Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Osun Gornment Pay Fresh Palliative Give Civil Servants

By: Esther Daniel Osun State Gornment don pay anoda round of palliative give civil servants across di state to help reduce di effect of di hard economy. Gofnor Ademola Adeleke spokesperson, Olawale Rasheed, tok for Wednesday say di payment show say di gornment remain committed to workers' welfare. Im add say di administration start regular palliative payments before implementing di new minimum wage for Osun State. Di gornment say di programme go continue to improve workers' morale, strengthen public service, […]

todayAugust 5, 2026 8

Sports

Naija Boys Zadok Yohanna, Calvin Okike Land EPL List

By: Yusuf Abuh Brighton winger Zadok Yohanna and Calvin Okike don enter list of 20 young players wey fit shine well for 2026/27 Premier League season as clubs dey prepare for di new campaign. Di youngster performance attract plenty big clubs but Brighton move fast to complete di deal before oda teams fit snatch am. Football fans for Nigeria now dey hope say Zadok Yohanna and Calvin Okike go use dis season announce dia names well for England top flight.

todayAugust 5, 2026 13

Health

Federal Gorment Go Build Autism Centres Across Nigeria

By: Esther Daniel Di Federal Gorment announce plan to establish autism centres across di six geopolitical zones of Nigeria to improve care for children wit developmental conditions and reduce medical trips abroad. Di Minister of Education, Dr Maruf Tunji Alausa, make di announcement during one stakeholders' engagement, im say gorment go also expand specialist training for Audiology, Speech and Language Therapy, and Occupational Therapy. Alausa explain say di initiative go help train more professionals to improve diagnosis, therapy, rehabilitation and […]

todayAugust 5, 2026 13

Politics

EFCC Reportedly Freeze Osun Gorment Salary Account Before Gofnorship Election

By: Esther Daniel EFCC reportedly freeze one Osun State Gornment account for First Bank wey dem say gorment dey use pay workers, just days before di August 15 governorship election. Gofrnor Ademola Adeleke say di action no get legal backing and accuse EFCC of targeting di state before di poll. Di Osun State Gornment describe di report move as attempt to disrupt gorment activities. One source close to di administration confirm say di account don dey under Post No Debit […]

todayAugust 5, 2026 18

obodo oyinbo

Open Hormuz Strait Now or Face Serious Attack, Trump Give Iran Hot Warning

By: Olabisi Olatunji US Presido Donald Trump don give Iran strong warning say if dem no reopen di Strait of Hormuz very soon, America go hit dem hard, as e yarn during for TV siddun tuk on Tuesday for California. Trump tok say negotiations still dey happen between America, Iran and Oman because all sides dey find temporary agreement wey go make di important sea route open again. tension. Di warning from Trump don put di whole world on alert […]

todayAugust 5, 2026 11

National

PFN Say Dem No Go Stop To Preach For Bus

By: Esther Daniel Di Presido of Pentecostal Fellowship of Nigeria, Bishop Wale Oke, tok on Wednesday for sidun talk say Christians go continue to preach for commercial buses even if authorities arrest dem. Im react to di FRSC Amendment Bill 2026 wey propose ₦50,000 fine for anybody wey preach inside commercial vehicles. Oke say any law wey stop public preaching go violate dia constitutional right to spread di gospel. Im insist say believers go obey God and continue evangelism across […]

todayAugust 5, 2026 13

OBODO NAIJA

Naija Soldiers Dey Dance, Say Tinubu Raise dia Salary by 80%

By: Yusuf Abuh Oga Presido Bola Tinubu don approve ogbonge salary increase of between 30 and 80 per cent for about 250,000 Army men, and di new pay package go begin from September 1, 2026. Di Presidency announce di increase for statement on Tuesday, saying junior soldiers from private to staff sergeant go get 80% raise, warrant officers to colonels go collect 50%, while brigadier-generals to generals go earn 30% more. According to di Presidency, di salary review hapun because […]

todayAugust 5, 2026 12

Politics

Donald Duke Blast Lagos Calabar Highway, Say Na Wrong Priority

By: Esther Daniel 2027 presidential candidate for Peoples Redemption Party, Donald Duke, tok on Tuesday during interview for sidun tuk say Lagos-Calabar Coastal Highway na wrong priority because Nigeria no fit afford di project. Di former Cross River gofnor argue say road already dey from Lagos to Calabar, so gornment suppose repair am instead of spending billions on new highway wey im believe e no go pass Epe. Duke say di money wey gornment dey use for di 700-kilometre road […]

todayAugust 5, 2026 11

Sports

Real Madrid Loan Franco Mastantuono to Fiorentina

By: Esther Daniel Real Madrid on Wednesday agree to send young Argentine midfielder Franco Mastantuono on one-season loan to Fiorentina, as di player go return to Spain by June 2027 to continue im career. Transfer expert Fabrizio Romano confirm di agreement, say both clubs don settle di deal for Wednesday morning. Di loan move make Mastantuono di third Real Madrid player wey don leave di club this week. Earlier, Cesar Palacios and Gonzalo Garcia complete permanent transfers from Real Madrid […]

todayAugust 5, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds