Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Navy Burst Illegal Refining Sites, Recover 85,000 Litres of Stolen Crude

By: Esther Daniel Di Nigerian Navy don burst two illegal refining sites and recover over 85,000 litres of suspected stolen crude oil for Ogba-Egbema-Ndoni, Rivers State, during Operation Delta Sentinel. Navy Director of Information, Captain Abiodun Folorunsho, tok dis on Thursday, say di operation stop another illegal refining network wey criminals bin try reactivate. According to am, di discovery happen few days after another similar raid for di same area, show say oil thieves still dey try continue dia illegal […]

todayAugust 6, 2026 11

Sports

Super Falcons Scatter Egypt 6-2, Enter WAFCON Quarter-Final with Style

By: Esther Daniel Nigeria Super Falcons don beat Egypt 6-2 for Tuesday night match for Casablanca, Morocco, secure dia place for di quarter-final of di 2026 Women Africa Cup of Nations after dem must win to qualify. Asisat Oshoala open di scoring for 21st minute through penalty after VAR confirm handball, before Gift Monday add di second goal for first-half injury time. Egypt manage score one penalty before halftime through Nadine Ghazi after another VAR check, but di Super Falcons […]

todayAugust 6, 2026 18

obodo oyinbo

Middle East War, Iran, US Near Peace Deal

By: Esther Daniel Iran don yarn say dia agreement with Oman to reopen Strait of Hormuz don nearly set finish after both countries agree on di route wey ships go dey follow. US Presido Donald Trump still dey tok say America and Iran dey discuss matter, and im say e prefer make dem settle am with dialogue instead of war. For anoda side, Yemen Houthis claim say dem attack two Saudi oil tankers one near Yanbu Port for Red Sea […]

todayAugust 6, 2026 11

president Bola Tinubu

National

Presido Tinubu Hail Rescue of 308 Kidnap Victims for Niger and Kwara

By: Esther Daniel Oga presido Bola Tinubu don welcome di successful rescue of 308 Nigerians wey kidnappers carry comot for separate attacks for Niger and Kwara States. Dis na according to Presidential tuk tuk person Bayo Onanuga tok inside statement on Wednesday for Abuja. Di rescue operation free 163 victims from Woro Community for Kaiama Local Government Area of Kwara and another 145 people from Niger after security operatives enter Kainji Lake National Park forest for New Bussa. Tinubu praise […]

todayAugust 6, 2026 13

Politics

Davido Beg Osun Pipo Make Dey No Fight for Election Period

By: Esther Daniel Afrobeats star Davido don beg Osun residents make dem maintain peace and shun any form of violence for Osun  gofnorship election. Davido yarn dis one as head of youth campaign mobilisation team for Gofnor Ademola Adeleke, wey be im uncle. Di singer praise Adeleke as one of di best gofnors Osun don get and encourage eligible voters make dem come out peacefully go vote without fear or intimidation.  

todayAugust 6, 2026 17

Lagos

Lagos Recruit 150 New Firefighters, Open Oworonshoki Fire Station

By: Olabisi Olatunji Lagos State Gornment don induct 150 newly trained firefighters and open di new Oworonshoki Fire Station to improve emergency response. Governor Babajide Sanwo-Olu say di move show government commitment to protect lives and property across di state. Di new officers complete six months intensive training for Lagos State Fire and Rescue Service Training Centre for Ikeja. Fire Service Controller General Margaret Adeseye urge di firefighters to remain disciplined and professional as dem begin field operations.

todayAugust 5, 2026 12

Lagos

LAWMA Boost Waste Evacuation As Olusosun Road Improve

By: Olabisi Olatunji Lagos residents fit soon enjoy cleaner streets as LAWMA improve waste evacuation after rehabilitating di access road to Olusosun Disposal Facility. LAWMA say e clear over 18,660 metric tonnes of waste across disposal sites within one week. Managing Director Dr Muyiwa Gbadegesin tok on Wednesday say di agency record 1,866 truck trips between July 28 and August 3, 2026. According to am, di road upgrade don increase operational efficiency and speed up refuse collection across Lagos.

todayAugust 5, 2026 9

Lagos

Fire Burn Houses For Yaba, No Life Lost

By: Olabisi Olatunji Lagos State Gornment say no life lost after fire destroy cluster of makeshift houses for Abule-Oja, Yaba, on Wednesday. Di fire happen for Abudu Street by UNILAG Road before emergency agencies quickly respond. Firefighters and security operatives work together to stop di fire from spreading to nearby buildings. Lagos State Fire and Rescue Service, Federal Fire Service, UNILAG Fire Service, Police and LNSC join fight di inferno.

todayAugust 5, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds