Blog masonry

Background

Lagos

Dangote Explain How Global Oil Wahala Fit Make Life Hard For Africa

By: Esther Ayoola Oga Presido of Dangote Group, Aliko Dangote, say global oil wahala fit make life hard for Africa if world pipo nor settle di mata fast, fast. Senoir man Dangote tuk dis tuk for meeting with wi oga presido, Bola Tinubu on Monday. Dangote warn say if oil price sti climb, pipo go suffer oh, like barbers, bakers, and those wey dey run generator, and gornments nor go increase salaries to hellep di situation.

todayMarch 24, 2026 4

Lagos

Lagos Govo Sanwo-Olu Sign Mou For Digital Learning

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, say like dis now, dem don sign MoU with digital learning company, to bring digital learning to all gornment primary and secondary schools. Im yarn dis one for him verified X page on Monday. Say, di MoU go make sure say modern digital learning platforms and Korect infrastructure enter public schools. Sanwo-Olu sti tuk say, di partnership go hellep students sabi both soft skills and hard skills, learning how to read and […]

todayMarch 24, 2026 3

Sports

Nigeria Shock Ghana, Win By 136 Runs For Patricia Kambarami Cup

Nigeria carry better all-round play beat Ghana by 136 runs for di Patricia Kambarami Cup wey dey happen for Lagos. Naija captain Piety Luck and Victory Igbinedion na im wan finish Ghana, make 44 runs for three overs, while Christabel Chukwuonye carry di innings go reach 159 for four. For Ghana side, matter scatter as dem lose five wickets for only 13 runs early, never fit recover. Nigeria bowler Peace Usen take three wickets for nine runs, Mbam Henrietta three […]

todayMarch 23, 2026 7 2

Sports

NPFL Match Day 31: Katsina, Kano, Remo, Rangers Record Win

For Sunday matas, the NPFL nor dey slack at for match day 31  as top teams  fight for points. Katsina United FC beat Shooting Stars FC 1-0, while Kano Pillars FC show power with 2-0 win over Enyimba International FC. Remo Stars FC carry 3-1-win comot for Kwara United FC, and Enugu Rangers FC waka go 2-0 against El-Kanemi Warriors FC. Some games like Warri Wolves FC vs Bendel Insurance FC and Wikki Tourists FC vs Barau FC end 0-0.

todayMarch 23, 2026 6

Sports

Lookman Score Historic Goal, But Real Madrid Still Shock Atletico 3-2

Ademola Lookman don make history as e become first Nigerian wey score for Madrid derby, but e goal no sti hellep as 10-man Real Madrid turn game around to win 3-2 against Atletico Madrid for La Liga on Sunday. Lookman don score two goals dis season for im debut campaign in Spanish top flight. Di win give Real Madrid (69 points) reduce Barcelona (73 points) lead to just four points for top of table, while Atletico still dey fourth with […]

todayMarch 23, 2026 4

Sports

Man City Beat Arsenal 2-0 To Carry League Cup

Manchester City don win dia first trophy for dis English season as Nico O’Reilly score two goals for di second half to hellep dem beat Arsenal 2-0 for di League Cup final. Arsenal wey be Premier League leaders come as favourites, but power pass favourite for Wembley stadium. Di first half no too get action, but O’Reilly first goal come after Arsenal goalkeeper Kepa Arrizabalaga fumble. Four minutes later, O’Reilly score again from Matheus Nunes cross, settle di matter as […]

todayMarch 23, 2026 4

obodo oyinbo

Israel Attack Bridges, Enter Lebanon For Long Fight

By: Esther Ayoola Israel army commander Lieutenant General Eyal Zamir on Sunday for southern Lebanon announce say Israel don begin big ground operation against Hezbollah because dem wan stop di Iran‑backed group wey dey fire rockets and violate Israel borders. Oga Zamir say dem don destroy some bridges near di Litani River wey Israel claim Hezbollah dey use cross for attack, and dem plan to advance ground operations and air strikes according to organized plan. Meanwhile Lebanese President Joseph Aoun […]

todayMarch 23, 2026 5

National

IGP Olatunji Disu Make Move To Reduce Police Tactical Teams

By: Esther Ayoola Police oga for Naija, Olatunji Disu, on Sunday for Abuja don order make dem reduce tactical teams across di country. According to police tuk tuk, Anthony Placid, say di IGP say zonal and state commands no go get pass five teams, while area commands and divisions go get only three teams. Im explain say dis decision come based on di plenty tactical units wahala and dat some dey misbehave without better supervision, dey oppress members of di […]

todayMarch 23, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app