Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

President Tinubu Hail Muslims

Wi oga Presido, Bola Tinubu don felicitate Muslims for Nigeria and di obodo world as dem mark Islamic New Year, 1st Muharram 1448AH. Baba Seyi put dis one  for statement wey im send through im  Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, on Tuesday, E urge Nigerians make dem show patriotism and be beta citizens as di new Hijri year begin.      

todayJune 16, 2026 12

Local

Kogi Confirm Say Dem Don Kill Bandit Wey Attack School

Kogi State Gofment don confirm say security operatives do Rambo doings kpai one notorious bandit leader, Kachala Ibrahim Batijo, wey dem say na im plan recent attack for one school for Iluke Bunu, Kabba/Bunu LGA. State Commissioner for Information and Communications, Kingsley Fanwo, tok dis one on Tuesday for Tv sit down tuk, say Batijo die during joint security operation alongside oda bandits. According to am, na di same bandit leader organise di school attack wey kill three people, including […]

todayJune 16, 2026 10

Local

How Air Force Officers Allegedly Beat Driver Die

Nor be small tin, problem dem  say nor dey finish, One 43-year-old  driver, Joseph Okpe, naim go collect beating from Nigerian Air Force officers. According to court affidavit wey im broda Innocent Okpe file for High Court, di officers accuse am say e hit dia Coaster bus and demand N100,000 compensation. Di affidavit talk say when Joseph no fit bring di money, di officers begin mama di man, dem punch im face and head repeatedly until e nearly lose consciousness. […]

todayJune 16, 2026 11

Lagos

Lagos Govt Talk Say Dem Go Close Iddo Bridge For Repairs

By : Jolayemi Olajide Lagos State gornment don announce say dem go lock Iddo Bridge for Ijora area sake of repair work wey dem dey do. Di Commissioner for Transportation, Mr. Oluwaseun Osiyemi, yarn dis one for inside one statement on Tuesday. Di government talk say Federal Ministry of Works go use di time fix heavy steel beams make di bridge come strong well-well, so dem need to close di place make accident no happen. Di road go close for […]

todayJune 16, 2026 8

south west

Governor Adeleke ask Police to Commot Security for APC Local Gofnor Chairmen

  By : Jolayemi Olajide Osun State Governor, Ademola Adeleke, don tell the Inspector General of Police make e order im men to commot security personnel from di local gofnment chairmen wey belong to APC. Baba govo, Adeleke sorosoke dis one for Osogbo, as im ma dey touch light di Federal High Court judgement wey throway im party Accord Party and five others through window. After di judgement, na so heat full everywia, according to Adeleke, those chairmen no get […]

todayJune 16, 2026 8

Entertainment

Reno Omokri Reply Davido As Dia Two Clash Sake of World Cup concert

By : Jolayemi Olajide Ambassador- to Mexico, Reno Omokri, don fire back at Afrobeats star, Davido, afta di singer rain insult on am sake of comments wey Reno make about im performance for one World Cup concert. The whole wahala start as Davido perform for di FIFA World Cup countdown concert for Los Angeles. For the show, e wear one jacket wey write the names of over 40 schoolchildren and teachers wey kidnappers carry for Oyo State, plus the message […]

todayJune 16, 2026 9

Politics

Court order police to arrest Omoyele Sowore

By  : Jolayemi Olajide Federal High Court for Abuja don order say dem must arrest AAC presidential candidate, Omoyele Sowore, sake of say im nor show face for im trial. Dem suppose start the case wia DSS charge Sowore for cybercrime, dem say e call Presido, Bola Tinubu, "criminal" for social media. Sowore bin don tell court say na im go defend imself since im lawyers don comot body for di mata. But as proceedings start on Tuesday, e no […]

todayJune 16, 2026 10

OBODO NAIJA

IGP Calm Federal Police Officers, Say State Police No Go Take Food from dia table

By : Jolayemi  Olajide Inspector-General of Police, Olatunji Rilwan Disu, don assure officers and men of Nigeria Police Force say plan to create state police no go scata or replace federal police. Im yarn dis one During im working visit to Jigawa State Police Command, According to Disu, federal police go still dey carry out dia constitutional duty of maintaining law and order across the country.

todayJune 16, 2026 11

Politics

Obidient Movement drag court on why dem wan comot 5 parties from 2027 election

By : Jolayemi Olajide Di Obidient Movement don come out strong to condem say dem wetin di Federal High Court order INEC to delete five political parties, nor make brain at all. U sabi, Justice Peter Lifu give di order on Monday, say di parties, ADC, Accord, APP, AA, and Zenith Labour nor go run for di 2027 election dat dem nor follow constitution. Na one group of former lawmakers file the case, say dem want make INEC remove any […]

todayJune 16, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds