola Tinubu make he run for second term as Presido.
Dem take di decision for Tuesday plenary afta Ladi Ajomale from Oshodi/Isolo Constituency II move di motion.
Ajomale spread bodi explain di Tinubu administration important reforms, like student loan scheme, removal of fuel subsidy, and big infrastructure projects like Lagos Coastal Road.
Say all dis work need continuity, so dat Naija go continue to progress.
Deputy Leader Richard Kasumu also support di motion, stating dat, di country foreign reserve don improve under di current government.