Blog masonry

Background

National

Keyamo Shake NCAA Oga Dem Sake Of Corruption Wahala

By: Rilwan Agbomeji Minister of Aviation, Festus Keyamo, don reshuffle some big oga dem for Nigeria Civil Aviation Authority because people dey talk say corruption dey happen. Dem say di change fit get connection with poor work and weak monitoring for di Directorate of Airworthiness Standards. Meanwhile, Nigeria Safety Investigation Board release report say two different aircraft get serious incident for Kano and Owerri for December. One Hawker aircraft crash-land for Kano with eight people inside, while Cessna crash for […]

todayDecember 26, 2025 8

Sports

Chelle Drop Yarns Ahead Of Tunisia Clash

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles head coachie Eric Chelle don giv expo say e fit change tactics for Saturday Group C match against Tunisia. Di match go happen for Fes, Morocco as both teams dey chase back-to-back wins. You sabi say Super Eagles beat Tanzania 2-1, while Tunisia beat Uganda 3-1. Fans dey expect serious football as Nigeria and Tunisia ready clash for weekend.

todayDecember 26, 2025 7

Sports

CAF Arrange Malian Referee For Super Eagles Vs Tunisia

By: Rilwan Agbomeji Say confederation of African football, don appoint Malian referee Boubou Traore say make im take di centre stage as Super Eagles of Nigeria go face Carthage Eagles of Tunisia for dia Group C match for 2025 AFCON wey go happen for Complexe Sportif de Fès. Traore na well-respected referee for Africa, while Senegal own Issa Sy go handle VAR. Super Eagles don start dia campaign well with 2-1 win against Tanzania, as Tunisia beat Uganda 3-1 for […]

todayDecember 26, 2025 39

foreign

Palestine Economy Crash Sake Of Gaza War

By: Rilwan Agbomeji Palestinian Central Bureau of Statistics and Palestine Monetary Authority talk am for dia 2025 Palestinian Economic Monitor report wey dem release dis year for Ramallah. Dem say economy crash because Israel war for Gaza, tighter movement and trade restriction for West Bank, and money from inside and outside don dry, wey make govment no fit pay basic bills. According to di report, GDP for Gaza fall 84 percent and West Bank drop 13 percent since 2023, showing […]

todayDecember 26, 2025 9

National

NLC Tell Nigerians To Reject Fake Tax Laws

By: Rilwan Agbomeji Di Nigeria Labour Congress just area dey ginger Nigerians make no body gree for any tax law wey magic don enter, wey dem nor understand. Un top yanings with tori pipo for Abuja, NLC President Joe Ajaero talk say such tax policies  dey make pipo trust for gorment. E stress say tax justice mean say di rich must pay dia fair share and all unfair taxes against workers and poor people must stop. Ajaero add say real […]

todayDecember 26, 2025 7

National

PDP Drag FG As US First Break News Of Sokoto Terror Strikes

By: Rilwan Agbomeji Di Peoples Democratic Party don bash Federal Govment for how e allow United States release news of terror strikes for Nigeria before Nigerian authorities yarn anything. In a statement issued on Friday, di PDP National Publicity Secretary, Ini Ememobong, PDP talk say di govment delay make Nigerians dey depend on foreign sources for updates about critical security operations for dia own country. Di US first announce dia military strikes for Sokoto State for social media, hours before […]

todayDecember 26, 2025 8

National

Sheikh Gumi Raise Alarm Say Us Airstrike Fit Scatter Nigeria Sovereignty

By: Rilwan Agbomeji Reaction don dey trail US work for Nigeria, Islamic cleric Sheikh Ahmad Gumi don knock US airstrikes for North-West Nigeria, say e fit cause wahala and spoil Nigeria sovereignty. Dis one come afta President Donald Trump talk say US forces bomb ISIS camps to protect Christians, as Nigerian government confirm say dem dey cooperate with America on security marras. Gumi say fighting terrorists na Islamic duty, but e no suppose be foreign countries wey don kill innocent […]

todayDecember 26, 2025 5

Lagos

Lagos Fire: China-Returnee, Others Still Dey Miss

By: Rilwan Agbomeji One China-based clothier wey dem dey call Obum and three other traders still dey trapped under rubble afta fire don destroy Great Nigeria Insurance House for Balogun Market, Lagos Island. Di plaza dey popular for cloth and shoe market for both pikin and adults. Fire start for fourth floor, spread reach sixth floor, then waka go oda floors and nearby buildings. Konfam report on Thursday see say di 22-storey building burn wetin no good.

todayDecember 26, 2025 12

Sports

Super Eagles, Tunisia Set For Hot AFCON Fez Showdown

By: Rilwan Agbomeji Say tickets for Nigeria Super Eagles group match against Tunisia for fez stadium dis Saturday, say don sold out, for tournament wey pipo dey complain of low attendance. Nigeria beat Tanzania 2–1 for dia first match, while Tunisia take Uganda 3–1, so both teams get three points each. Winner for dis fez clash go almost secure qualification enter round of 16.  

todayDecember 26, 2025 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app