Blog masonry

Background

Sports

Edo Queens Lift NWFL Title After Dem Hold Bayelsa Queens

Edo Queens don win Nigeria Women Football League (NWFL) 2025/26 title after dem draw goalless with Bayelsa Queens for final Super Six match for Port Harcourt. Di result give dem enough point to carry di trophy as dem already dey on nine points before the game and just need one point to seal am. Na coach Moses Aduku team second league title in three years, showing say dem still strong for women football for Naija.

todayJune 15, 2026 13 15

OBODO NAIJA

Warri Ijaw, Urhobo Cry Out, Tell INEC To Carryout Court Order

Ijaw and Urhobo pipo for Warri Federal Constituency don drop micro soft word to INEC to execute di Supreme Court order wey concern ward delineation report. Na leaders from both tribe tuk dis one for joint press conference wey happen for Warri on Sunday. Di meeting come after Abuja stakeholders session wey President Bola Tinubu arrange with dem. Dem also yarn say any further delay fit scatter di small peace wey di intervention don just help secure.

todayJune 15, 2026 15

National

Late General Rabe Family Kwanta with Kastina State Gorment

Con see problem oh, as pikin of late Major General, Rabe Abubakar (rtd), Isyaka Rabe,  don reject claim wey Katsina State Gornment tuk say im papa die from diabetes and hypertension. Im talk dis one for interview with news pipo, say kastina state gorment report nor correct, as im papa no get history of diabetes. Isyaka add say some pipo dey even tuk say na snake bite or heart attack, but insist say only God know di real cause of […]

todayJune 15, 2026 16 2

National

Umahi Defend FG Roads, Tinubu Highways Go Boost Economy

Minister of Works, David Umahi, don defend Federal Government road project spending, say President Bola Tinubu four legacy highways na important economic corridors. Im talk dis one during Renewed Hope Media Tour for Ndi-Egbe Bridge site for Afikpo, Ebonyi State, wey link Ebonyi to Cross River State. Umahi still talk say dem dey build wetin fit be di longest flyover for Africa near Dangote Refinery axis of Lagos-Calabar Coastal Highway to reduce future traffic wahala.

todayJune 15, 2026 13

Lagos

Lagos Residents Cry Out Say Dirty Dey Smell

Plenti residents for Ikotun, Idimu, Ejigbo and Egbeda area of Lagos don cry out say dirty dey smell dem despite gornment effort to clear waste. Lagos Waste Management Authority bin say dem remove 418,500 tonnes of dirty for across di state for May, wey average 13,200 tonnes every day. According to aproko pipo wey go touchlight one Industrial chemist, Harrison Chinaka, say dirty for Alimosho area dey wey fit cause serious health and environmental wahala. Chinaka say, di dirty dey […]

todayJune 15, 2026 13

Lagos

Lagos Barbar Pursue Guiness World Record

Say like dis Guinness world record, dey monitor one 24-year-old hairstylist, Ikechukwu Damilola wey dem dey call “Transformation King,” wey wan break world record, say im don reach 90 hours out of 120-hour to break Guinness World Record hairdressing marathon for Lagos. Di attempt dey happen for Oto-Awori Local Council Development Area for Ijanikin and GWR officials dey monitor am. Chairmo of di LCDA, Mr. Kareem Abiodun, talk say di event dey show how important skill and youth development be. […]

todayJune 15, 2026 12

Sports

Japan Snatch Late Draw As Dem Hold Netherlands

Japan show strong fighting spirit for di FIFA 2026 world cup, coming back twice to force Netherlands play 2-2 draw for dia opening  match for Texas on Sunday. Netherlands captain Virgil van Dijk naim score first with fine header, but Keito Nakamura quickly equalise for Japan. Crysencio Summerville later put di Dutch ahead again with a beautiful goal after one hour of play. As Netherlands begin feel say dem don win, Daichi Kamada score late equaliser for the 88th minute […]

todayJune 15, 2026 10

obodo oyinbo

US, Iran Finally Gree Peace Deal

United States and Iran don agree on peace deal and immediate stop to all military operations after more than three months of war for Middle East. Pakistan Prime Minister Shehbaz Sharif announce di agreement on Sunday, say official signing ceremony go hapun for Switzerland on June 19. US Presido Donald Trump sef don konfam di deal and order make dem reopen Strait of Hormuz and remove di US naval blockade immediately. However, Iran never officially konfam di agreement, but Pakistan […]

todayJune 15, 2026 11 11

OBODO NAIJA

President Tinubu Hail Abdulsalami

Wi Presido, Bola Tinubu yesterday praise shege comot former military Head of State, Abdulsalami Abubakar, head, say im na oga na master for naija democratic. Tinubu tuk dis one for Abuja during public book presentation wey dem hold to honour Abdulsalami 84th birthday, and na  Vice Presido Kashim Shettima represent am fry mouth for di event. Shettima drop Tinubu message say Abdulsalami leadership naim bee di stew for naija democracy, dat naim dey make am sweet.

todayJune 15, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds