By: Esther Ayoola
One ogbonge group, wey call dem selves, Governance Advisory Council (GAC), wey be top advisory body of All Progressives Congress for Lagos State, like dis don join force endorse Dr. Kadri Obafemi Hamzat as dem consensus candidate for 2027 governorship election.
Chairmo of GAC, Oluyole Olusi, naim convasate dis mata to tori pipo on Tuesday as Govo Babajide Sanwo Olu carry Hamzat go see dem
Oluyole say, GAC stand gidigba behind Hamzat, say make oga Deputy nor too worry bodi for di Lagos 2027 governorship race.