Blog masonry

Background

Lagos

NASS Insist Say, Dem Must Check Wetin Cause Fire For Lagos International Airport

By: Esther Ayoola Members of wi National Assembly don open mata, say dem dey wait, dem dey make Federal Airports Authority of Naija (FAAN) finish im investigation into di fire wey happen for Murtala Muhammed International Airport, Lagos on Monday. Say afta dat, dem go check dia own, to know wetin really cause di fire. U sabi, FAAN Chairmo, Abdullahi Ganduje, commend di airport management for how dem handle di emergency, say dem do James Burn quench di fire. However, […]

todayFebruary 27, 2026 4

OBODO NAIJA

NAFDAC Staff For Lagos Lock Out As Union Protest Sachet Alcohol Ban

Operations for National Agency for Food and Drug Administration and Control office for Lagos State don scatter on Wednesday as union members lock NAFDAC compound gate for Isolo. Staff wey come early go work no fit enter as members of National Union of Food, Beverage and Tobacco Employees block both entrance and exit gate to protest. Dem dey protest because NAFDAC still dey enforce ban on alcohol wey dem dey sell for sachet and small PET bottle below 200 millilitres. […]

todayFebruary 26, 2026 3

OBODO NAIJA

Court Postpone Anthony Joshua Driver Trial

Magistrate court don adjourn di trial of di driver wey involve for crash wey affect boxer Anthony Joshua, as prosecutors go seek legal advice from Ogun State DPP. Di driver, Kayode, appear for court on Wednesday over reckless driving allegation, as prosecutor Kadiri tell court say dem don send di case file go Ogun DPP for review. Police counsel earlier ask for adjournment make dem fit duplicate case file and send am go attorney-general through DPP, but defence lawyer oppose […]

todayFebruary 26, 2026 5

OBODO NAIJA

Edo Govment Condemn Attack On ADC Members

Edo state Govo Monday Okpebholo of Edo State don condemned di recent attack wey happen to members of di African Democratic Congress (ADC), for tori wey busrt come out on Tuesday night, wey im describe as internal party gbege wey don enter another level. Di govo wey sympathise with di affected members of di party talk say jaguda boys from ADC don carry dia gbege enter peaceful Edo state, say importation of jaguda boys from outside di state for party […]

todayFebruary 26, 2026 3

OBODO NAIJA

ADC Coatiate How Attack Happen

Before Before Labour party candidate for Edo state Barr. Olumide Akpata don coatiate how di attack happen untop ADC members for Edo state. Olumide yarn dis matter on Wednesday for sitdown tv tuk say them get intel say gbege go happen for where them gather for their party congress for Edo state on Monday where plenty supporters gather. Im further yarn say dis gbege happen just few minutes from di govment house and e shock say dis kind thing fit […]

todayFebruary 26, 2026 4

Lagos

Olatunji Disu Enter Office As Acting IGP  

Olatunji Disu don enter office as new acting IGP for Nigeria Police Force, as e begin carry big security responsibility for country. Disu take over on Wednesday, become di new police oga wey go dey control security operations for obodo Nigeria. E talk say e go push for serious policing to help fight jaguda doings for inside Nigerian. People dey watch sharp sharp to see how im leadership go change security story for country.    

todayFebruary 26, 2026 5

obodo oyinbo

Kim Jong Un Talk Say E Go Boost Nuclear Power For North Korea

North Korea Leader, Kim Jong Un don yarn say e go boost North Korea nuclear weapons power, as e waka go watch big night military parade with im daughter. Around 14,000 soldiers march for Pyongyang Kim Il Sung Square, dey goose-step under strong floodlight as fighter jets dey shout for sky. Kim daughter, wey people dey suspect say fit be Ju Ae, show face beside her papa for parade, but dem announce any leadership title even as talk dey everywhere […]

todayFebruary 26, 2026 4

Sports

Osimhen Nor Too Happy With Galatasaray Win Over Juventus

Super Eagles striker Victor Osimhen talk say e no sweet am di way Galatasaray play, even though dem still knock Juventus comot for UEFA Champions League play-off on Wednesday. Galatasaray manage crawl enter Round of 16 with 7-5 aggregate win afta extra-time battle for Turin, despite say Juventus nearly turn di tie upside down. Osimhen drag one goal back when Juve bin don lead 3-0, push di aggregate to 6-5, before Baris Alper Yilmaz seal am late to scatter Juve […]

todayFebruary 26, 2026 4

Lagos

Sanwo-Olu Hail Disu As E Become Acting IGP

Lagos state govo, Babajide Sanwo-Olu don hail Olatunji Disu as President Bola Tinubu appoint am Acting IGP for Nigeria Police Force. Sanwo-Olu talk say Disu deserve di work because im don serve police with strong mind, professionalism, and over 30 years oga-level experience. E still yarn say Disu be seasoned officer wey don show leadership for different serious police assignments before and e sure say Disu go perform well for di big security fight.    

todayFebruary 26, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app