Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Gorment Tell Employers to Check Workers Mental Health

Lagos State Gornment don tell employers make dem dey use Employee Assistance Programme to support workers mental health and improve safety for work. Dis one come as dem mark World Safety Day wey dey happen every April 28, as Lagos State Safety Commission release statement for Monday. Di Director-General of di Commission, Lanre Mojola, still congratulate workers, employers and safety people for di important day. Dem also tuk say even with awareness, work askidents and sickness still dey hapun plenty, […]

todayApril 28, 2026 18

Politics

Jandor Hold Ground For 2027 Lagos Race

Di pipos democratic party 2023 lagos governorship candidate, Dr Abdul-Azeez Adediran wey dem sabi as Jandor don talk say im still dey inside 2027 Lagos governorship race. Dis one happen even as plenty APC leaders dey endorse Deputy Governor, Dr Obafemi Hamzat, for di position. Pipo like Governor Sanwo-Olu, Speaker Mudashiru Obasa and Chief of Staff Femi Gbajabiamila don show support for Hamzat. Reacting, Jandor tuk say e respect all di endorsements but insist say party rules on direct primaries […]

todayApril 28, 2026 26

Health

Dr Ibijoke Sanwo-Olu Launch N70m Health Fund for Lagos Hospitals

Wife of Lagos State Govo, Dr  Ibijoke Sanwo-Olu, don announce N70 million endowment fund to support poor pikins wey need surgery for Lagos State. She tuk dis one during pediatric surgical support event wey Orunsii Welfare Foundation organise. Say di fund go support patients for 14 public hospitals, including LASUTH and National Orthopaedic Hospital. She also talk say di initiative na about compassion and helping pipo, quoting say no be all of us fit do big things but we fit […]

todayApril 28, 2026 37

Lagos

Hamzat Thank Sanwo-Olu For Endorsing Im Push For 2027 Governorship Race

By: Esther Ayoola Lagos Deputy govo, Obafemi Hamzat don show appreciation to Babajide Sanwo-Olu afta e endorse am as preferred successor for 2027 governorship election for Lagos State Naija. Hamzat tuk dis one on Monday for him X handle, say di endorsement na big vote of confidence on his  leadership and service to Lagos people. Di deputy governor also promise say if dem give am chance, e go continue good governance and better service delivery for di state.

todayApril 27, 2026 26

obodo oyinbo

South Africa Presido Tell Immigrants, To Respect South Africa Laws, Traditions

By: Esther Ayoola South Africa Presido, Cyril Ramaphosa don tell Nigerians and other foreign nationals wey dey live for South Africa say make dem respect di country laws, culture and traditions. Ramaphosa tuk dis one on Freedom Day during SABC News broadcast on Monday, as tension over anti-foreigner mata dey rise for some parts of di country. E advise say anybody wey dey South Africa legally suppose follow di rules just like dem expect respect from other countries. Di president […]

todayApril 27, 2026 18

National

Military decide Say Na Senoirmen Dem Wan Recruit Fight Insecurity

By: Esther Ayoola Nigerian Armed Forces don unveil plan to engage retired personnel to help tackle rising violent conflicts through mediation and community peacebuilding for Naija. Chief of Defence Staff, Olufemi Oluyede, convasate dis one on Monday for Abuja during flag-off of mediation and conflict resolution training for veterans. Di training wey Retired Members of di Nigerian Armed Forces organise with Mediation Training Institute and Defence Headquarters go teach ex-soldiers modern skills on negotiation and peacebuilding. According to am, di […]

todayApril 27, 2026 34

National

Remi Tinubu Launch Food Bank For N’East

By: Esther Ayoola Wi first lady, Oluremi Tinubu don launch National Community Food Bank Programme for Borno State Naija, say di project go hellep fight hunger and malnutrition for di region and Naija at large. She tuk dis one during unveiling of di programme on Monday, explain say na her first assignment for Borno, especially to support children and mothers wey need hellep. Earlier on April 3 for Abuja, Ali Pate bin announce say di programme don receive over N66 […]

todayApril 27, 2026 17

Sports

JUST IN: Anthony Joshua Pick Date for First Fight After Car Askident

By: Esther Ayoola Anthony Joshua don finally decide say im wan return to boxing ring on July 25 for warm-up fight ahead of im long-awaited clash with Tyson Fury. Saudi boxing chief, Turki Alalshikh, naim dey announce dis ogbonge update, say Joshua go fight Albanian heavyweight Kristian Prenga for Riyadh, Saudi Arabia, as part of Esports World Cup event. Di fight na Joshua first appearance since im knockout win over Jake Paul for December, before him later get minor injury […]

todayApril 27, 2026 31

Lagos

BREAKING: Sanwo-Olu Back Hamzat for Lagos Governorship Race

By: Esther Ayoola Lagos state govo, Babajide Sanwo-Olu like dis don join endorse im deputy, Kadri Hamzat, as All Progressives Congress candidate for 2027 governorship election for Lagos. Sanwo-Olu make di announcement for Lagos House, Marina, in presence of state executive council members, APC leaders, and all 57 local government and LCDA chairmen. Di governor say Hamzat get enough experience and deep knowledge to lead di state, na why e support am to contest for di top seat. E add […]

todayApril 27, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds