Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Senate Pass Bill Say Na Jail For Any Person Wey Try kpai Imself

Senate don pass bill for second reading wey happun yesterday, dey hold gorund say suicide attemptĀ  na crime against naija law. Na Senator Asuquo Ekpenyong, wey dey represent Cross River South, naim bringĀ  bill to replace jail punishment, with medical care and rehabilitation. Ekpenyong tok say di current law dey make people fear to seek help. Na so Senate presido, Godswill akpabio begin burst laugh, say oga na crime,dat if any bodi try am say im wan kpai him/her self […]

todayOctober 14, 2026 10

Lagos

Trailer Buy Waka Go Jam Two Buses for Berger, Wunjure Five

No be small eruku burst for Berger bus stopĀ  Lagos, say one trailerĀ  go doĀ  eye-service jamĀ  two commercial bus, wojureĀ  five pipo yangayanga for ground. Lagos traffic pipo naim rush goĀ  rescue di victims carry dem go hospital, while police come pack di broken motor go station make investigation start. LASTMAĀ  oga Olalekan Bakare, sef konfamte dis mata, wia e tell di victims family sorry. Bakare konfam say, di askident cause beta traffic come reach Otedola bridge before LASTMA […]

todayOctober 14, 2026 5 2

OBODO NAIJA

NDC Condemn Bandits Attack For Zamfara

By: Jolayemi Olajide National Democratic Congress for Zamfara State don condemn di continuous attacks wey bandits dey carry out against innocent pipo for di state. Di party spokesperson, Comrade Kassim Almustapha Kayatawa, tok dis one for statement wey dem release for Gusau, di state capital, under di leadership of Alhaji Surajo Garba Maikatako. Di party tok say Zamfara pipo dey under siege and feel abandoned, as di continuous violence dey cause fresh pain and suffering every day. NDC add say […]

todayOctober 13, 2026 9

OBODO NAIJA

Wike Promise Qatar Help Over Embassy Land For Abuja

By: Jolayemi Olajide Federal Capital Territory Minister, Nyesom Wike, don promise Qatar gornment say FCT Administration go support dem to settle wahala over land wey dem allocate to Qatar embassy for Abuja. Wike media aide, Lere Olayinka, reveal dis one for statement wey e release on Tuesday. Wike give di assurance when e meet Qatar Ambassador to Naija, Yousef Ahmed Al-Hail, for Abuja, as dem discuss diplomatic relations, urban development, investment and ways both countries fit work together. Di ambassador […]

todayOctober 13, 2026 10

Lagos

NAFDAC Catch Two Men For Fake Drink Factory For Lagos

By: Jolayemi Olajide NAFDAC operatives don uncover suspected fake drink factory for Zamfara Plaza, BBA Trade Fair Complex, Lagos State. Di agency suspect say dem dey use di place change labels for expired drinks, including Bullet Energy Drink, Don Julio tequila and Jameson whiskey. NAFDAC arrest two men for di place, but dem never release dia names as at di time dem report di incident. Video wey di agency post for im X handle on Tuesday show some of di […]

todayOctober 13, 2026 8

Entertainment

Ayra Starr Announce 20-City World Tour For New Album

By: Jolayemi Olajide Nigerian Afrobeats singer, Ayra Starr, don announce 20-city world tour to promote im third studio album, Starrgirl. Details for di singer official website show say di tour go start January 20, 2027, for Cologne, Germany, before e move go different cities for Europe, United Kingdom, United States and Canada. Di tour go pass Amsterdam, Paris, Milan, Zurich and Brussels before e reach London on February 2, 2027. Di American leg go start March 18 for Houston, Texas, […]

todayOctober 13, 2026 7

Sports

Wenger Dey Face Pressure Make E Challenge Infantino

By: Jolayemi Olajide Former Arsenal manager, Arsene Wenger, don face pressure from some pipu wey want make e challenge Gianni Infantino for FIFA presidency as opposition to Infantino leadership dey increase. Wenger, wey be Frenchman, currently dey work as FIFA Chief of Global Football Development, and some pipu don begin see am as possible candidate for di job. But Wenger never talk whether e go contest for di position, even as pipu wey want alternative to Infantino leadership dey push […]

todayOctober 13, 2026 8

OBODO NAIJA

IMF Warn Say AI Market Crash, Cyber Attack Fit Cause Gbege

By: Jolayemi Olajide IMF don warn say AI market crash and cyber attacks fit cause serious wahala for world financial system. Di International Monetary Fund drop dis warning on Tuesday for dia latest Global Financial Stability Report, wey dem release during annual meeting with World Bank for Bangkok, Thailand. IMF talk say rush to develop AI, produce computer chips and build data centres don dey push world economy forward, but di AI boom still carry risks wey fit shake di […]

todayOctober 13, 2026 5

OBODO NAIJA

El-Rufai Don Return Court For Corruption Trial

By: Jolayemi OlajideĀ  Former Kaduna State Gofnor, Nasir El-Rufai, don reach Kaduna State High Court on Tuesday as im corruption trial continue. ADC gornorship candidate, Isa Ashiru, follow am go court, after Justice Darius Khobo order ICPC to bring El-Rufai come court for di trial. El-Rufai dey ICPC custody since February 18, 2026, over allegation of financial wahala wey concern how e run Kaduna State from 2015 to 2023. Di former governor dey face different cases for different courts, but […]

todayOctober 13, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds