Blog masonry

Background

National

Dem Promise Me ₦100,000 Make I Bomb Worshippers – Suspect

By: Rilwan Agbomeji One suspected Boko Haram suicide bomber, Ibrahim Mohammed, wey troops of Operation HADIM KAI catch with local hunters for Yobe, don yarn how dem recruit and send am go attack. Ibrahim talk say dem pay am ₦100,000 to carry out suicide bombing wey target worshippers for Maiduguri. Di guy admit say na im join di December 24 bomb attack for Gamboru Market Mosque. According to am, na Boko Haram commanders wey dey Adamawa and Mandara Mountains plan […]

todayDecember 31, 2025 8

foreign

Putin Give First 2026 New Year Speech

By: Rilwan Agbomeji Russian Presido, Vladimir Putin, don knack hand for chest say Russia must win di war for Ukraine and call on im pipo make dem support soldiers. Im sukili dis one put for im New Year’s Eve speech for Kamchatka, di first region wey enter 2026 Im encourage im soldiers and and call on Russians to show support

todayDecember 31, 2025 11

National

Peter Obi Officially Japa To ADC For 2027 Elections

By: Rilwan Agbomeji Peter Obi, wey be Labour Party presidential candidate for 2023, don officially dump LP join African Democratic Congress, ADC. Obi yarn dis tori for Enugu on Wednesday, December 31, 2025, as coalition parties dey line up ahead of 2027 election. Di former Anambra State governor tuk say na Naija mata push am take change party. According to am, im move na how e wan take transform and rescue Nigeria from di present wahala.

todayDecember 31, 2025 3

National

How House Of Rep Wan Protect Pikins From Jaguda Mama

By: Esther Ayoola House of Representatives don propose constitutional amendment to protect unborn pikin if im mama dey pregnant and dem sentence her to death, di move come after House Committee on Constitution Review, wey Deputy Speaker Benjamin Kalu dey lead, adopt di bill on Monday in Abuja. Di proposed change go add new subsection (1A) to Section 33(1) of 1999 Constitution, wey tuk say pregnant woman wey dey convicted of offence wey fit attract death sentence go instead get […]

todayDecember 31, 2025 7

Sports

Michelle Alozie Hail FIFPro World XI Nomination As Big Honour

By: Esther Ayoola Super Falcons defender, Michelle Alozie, don troway salutation to her Nigerian teammates say her nomination for FIFPro World XI na big recognition of her hard work with Nigeria national team. According to sport aproko pipo, dem include Alozie among di 26 players wey make di 2025 FIFPro World XI nomination list for October. FIFPro World XI na di only global football award wey professional footballers themselves dey vote for. Alozie na one of three African players wey […]

todayDecember 31, 2025 4 2

obodo oyinbo

Mali, Burkina Faso Block Americans From Dia Country

By: Esther Ayoola Mali and Burkina Faso don place travel restriction on American citizens after di US put dem for no-entry list. Both countries’ foreign ministries tuk say di action na “equivalent measures,” as response to President Donald Trump decision to expand US travel ban reach almost 40 countries dis month. Di US list include Syria, Palestinian Authority passport holders, and some African countries like Niger, Sierra Leone and South Sudan, based only on nationality. White House explain say dem […]

todayDecember 31, 2025 7

Lagos

Balogun Market Fire Kill Five As Another Blaze Burn Shops For Oshodi

By: Esther Ayoola Lagos State Fire and Rescue Service tuk say fire wey gut Great Nigeria Building for Balogun Market, Lagos Island, don kill five people, after dem recover two more bodies from di rubbles on Sunday. According to di agency Controller General, Margret Adeseye, another fire break out Monday evening for Arena Market, Bolade area of Oshodi, Lagos State. She say dem receive distress call around 5:50pm and immediately deploy fire fighters, wey reach di scene within five minutes […]

todayDecember 31, 2025 6

Lagos

Governor Sanwo Olu Cancel Lagos Greater Fiesta

By: Esther Ayoola Area spoil say Lagos State Government don cancel di 2025 Greater Lagos Fiesta wey suppose hold today, December 31, 2025. Governor Babajide Sanwo-Olu, through im media aide Gboyega Akosile, ask make instead of di fiesta, Lagos people spend di time for personal prayers for Nigeria, Lagos State and everybody wey dey live for di state. Di governor urge residents make dem pray for peace, good leadership, prosperity, productivity and general wellbeing. Im wish all Lagosians happy and […]

todayDecember 31, 2025 6

National

President Tinubu Say New Tax Law Go Run From January

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu tuk say new tax laws wey dem pass on June 26, 2025, plus di remaining ones wey go start January 1, 2026, go take effect as dem plan am. For statement wey im sign by imself, Tinubu say di reforms be once-in-a-generation chance to build fair, competitive and strong money system for Nigeria. Im explain say di new laws no be to increase tax, but to reset di system, harmonise rules, and protect people […]

todayDecember 31, 2025 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app