Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Traffic Arrest Ambulance Driver Say Im Wunjor Dispatch Rider

By: Esther Ayoola Nor be small gbege oh, between Lagos State Traffic Management Authority and  one ambulance driver,  say im go,  wunjor one delivery rider for leg for Odo Iya-Alaro bridge wey dey go Maryland along Ikorodu road. The two  both of dem drag demsleves for  traffic wella wella, nor be small. Lagos state traffic management agency tuk tuk person, Adebayo Taofiq, confirm the matter for statement on monday. Wey dem con explain give tori pipo,  the trafic management talk […]

todayDecember 9, 2025 13

Lagos

Lagos Gorment Ginger Dia Women Leaders To Wrestle Tuberculosis

By: Esther Ayoola Based on the rascality of the ogbonge diseases wey dem dey call,  tuberculosis, Lagos State gorment  like this like this don enter meeting  appoint womens with capacity,  including female lawmakers, newly elected female local government chairmen, and wives of lawmakers say make dem act as Ambassadors to fight tuberculosis for community level. This particular event dem  hold for First Lady Banquet Hall, Lagos House, wia the  First Lady,  Dr. Ibijoke Sanwo-Olu l charge di womens like touchlight […]

todayDecember 9, 2025 12

Lagos

Oworonshoki Taskforce Dey Demand ₦1m Bribe Make Dem No Touch People House — JEI

By: Rilwan Agbomeji One widow wey dey stay for oworonshoki don cry o say belle no sweet am di day wey lagos state govern come demolish her house wey she dey stay for more than 35years, she yarn dis mata for one siddon talk programme wey tori pipo cary take interview her on Monday. she talk say government no notify dem, say na middle of di night na im government come notify dem say make dem pack dia kaya commot […]

todayDecember 8, 2025 18

International

TikTok Lock Night LIVE For Naija

By: Rilwan Agbomeji TikTok don announce say dem go block Nigerians to dey use  LIVE late-night as from Sunday midnight, and na part of one serious safety investigation wey dem dey run. Plenty creators see in-app notice wey tell dem sharp-sharp say from 11pm reach 5am, LIVE don waka disappear and anybody wey try enter go just meet “No Access.” Di move shock users because even LIVE shows from other countries no open again, TikTok just shut everywhere tight, talk […]

todayDecember 8, 2025 33

Sports

Guardiola Ginger Im Boys To Stay Gallant Against Real Madrid

By: Rilwan Agbomeji Pep Guardiola don warn im Man City boys ahead of Wednesday Champions League clash with Real Madrid, say Bernabeu no be playground. E talk dis one afta City beat Sunderland 3–0 for Premier League, remind everybody say Madrid no be team you dey joke with. Even though Madrid just chop 2–0 to Celta Vigo, Guardiola yarn say Bernabeu fit humble any big team wey no shine eye. E add say City get more players than last time, […]

todayDecember 8, 2025 13

National

Tinubu Wife Remi Warn Say She Fit Off Gov Adeleke Mic As Im Dey Sing

Nigerian First Lady Oluremi Tinubu don threaten to off Gov Adeleke mic as im dey sing for her installation as Yeye Asiwaju Gbogbo Ile Oodua on Sunday. Video wey trend show say Adeleke dey sing worship songs while dey give speech, but Remi waka go stage warn am make e stop or she go cut mic. She mouth say, I give you five minutes to conclude your speech, enough with the music, or I will switch off the microphone. Na […]

todayDecember 8, 2025 52

National

Court Reject Nnamdi Kanu Plan To Comot Sokoto Prison

Federal High Court Abuja on Monday block Nnamdi Kanu ex-parte request to move am from Sokoto prison go another centre. Kanu, wey dey serve terrorism conviction, say e want shift go Suleja or Keffi so e fit follow up im appeal well well. But Justice James Omotosho talk say dis kain request no fit pass without hearing from Federal Goment and Correctional Service. Di judge order say make dem get notice first before court go even reason any transfer.  

todayDecember 8, 2025 19

National

Federal Goment Release N50m Free Money Package For Tertiary Students

Federal Goment don open ground for Abuja on Monday as dem launch one N50m Student Venture Capital Grant wey go ginger innovation, research and entrepreneurship for all for all tertiary schools across Naija. Education Minister Dr. Tunji Alausa talk say dis S-VCG no be any normal grant at all, na big national investment wey align with Tinubu Renewed Hope Agenda, and e go fish sharp brain ideas from campus, boost creativity and turn students to correct innovators. Di program wey […]

todayDecember 8, 2025 17

National

Jaguda Boys Enter Church With Bad Character Kill Priest Wife For Anambra

By: Esther Ayoola Some armed Jaguda boys, based on rugged movement, don carry their bad character enter St. Andrews Anglican Church for Isiokwe, Lilu, Ihiala, Anambra State early Sunday, burn priest house and  kill two people. According to Eye wey see,   one of di persons wey kpai, na di wife of di priest, as them scatter  vehicles and properties scatter for the church compound. Di whole wahala happen early Sunday,  stop  church activities comot, and people still dey fear for […]

todayDecember 8, 2025 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds