Blog masonry

Background

National

Bode George Beg INEC Make 2027 Election Fair

By: Esther Ayoola Pipos Democratic Party senoirman, Chief Bode George ahead of 2027 general election for TV sitdon tuk without shame beg INEC oh, say make dem ensure 2027 election free and fair, dat e nor make brain to spend plenty money for election material, den glitch go con sti dey, say e nor make brain. Oga Bode shine im eye well, sharp im mouth with razor, tell INEC Chairmo, Professor Joash Amupitan, make im no allow any candidate or […]

todayDecember 30, 2025 4

Sports

Atletico Legend Enrique Collar Kpai For Age 91

By: Esther Ayoola Atletico Madrid don announce say club legend Enrique Collar don die for age 91. Collar be wey be correct left winger, score 105 goals for 470 matches and captain Atletico for 10 years during the 1960s. E help lead di club win league title and three Copa del Rey trophies, including one win against Real Madrid for Bernabeu in 1960.

todayDecember 30, 2025 5

obodo oyinbo

Trump Tell Hamas To Comot Bodi From Fight

By: Esther Ayoola US President Donald Trump don give clear warning to Hamas say wahala go dey, if Hamas no drop weapon, and sti send SMS Iran say make dem drop dia arrangements of building nuclear programme again. Trump tuk dis one afta meeting Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu for tuks about Gaza ceasefire, Iran matter, and Hezbollah issue for Lebanon. He say Israel don try for di ceasefire, but still warn Hamas make dem follow di peace agreement wey […]

todayDecember 30, 2025 18

Sports

Super Eagles Coachie Release Expo Ahead Uganda Tie

By: Esther Ayoola Super Eagles head coach, Eric Chelle, share expo, say he fit rotate players for Nigeria Group C match against Uganda for AFCON. Chelle tuk dis one on Monday for him pre-match press conference for Fez Stadium, say many players deserve chance and e no wan depend on only one fixed starting eleven. He add say for football tournament, na full squad involvement ni be di koko, not just eleven players, and dat Nigeria ready wunjor Uganda wey […]

todayDecember 30, 2025 15

National

FG Knock Air Peace CEO Say New Tax No Go Cripple Aviation Industry

By: Esther Ayoola Federal Gonment don reject claim wey Air Peace Chairman and CEO, Allen Onyema, make say new tax regime go cripple aviation industry and make air ticket cost jump. You sabi say, Onyema tuk for TV sitdon tuk Sunday di dangers wey go follow di new tax law for wi aviation. Chairman of Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, Taiwo Oyedele, respond on Monday say Onyema tuk misleading and no reflect wetin di reforms really be. […]

todayDecember 30, 2025 4

National

How NNPCL Take Do Escravos–Lagos Pipeline Afta

By: Esther Ayoola Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPCL) tuk on Monday say dem don fully restore di Escravos–Lagos Pipeline System (ELPS) for Warri, Delta State. According to statement from di company, di pipeline scarra wetin nor good afta unexpected explosion for December 10, 2025, and dem sha run one or two emergency parrol to control di damage. NNPCL explain say dem work with different experts to contain di area, repair di bad section, pressure-test am and safely put di […]

todayDecember 30, 2025 2

Lagos

Lagos Government Promise Better Flood Control For 2026

By: Esther Ayoola Lagos State Government don wire ogbonge new year promise say dem go take flood control and drainage work for 2026, to di next level based on di praise dem get for flooding season for 2025. Special Adviser to Governor on Environment, Olakunle Rotimi, ni share share dis update inside di Annual Zonal Awards of Emergency Flood Abatement Gang and Drainage Enforcement Gang for Alausa, Ikeja. Im say men need to rush di environmental workers as dem ma […]

todayDecember 30, 2025 2

foreign

US Don Promise Ukraine 15-Year Security Cover, Zelenskyy Yarn

By: Rilwan Agbomeji US offer Ukraine 15-year security guarantee as part of peace plan, Ukrainian President Zelenskyy talk on Monday. Zelenskyy yarn say e go prefer make di guarantee last 50 years to stop Russia from any further attack. US President Donald Trump host am for Florida on Sunday, talk say Ukraine and Russia dey closer to peace than before. Negotiations still dey, with wahala like who go withdraw where and di future of Russian-occupied Zaporizhzhia nuclear plant, and Trump […]

todayDecember 29, 2025 6

National

Presido Tinubu Cancel Part Of NNPC Debt Worth $1.42bn And N5.57tn

By: Rilwan Agbomeji Wi oga Presido, Bola Tinubu don to cancel big part of debt wey Nigerian National Petroleum Company (NNPC) dey owe Federation Account. Dis na according to  Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission talk for report wey dem present at November 18, 2025, Federation Account Allocation Committee (FAAC) meeting. Di report show say the cancellation go wipe about $1.42 billion and N5.57 trillion afta both NNPC and Federation Account reconcile dia records. Di approval come as part of effort […]

todayDecember 29, 2025 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app