Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Badenoch Drag Starmer, Call Am “Terrible PM”

By: Yusuf Abuh   Kemi Badenoch don describe Keir Starmer as “terrible Prime Minister” afta e announce im resignation as Labour leader and UK Prime Minister. Starmer talk say e go step down from Labour leadership afta less dan two years, but e go still remain Prime Minister until dem choose new leader. Badenoch react for X say di Labour gornment fail wetin no good, for policies, including tax increase, welfare reform issues and underfunding of defence. She also accuse […]

todayJune 23, 2026 8

National

Tinubu Appoint New NUC Board Chairmo

By: Yusuf Abuh   Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don appoint Professor Oluwatoyin Ogundipe as di new Chairmo of di governing board of National Universities Commission, NUC. Ogundipe dey take over from emeritus professor Olufemi Aina, wey resign from di position less dan one year afta im appointment. Baba Seyi bin appoint Aina for July 2025 and dem inaugurate di board members for November 2025. Ogundipe, wey serve as Vice-Chancellor of University of Lagos from 2017 to 2022, na […]

todayJune 23, 2026 9

Lagos

DIG Fayoade Call For Body Camera For Police To Boost Accountability

By: Yusuf Abuh Di Deputy Inspector-General of Police in charge of di Southwest zone, Adegoke Fayoade share beta security doings say make police officers begin wear cameras for body bring beta professionalism for Nigeria policing. E make dis appeal during im visit to Lagos State Security Trust Fund office as part of im tour across Southwest states. Fayoade nor hide mouth tuk say Lagos dey very important for national stability and e need better security innovation to protect am. Di […]

todayJune 23, 2026 5

Sports

France And Argentina Cruise Enter Next Round For 2026 World Cup

By: Yusuf Abuh   Unto world cup update, France national football team don show again say dem no come World Cup to con joke as dem beat Iraq 3–0,  wey make dem move to di  next round, Mbappe score two goals and Dembele naim collobi di last one. Meawhile, Argentina sef do dia own for one conner, dem settle down beat Austria 2–0,  with Messi scoring two goals. For another side, Senegal go carry baby lion go fight, but last […]

todayJune 23, 2026 11

obodo oyinbo

Ebola For Congo, Kpai 254 Pipo

By: Yusuf Abuh   Ebola don continue im bad waka affecting more dan 1,000 people for Democratic Republic of Congo, don sti spread reach third displacement camp and kpai one 18-month-old baby girl. Congolese gornment confirm say 254 people don kpai so far from di affected three provinces for eastern Congo. Health report show say dem test di baby for Ebola on June 14 for Hungbe displacement camp, but she kpai before di positive result come out di next day. […]

todayJune 23, 2026 7

OBODO NAIJA

Obi Call Tinubu Say Make E Resign Over Hardship

By: Yusuf Abuh   Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, Peter Obi, don call out wi oga Presido Bola Tinubu, say make e resign, saying di gornment don fail Nigerians as hardship, insecurity and poor living condition use rain coat wear Nigerians. Obi tuk dis one for im X handle on Monday after British Prime Minister Keir Starmer announce say e go step down from office. Di former Anambra govo say Starmer show how leaders suppose behave, when pipo nor […]

todayJune 23, 2026 8

Lagos

Lagos Police Calm Mushin Residents After Bomb Threat

By: Yusuf Abuh   Lagos State Police Command don assure residents of Mushin say dem dey safe afta explosion scare wey injure one person. Baba Commissioner of Police Fatai Tijani don do on-the-spot touch lighting, afta dem receive report of di incident. Police say dem respond quick quick afta dem hear di aproko call, about di allege say na bomb naim dey cause di panic. Dem also confirm say dia special team for bombs don already comb di area to […]

todayJune 23, 2026 15

Lagos

History Happun For Lagos House Of Assembly

Nor bi small History hapun yesterday for Lagos State House of Assembly as dem swear for dia first female clerk to run di affairs of di house. Di Speaker, Right Honourable Mudashiru Obasa, na im coordinate di swearing-in ceremony of Adenike Abolanle Oshinowo, wey break record as di first-ever woman to hold dis position since dem create di Assembly.

todayJune 23, 2026 9

Lagos

HISTORY! Lagos House Of Assembly Swear-In First Female Clerk

By: Jolayemi Olajide Today lagos state house of assembly don swear for Mrs Adenike Abolanle oshinowo as the new clerk of the house on Monday, 22nd of June, 2026. Na right honorable speaker Mudashiru obasa coordinate this matter for inside house. And like dis oooo Mrs oshinowo don become di 6th and first ever woman clerk for di lagos state house of assembly Di clerk na the oga wey dey run the work for house and make sure say everything […]

todayJune 22, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds