Blog masonry

Background

Lagos

LAWMA Beg Gornment To Arrange Long Term Plan For Lagos Waste Management

By: Esther Ayoola Di Managing Director/CEO of Lagos Waste Management Authority (LAWMA), Dr Muyiwa Gbadegesin, don konfam matas, say Lagos State never sti get proper Waste Management Master Plan. E yarn dis one when e receive European Union and ECOWAS delegation for Ijora Olopa, Lagos. E explain say LAWMA dey push make gornment develop di plan wey go guide long-term waste management, investment, and beta sustainability for di state. Gbadegesin use di opportunate wire call to investors to come help […]

todayMay 4, 2026 8

obodo oyinbo

US Fit No Accept New Iran Peace Proposal – Donald Trump

Donald Trump talk on Saturday say e go check new peace proposal wey come from Iran, but e still show doubt whether di deal go work, as e no close door for possible fresh attack on Iran. Peace talks between United States and Iran don jam for ground since ceasefire start on April 8. One round of peace talks wey happen for Pakistan to end di war wey don pass two months no succeed. Dis development come after Tasnim News […]

todayMay 3, 2026 13

Politics

Why We Comot From ADC – Kwankwaso Camp

Spokesman to Rabiu Musa Kwankwaso, Habib Saleh Muhammad, don konfamate say di former Kano State govo and im political camp don decide to comot from African Democratic Congress (ADC), as internal wahala and time no dey before 2027 elections. For exclusive interview with media pipo, Muhammad talk say dem take di decision after plenty consultation with stakeholders across local governments. E further explain say di move come because of wetin e describe as political and legal wahala wey don dey […]

todayMay 3, 2026 12

Sports

Sir Alex Ferguson Land For Hospital Before Man Utd vs Liverpool

Manchester United legend manager, Sir Alex Ferguson, don land hospital after health matter catch am for Old Trafford. Di incident happen just before Sunday Premier League showdown between Red Devils and Liverpool. According to BBC, no be life-and-death emergency, na to play safe dem rush am go hospital. Even with that one, Sir Alex still comot di stadium inside ambulance. People for United camp dey confident say di Ferguson go bounce back quick and return house soon. As di drama […]

todayMay 3, 2026 16

Politics

ADC Fix Dates For Primaries

African Democratic Congress don drop full timetable for im 2026 primary election, as party members wey wan contest now don know when battle go start. For statement wey Bolaji Abdullahi release on Sunday, di party talk say sale of nomination forms go run from May 5 to May 10, 2026. Aspirants go submit their forms from May 11 to May 13, while screening go begin from May 14 to May 15. ADC also talk say anybody wey scale through screening […]

todayMay 3, 2026 10

Politics

Breaking: Peter Obi Dump ADC

Former Labour Party presidential candidate Peter Obi don comot from African Democratic Congress because of serious gbege inside di party and for di country. Di former Anambra State govo post dis statement wey im X on Sunday. E describe Nigeria politics as something wey don turn toxic, full of intimidation, insecurity, and discouragement. Obi explain dat, di decision im think am wella before resigning, hoping dat e go find beta platform for di 2027 general elections.

todayMay 3, 2026 11

obodo oyinbo

US Plan To Comot About 5,000 Troops From Germany

US Defense Secretary, Pete Hegseth,  don order make about 5,000 American soldiers comot from Germany within di next one year, according to Di Pentagon on Friday. Dis move dey come as fresh wahala dey show for relationship between United States and Europe over di Middle East war. At di same time, Donald Trump announce say tariff on cars and trucks from di European Union go rise to 25 percent from next week, accusing di bloc say dem no keep to […]

todayMay 2, 2026 10

Lagos

Ojeleye Collect APC Expression of Interest Form

Journalist, Adewale Lateef Ojeleye, don officially declare say e wan contest for 2027 general election after e collect All Progressives Congress Expression of Interest and Nomination Form for Ifako-Ijaiye Constituency 01 seat for Lagos State House of Assembly. Ojeleye collect di form today for APC secretariat, wey mark di official start of im political ambition to represent people of Ifako-Ijaiye Constituency 01. After e collect di form, Ojeleye talk say e ready to give purposeful representation, push grassroots development, and […]

todayMay 2, 2026 16

OBODO NAIJA

Benue Head of Service, Agbogbo Ode Kpai

Benue State Government don konfamate say their Head of Service, Agbogbo Ode, don kpai on Saturday, after short sickness. According to statement wey Secretatry to di State Government Serumun Deborah sign on Saturday, dem describe Ode as strong technocrat and public service veteran wey give plenty years of solid service to di state. Government talk say im death shake di system well-well, as many people know am for straight character, serious dedication, and di impact wey e leave for Benue […]

todayMay 2, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds