Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Trump Arrange Mhen Make Dem Rename Kennedy Art Center

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump omo with all bodness buy waka go rename top arts centre for Washington afta himself based on working. According to Konfam aproko wey come out, Kennedy center wey dem first name afta president John f. Kennedy, say now, dem go dey call am “Trump-Kennedy centre” afta board wey trump choose vote ama. Dis move na example of how trump dey influence big institutions since e return power. E don been yabyab di Kennedy […]

todayDecember 19, 2025 7

National

Oga Presido Tinubu Cut Chain For 9ja Governors

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu don cut chain oh, wia dis vex come from sef nor bodi sabi, say mama Remi never rob im head some time, omo jagaban, enter meeting for Abuja for di mata, change am 9ja govos and APC members say make dem support di idea of state police and local government autonomy. Oga presido yanyanpu dis one for di 14th APC National Caucus meeting wey hold for Abuja on Thursday, say security dey […]

todayDecember 19, 2025 6

Lagos

Lagos Court Put Man For Kirikiri For Property Yahoo Yahoo

By: Esther Ayoola Starting with matas for Lagos, say one Lagos state high court for Ikeja don tie one  mata  for one  Chidi Nwaya head like gala, sentence am to 22 years for kirikiri, say im na ole and im yahoo  N28 million  for one failed property deal for Lagos island. Justice Modupe Nicol-clay, sama  am  beta two separate jail terms, 15 years, and 7 years, but say, im go run sentence together. Di judge talk say di case don […]

todayDecember 19, 2025 7

Sports

Alonso Dey Fight Make E Still Get Im Job – Tote

By: Rilwan Agbomeji  Former Real Madrid striker, Tote, don yarn say manager Xabi Alonso dey fight to keep im job for di club. Tote yarn dis for one siddon talk show say decision to sack Alonso don almost ready as confidence don low for am. E yarn say Xabi dey struggle every three days to prove himself, and di pressure na heavy for am. According to Tote, some people no dey believe in Alonso again, wey make di fight to […]

todayDecember 18, 2025 12

foreign

Flood Force Thousands To Run Comot For Malaysia

By: Rilwan Agbomeji Bad flood don force thousands to comot from dem house for Malaysia on Thursday. For Pahang state, 8,226 people don waka go temporary evacuation center, up from 3,796 the day before. Johor get 347 people, Terengganu 913, while Kelantan don evacuate 16 people. Flood, landslide, storm, and cyclone don scatter South and Southeast Asia, with Indonesia report over 1,059 dead, Sri Lanka 640, and Malaysia 3 confirmed dead.

todayDecember 18, 2025 8

National

Africans No Be Pawn As NAF Men Free For Burkina Faso – Shehu Sani Talk

By: Rilwan Agbomeji Former Kaduna Central Senator, Shehu Sani, don hail di release of 11 Nigerian Air Force men from Burkina Faso. Di release happen afta Burkina Faso military junta led by Ibrahim Traoré free Naija aircraft and personnel. Sani yarn for X say Africans no suppose be pawn for neo-colonialists and imperialists. E also praise Foreign Affairs Minister Yusuf Tuggar diplomatic waka wey make di release happen.

todayDecember 18, 2025 9

National

Kano State Govo Yarn Say E Go Stop Delay For Public Workers Benefits Payment

By: Rilwan Agbomeji Kano State Govo, Abba Yusuf, don yarn say e no go allow public workers suffer delay for their benefits again. Di pledge come Wednesday as e dey pay severance, accommodation, and leave allowance to 1,371 former councillors wey serve between 2021 and 2024. Di payment ceremony hold for Coronation Hall, Government House, Kano, and na di last batch of payment. In total, government don release ₦8.26bn to make sure all beneficiaries collect wetin dem suppose get sharp-sharp. […]

todayDecember 18, 2025 5

National

NMDPRA, NUPRC Oga Dem Resign As Dangote Petition Shake Sector

By: Rilwan Agbomeji Nigeria petroleum sector don enter gbege as NMDPRA CEO, Farouk Ahmed, and NUPRC boss, Gbenga Komolafe, don resign Wednesday. Di resignations follow wahala wey Dangote Group President, Aliko Dangote, bring up over fuel import, pricing, and regulator wahala for downstream sector. Dangote don accuse Ahmed of economic sabotage and drag matter go ICPC, yarn say regulator spend about $5m for im pikin education for Switzerland. Di shakeup don cause fresh uncertainty for Nigeria petrol sector as stakeholders […]

todayDecember 18, 2025 5

Lagos

Fake Lasu Result Land Lagos College Provost For Jail

By: Rilwan Agbomeji Lagos High Court for Ikeja don knack Adonai Advanced Institute provost, Samson Orijugo, three years jail for faking LASU result. Justice Modupe Nico-Clay yan say Orijugo forge LASU letter make e look like im school get link with university, but na lie full ground. Di fake letter go one student, John Chibuzor Okoro, wey make am think say im dey attend LASU-affiliated school. Court yarn say Orijugo sabi wetin e dey do, na pure forgery gbege, no […]

todayDecember 18, 2025 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app