Blog masonry

Background

Lagos

Flood Take Over Abuja Roads, Traffic Jam Scatter Everywhere

By: Kofoworola Olayinka Heavy rain don cause serious flooding for parts of Abuja, as roads and streets dey under water. Airport Road and Lugbe na among areas wey suffer pass, with flooding also reported around Nile University Junction, Airport Junction and Wuye. Di flood don cause serious traffic wahala, as motorists dey slow down and some dey find alternative routes to avoid di affected roads. Residents don raise concern over di recurring flooding, blaming poor drainage maintenance and construction on […]

todaySeptember 2, 2026 18

Sports

Paredes: Messi No Dey, Argentina Go Struggle

By: Kofoworola Olayinka MessiĀ  last competitive match for Argentina na di 1-0 loss to Spain for World Cup final in July. Out of the 17 Argentina players wey play dat match, na only two go dey under 30 when 2030 World Cup start. Veteran defender Nicolas Otamendi don retire from international football, while goalkeeper Emiliano Martinez and midfielder Leandro Paredes fit follow. Paredes say if Messi no dey, e go hard for Argentina make things continue the way dem dey […]

todaySeptember 2, 2026 19

Sports

Asencio Enter Court Palava Over Drink-Driving

By: Kofoworola Olayinka Real Madrid defender Raul Asencio don face court palava for Gran Canaria after court convict am for drink-driving in August. Di 23-year-old defender reportedly pass di legal alcohol limit by more than three times, as court fine am €14,400 and suspend im driving licence for eight months. Asencio, wey come from Canary Islands, no dey with Real Madrid squad at di time because e dey recover from hamstring injury. Meanwider, e go face another court case this […]

todaySeptember 2, 2026 18

OBODO NAIJA

Wike Say Abuja Residents Life Better Under Tinubu

By: Kofoworola Olayinka FCT Minister Nyesom Wike say di quality of life for Abuja residents better under Presido Bola Tinubu gorment. Wike make di statement during media chat for Port Harcourt, as e respond to criticism over gorment performance, saying Nigerians no suppose judge better life only by house ownership. E say di rail system wey no dey work before don get attention from gorment, while different roads across Abuja don receive rehabilitation and construction. Wike add say quality of […]

todaySeptember 2, 2026 17

south west

Kwara Gov Mourn Family Members Weh Die For Ilorin Collapse

By: Mariam Ajayi Kwara State Gofnor AbdulRahman AbdulRazaq and other top officials don mourn four family members wey die after three storey building collapse for Ilorin. Di building collapse Tuesday for Popo Giwa area, trapping eight members of one family under di rubble. Rescue workers save four people alive, but four others no survive di incident. Gofnor AbdulRazaq say e dey saddened by di tragedy, as e visit di injured victims to check dia condition.

todaySeptember 2, 2026 15

Sports

Paredes Dey Wait For Scaloni Nod On Messi Tribute

By: Mariam Ajayi Paredes say e never discuss the matter with Argentina coach Lionel Scaloni yet, but dem go tuk am before dem decide wetin to do. Messi, 39, don announce say e dey retire from Argentina national team, after giving everything for im country. The legendary forward lead Argentina win 2022 World Cup for Qatar and comot as dia highest goalscorer and most-capped player, with 125 goals for 207 appearances. Paredes hail Messi legacy, say e go continue to […]

todaySeptember 2, 2026 14

OBODO NAIJA

KASU Unions Say Make Govt Pay Workers Dia Money

By: Mariam Ajayi KASU union leaders don tell Federal Gorment make dem put di 2026 agreement with non-teaching staff for public universities. Dem also call on Kaduna State Government to pay all outstanding allowances, promotion arrears, pension arrears and wage award wey dem owe university workers. Di unions make di demand after dem hold meeting for Kaduna State University union secretariat on Tuesday. Dem warn say government need to honour di agreements to maintain peace and prevent more disputes for […]

todaySeptember 2, 2026 15

Sports

FIFA Accept NFF Oga Dem Quit Notice

By: Mariam Ajayi FIFA don finally collobi letter from NFF big ogas for Switzerland, as dem promise to join bodi with Naija to reset wi local football. NFF image-maker, Dr Ademola Olajire konfamate di development Tuesday, as Sports Commission oga, Shehu Dikko lead delegation go FIFA House for Zurich link up with FIFA Presido Gianni Infantino. Dikko and im team, including Bukola Olopade, Dr Emmanuel Ikpeme and lawyer Okey Obi, don explain di challenges wey Nigerian football dey face and […]

todaySeptember 2, 2026 13

obodo oyinbo

Iran Fire Missiles Enter US Base As America do back to sender

By: Mariam Ajayi Iran military don show powerĀ  fire wicked bomb enter US army bases for Jordan. Iran Supreme Leader Mojtaba Khamenei don warn America say dem go hear am, as tension between both sides continue to dey rise. US forces too no waste time, as dem launch fresh bomb attack enter Iran. As Iran and America dey trade heavy blows, e don be like say ā€œyou touch me, I touch youā€ don turn serious war matter.

todaySeptember 2, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds