Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Police Promise Ogbogbo Collab With NYSC Corpers

By: Mariam Ajayi Lagos Police commissioner of  police Fatai Tijani don promise NYSC corpers say dem go protect corps members. Tijani give di assurance on Tuesday during a familiarisation visit by NYSC Lagos Coordinator Mrs Christiana Salmwang to di police headquarters for Ikeja. Di meeting focus on strengthening di relationship between both organisations and improving security arrangements for corps members wey dey serve for different parts of Lagos. Tijani say di police go work closely with NYSC to tackle security […]

todaySeptember 2, 2026 14 2

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Defend Economy Hardship Policy Again

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu don defend di economic reforms wey dey make life hard for Nigerians, say na necessary plan to push Nigeria economy reach $1 trillion by 2030. Tinubu, through APC National Chairman, Prof Nentawe Yilwatda, say although di medicine bitter now, government foreign reserve and revenue don dey improve. But former Vice Presido no gree, as e question why government wait for more dan three years before dem bring measures like cheaper transport and food support […]

todaySeptember 2, 2026 10

Lagos

Sanwo-Olu Ask Why Lagos Pensioners Dey Vex

By: Mariam Ajayi Oga Govo Babajide Sanwo-Olu don arrange meeting with Lagos pensioners on Thursday, as e wan hear why dem dey vex. Di pensioners don dey protest for Alausa, say government never pay dem dia entitlements for two years, after dem serve Lagos for 35 years. Dem say dem don tire to wait, as dem dey demand make government pay wetin dem don work for.

todaySeptember 2, 2026 15

Lagos

Lagos Police say di tear-gas picture of pensioners for alausa na AI

By: Ayobami Dada Lagos Police don deny report say dem fire tear gas on pensioners during dia protest for Alausa on Monday, August 31. Police say about 500 pensioners gather peacefully, while security operatives dey maintain order, dem no fire any tear gas. Di Command say after government officials address di protesters, NUP executives hold meeting before dem peacefully comot around 4:30pm. Police also yarn say di viral photo wey show say pensioners receive tear gas na AI-generated image, and […]

todaySeptember 1, 2026 17

OBODO NAIJA

Dino Melaye Blast Tinubu Over Five New Presidential Aeroplane

By: Mariam Ajayi ADC chieftain, Dino Melaye, don blast Presido Bola Tinubu gorment over di reported addition of five new aeroplane to Nija Presido Air Fleet for less than four years. Melaye make di statement for X, e describe di increase as ridiculous, say country wey e say still dey struggle with poverty. Di former Kogi West Senator also complain say Nigerian Air Force no even receive any new aircraft throughout 2025. Melaye say di reported five new aeroplane under […]

todaySeptember 1, 2026 15

obodo oyinbo

Putin Ask Xi Make Russia-China Visa-Free Travel Permanent

By: Mariam Ajayi Putin ask Xi Jinping make Russia-China visa-free travel permanent for Russia and China citizens. Putin and Xi meet during di 26th Shanghai Cooperation Organisation summit, where leaders from Russia, China, Iran, Pakistan and other member countries gather for di meeting. Xi say di organisation get important work to do by helping to keep peace and stability for di region. Xi also say di relationship between China and Russia go continue to grow stronger as both countries work […]

todaySeptember 1, 2026 11

Lagos

Falana Demand Police Arrest As Tear Gas Scatter Pentioners

By: Mariam Ajayi Human rights lawyer, Femi Falana, call for di arrest of police officers wey  use tear gas scatter pensioners wey protest for Alausa, Lagos. Di pensioners gather for Lagos State Gorment Secretariat and House of Assembly complex dey demand dia outstanding pension adjustments and wage awards before police scatter di protest. Di retirees say di Lagos State Gorment never pay dem pension increases, consequential adjustments and wage awards despite di long-running dispute. Di pensioners are expected to meet […]

todaySeptember 1, 2026 16

obodo oyinbo

Floods For China-Nepal Border Don Kill Over 1,000 People

By: Mariam Ajayi Nepal Disaster Authority on Tuesday tok say 987 people don die for Nepal as di flood hit di China-Nepal border, as e don kill 16 people for Tibet, China, bringing di total deaths to 1,003. Chinese state media earlierconfam say 16 people die for Tibet, China, after di wan wey happen on Wednesday, while rescue workers continue to search for survivors. For Nepal, di number of people wey still dey missing don drop to 3,916 as rescue […]

todaySeptember 1, 2026 15

Sports

Saka Fire Arsenal To Victory As Gunners Knack Aston Villa 1-0

By: Mariam Ajayi Arsenal don continue dia flawless run for Premier League as dem knack Aston Villa 1-0 for Villa Park on Monday night. Na Bukayo Saka score di single goal for second half to give di Gunners full three points and keep dia clean-sheet record intact. Dis win na di perfect way for Mikel Arteta to celebrate hin 250th Premier League match as Arsenal gaffer. Arteta maintain di exact same starting eleven wey dem use wallop Coventry 3-0 for […]

todaySeptember 1, 2026 17 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds