Blog masonry

Background

crime

Niger Kidnap Gbege: Gornment No Still Hear From Terrorists

By: Kofoworola Olayinka Niger State Gornment say dem never hear from terrorists wey abduct worshippers during Friday prayers for Borgu LGA on August 21. Commissioner for Information, Obed Nuhu, disclose dis on Thursday, saying di attack happen for three different locations and suspected Lakurawa and Boko Haram carry am out. Nuhu say gornment still no know di exact number of people wey dem carry go, because di kidnappers never contact dem. E add say security agencies dey work to understand […]

todayAugust 28, 2026 8

OBODO NAIJA

Atiku Tell Tinubu: Your Time Don Reach, Prepare Handover

By: Kofoworola Olayinka ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, don knock Presido Tinubu gornment over promise to reduce transport fares, saying di policy come too late after fuel subsidy removal. Atiku say di gornment fail to cushion di high cost of living, adding say only about 120,000 vehicles don convert to CNG in more than three years. E say di figure na less than one per cent of about 14 million vehicles for Nigerian roads, and e describe am as evidence […]

todayAugust 28, 2026 8

obodo oyinbo

Norway King Harald V Don Kpai at 89

By: Kofoworola Olayinka Norway King Harald V don kpai  at age 89 on Friday after more than 30 years for di throne, with im 53-year-old son, Crown Prince Haakon, automatically taking over as king. Britain King Charles III mourn di death, describing Harald as im dear cousin and a big figure wey guide Norway through plenty changes. NATO Secretary General Mark Rutte and European Commission President Ursula von der Leyen also mourn am, praising di late king for im dedication, […]

todayAugust 28, 2026 6

Education

WAEC 2026 Results Don Enter Fresh Gbege

By: Kofoworola Olayinka WAEC official for Anambra, Olanrewaju Fadehan, don blow whistle over alleged glitches and irregularities for di 2026 school candidates results wey examination body release. Fadehan talk for viral video say students wey write di computer-based exam na dem suffer di wahala pass. E say di problem show around di period WAEC suppose release di results between August 3 and 5, 2026, as dem normally release am on Monday. Fadehan say something no balance, forcing WAEC to rush […]

todayAugust 28, 2026 5

Sports

Masai Russell Scatter Tobi Four-Year World Record Four Zurich

By:Mariam Ajayi American hurdler Masai Russell don blaze through 100m hurdles in 12.09 seconds for Zurich Diamond League, beating Tobi Amusan. Amusan start di race well, but Russell increase speed for middle of di race and leave everybody behind. Tobi Amusan finish second with season-best 12.23 seconds. Di result give Russell di big win, while Amusan settle for second place for di race.

todayAugust 28, 2026 9

obodo oyinbo

Irab Write Conditions Like NEPA Bill To Open Strait Of Hormuz

By: Mariam Ajayi Iran security chief, Mohsen Rezaei, don tuk say Tehran dey prepare long list of conditions before dem go open Strait of Hormuz. Qatar Prime Minister don travel go Tehran go beg Iran make dem calm down, but Iran no gree. Meanwider, US gorment pipo say Iran action na just initial gragra as American naval blockade still tight. Di mata don turn serious gbas-gbos between Iran and America, as both sides dey stand dia ground.

todayAugust 28, 2026 6

Politics

President Tinubu and APC Govo Jam Head to correct Campaign

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu and APC gofnors don hold closed door meeting for Aso Rock to settle di gbege wey dey happun for di party over 2027 campaign list. Vice Presido Kashim Shettima also meet di gofnors for NEC meeting before dem enter Presido Tinubu office to discuss di mata. Di political palava don dey ground since Wednesday as party leaders dey meet back to back to calm di mata. Dem dey try settle di gbege and put […]

todayAugust 28, 2026 6

OBODO NAIJA

High Court Give NDLEA Gbas Gbos, Make Dem Free KC Luxury

By: Mariam Ajayi Lagos Federal High Court Judge, Justice Friday Ogazi, just give NDLEA hot query make dem carry body bring social media big boy KC Luxury, come face court after dem suuk am for cell for 14 solid days like garri inside water without even charging am to any crime. AS KC Luxury lawyer wire the court ex parte motion, na so Baba Judge,  come tell the drug officers make dem use five days explain why dem hold person […]

todayAugust 28, 2026 10

Entertainment

Ayra Starr Go Make History for NFL London Halftime Show

By:Mariam Ajayi Afrobeats star Ayra Starr go become first major African artist to headline NFL halftime show when she performs for Philadelphia Eagles and Jacksonville Jaguars game for London on October 11. NFL announce di performance on Thursday, with Ayra Starr also confirming am for her Instagram page. Di game go hold for Tottenham Hotspur Stadium, London, as part of NFL 2026 International Games. Ayra Starr say she dey excited to perform for di NFL halftime show and represent Africa […]

todayAugust 27, 2026 12 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds