Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

FRSC Mourn Former Corps Marshal Dauda Biu

By: Mariam Ajayi Di Federal Road Safety Corps don mourn former Corps Marshal, Dauda Ali Biu, wey don die. Di current Corps Marshal, Shehu Mohammed, say Biu death na painful loss to im family, FRSC and Naija. Mohammed describe am as dedicated officer wey serve with discipline and commitment to public service. Biu join FRSC during di early years and later become di seventh substantive Corps Marshal, serving from July 2022 to May 2024.

todayOctober 12, 2026 10

OBODO NAIJA

Federal Gornment Wan Launch Contractors Database

By: Mariam Ajayi Federal Gornment wan launch one new database for companies wey dey find gornment contract. Di Director General of Bureau of Public Procurement, Dr Adebowale Adedokun, announce dis one for Abuja during meeting with professional bodies on public procurement reforms. E explain say di database go help government check contractors’ skills, area of work, financial strength and past performance before dem fit get government contract. Di database go also allow government ministries and agencies check contractors’ certificates, financial […]

todayOctober 12, 2026 8

Lagos

LAWMA Seal 25 Buildings For Okota Over Dirty Environment

By: Mariam Ajayi LAWMA don seal over 25 buildings for Okota because of dirty environment, as dem share 172 recycling bins give houses for Osborne Estate, Ikoyi. Di oga of LAWMA, Dr Muyiwa Gbadegesin, lead dem workers go clear plenty refuse wey people dump anyhow for Ago Palace Way, including road middle and around bridge. LAWMA carry compactor trucks, payloader, tipper trucks and street sweepers go clear di dirty place, as dem warn Lagos residents make dem stop to dey […]

todayOctober 12, 2026 6

Sports

Boniface Vex Comot Field As Leverkusen Beat Mainz 4-3

By: Mariam Ajayi Nigerian striker, Victor Boniface, once again dey vex wetin nor gud, hin even comot field say coach nor play am for Bayer Leverkusen 4-3 win against Mainz for Bundesliga on Saturday. For di 84th minute, coach Carles Martínez bring in Equi Fernández and Jonas Hofmann, but na so Boniface sit don  bench, dey shine eyes, e nor believe say, hin coachie ignore am again, na so baba vex comot. To make mata worse, Simon Rolfes, wey be […]

todayOctober 12, 2026 7

obodo oyinbo

Zelensky Fire Trump, Tell Putin Make Hin Drop Gun For 60 Days

By: Mariam Ajayi Ukrainian Presido, Volodymyr Zelensky don drop hin mouth odour unto how dem go take end di war for Urkain, say US presdio  Donald Trump go tell Russia to  agree  60 days ceasefire. Dis one dey come after Trump cast everywia with hin mouth odoour on Saturday say Ukraine need new president wey go agree peace deal. Zelensky dey respond for  interview with ABC News on Sunday say, hin nor get problem if Ukraine need new presido, with […]

todayOctober 12, 2026 10

OBODO NAIJA

Mama Remi Take Dey Beg Nigerians To give Tinubu Second Term

By: Mariam Ajayi Wi First Lady, Mama Oluremi Tinubu, Aka Iya alakara, like dis dey beg Nigerians say make dem support her hubbi, Presido Bola Tinubu for second term. She drop dis micro soft word on Sunday for Lafia, Nasarawa State, during rally wey North-Central Grassroots Mobilisation Network organise to gather support for Tinubu and Vice Presido Kashim Shettima. Senior mehn like, APC National Chairman, Nentawe Yilwatda, Imo State Govo, Hope Uzodimma and oda party members from North-Central attend di […]

todayOctober 12, 2026 7

Lagos

LASTMA Show As Dem Take Save 670 Pipo For Lagos Askidents

By: Mariam Ajayi Update for lagos, Senior mehn lagos traffic pipo don drop bomb, bring report card say  inside just nine months, na  1,409 road askident dem don witness con  save about  670 souls. Na number one tok tok person of traffic marras, Adebayo Taofiq, dey  yan dis on  Sunday. Hin say na every day di oga kpatakpata of traffic marras, Olalekan Bakare, dey shout, emergency team need to join hand  for dis askident control mata E con drop serious […]

todayOctober 12, 2026 8

obodo oyinbo

Trump Send men to Meet Ukraine Leaders To End Russia War

By: Kofoworola Olayinka According to di latest update, US Presido,  Donald Trump mehn, mehn dey arrangr ground to meet Ukraine and Europe leaders for Miami today Friday to find how dem go take stop Russia war against Ukraine. Trump main man naim tie di mata for head like gele, Steve Witkoff, and im son-in-law, Jared Kushner, go bring new plans wey dem dey  hope say go help stop di war. According by Ukraine Presido, Volodymyr Zelensky, news update, say di […]

todayOctober 9, 2026 12

National

INEC Don Set Up AI Unit Ahead Of 2027 Election

By: Kofoworola Olayinka INEC don set up special unit wey go use Artificial Intelligence, AI, to help check election results and protect im computer systems before di 2027 general election. INEC Chairman, Professor Joash Amupitan, announce dis one for Abuja for meeting with stakeholders to mark 100 days to di first vote for di 2027 election. E say INEC wan put AI tools inside di system wey dem dey use check election results, but human beings go still supervise di […]

todayOctober 9, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds