Blog masonry

Background

National

Senate Clear Fani-Kayode, Omokri, Ikpeazu, Ex-INEC Chair, Others For Ambassadorial Posts

By: Rilwan Agbomeji Di Senate Committee on Foreign Affairs turn to small theatre as dem screen Fani-Kayode, Dambazau, ex-INEC oga Yakubu Mahmood, Florence Ajimobi, Reno Omokri and di rest for ambassadorial positions. As senior men waka enter di meeting, all di ambassador wey dem wan screen take di bow but Omokri batch reach na so everywhere catch fire between Senator Mohammed Ali Ndume and Senator Adams Oshiomhole.

todayDecember 12, 2025 10

National

FG Recuit 94,000 New Security Officers To Rascal Jaguda Boys

By: Esther Ayoola Nor be small gbege say, boys dey hide for area as wi Federal Gorment 94,000 bring plan to recruit new security to battle insecurity. For inside statement on Thursday by di Head of Protocol and Public Affairs, Torty Kalu, dey confamate dis tory. Police Service Commission and Nigeria Police Force no even help mata at all, as dem declare say na about 50,000 new constables dem want to enter uniform by fire by force to boost manpower. […]

todayDecember 12, 2025 6

Lagos

FCCPC Seal Ikeja Electric Hq Over Consumer Palava

By: Esther Ayoola See Gobe, for Ikeja Electric as Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) seal dia Headquarters on Thursday say dem deprive a consumer im right. Head of tuk tuk, Kingsley Okotie, yarn tori pipo say, im company nor dey hide and dat dem dey cooperate with regulators to settle di matter. Dem dey run ground with all stakeholders make sure say every directive from FCCPC dem follow am sharp-sharp. Ikeja Electric yarn say dem dey play clean, […]

todayDecember 12, 2025 9

obodo oyinbo

Britain Economy Fall Again, Labour Dey Press For Growth

By: Esther Ayoola Britain economy don shock again as official data show say e shrink 0.1% for October afta e already fall 0.1% for September. Di office for national statistics release di numbers on Friday, and e dey dash blow to labour government wey dey hope revive economic growth. Analysts bin dey expect say economy go grow 0.1%, but di reality na contraction continue. Di only bright side be say manufacturing bounce small as jaguar land rover resume work after […]

todayDecember 12, 2025 7

National

Rivers Lawmakers Accuse Governor Fubara Say Im Cause Anoda Political War

By: Esther Ayoola Rivers State Govo, Siminalayi Fubara, don chop anoda accuse say e dey sidelined lawmakers, and dat dis one sef go fit spark anoda wahala for state. U sabi say on Wednesday, Fubara talk, say him oga, Nyesom Wike, never still, set meeting between im di govo an di Wike-aligned lawmakers. On Thursday for Port Harcourt, speaker Amaewhule wey dey with 10 lawmakers don respond to di governor tori tori session say make di governor take responsibility.  

todayDecember 12, 2025 7

Lagos

How Argument Over Parking For Lekki End For Tragic Death

By: Esther Ayoola One mortor drive don Kpai Lagos real estate agent, Yinka Agboola, 36 years of age, for Lekki because of motor parking wahala for Royal Pine Estate. Di whole mata start Monday evening when one unknown driver park him motor block road. According to report wey newsmen gather from x on Thursday,  people offer am another space, but di man vex begin dey threaten say, "you know who i be? I go kill you now." Di argument later […]

todayDecember 12, 2025 8

National

Owo Church Attack: Suspects Begin Defend Demselves For Abuja

By: Esther Ayoola Trial for five people wey bi suspect  for di June 5, 2022 terror attack wey sup for St. Francis Catholic Church, Owo, Ondo State, don start again on, on Thursday for Federal High Court, Abuja. One Catholic priest, wey court call “SSA” for security reason, testify from behind screen, talk how di attackers waka enter church, kill over 40 worshippers and injure more than 100 people. Di suspects na Idris Omeiza, Al Qasim Idris, Jamiu Abdulmalik, Abdulhaleem […]

todayDecember 12, 2025 7

National

First Lady Say, Tinubu Dey Handle Naija Security Palava Wella

By: Esther Ayoola Di First Lady, Senator Oluremi Tinubu,  talk sey wi oga Presido, Bola Tinubu dey work tireless make everywhere for Naija dey safe. She yarn dis one on Thursday after di 2025 Children Christmas Brunch, wey shelle  for State House Banquet Hall, Abuja. Senator Oluremi still talk sey di gorment dey act quick and correct, say dem dey handle security wahala wella, citing,  di recent rescue of school pikins wey jaguda boys bin kidnap.

todayDecember 12, 2025 13

National

Bayelsa Deputy Gov Ewhrudjakpo Die After Him Collapse For Office

By: Esther Ayoola Bayelsa State don enter mourning  say Deputy Governor, Senator Lawrence Ewhrudjakpo, collapse for im office and later die for hospital on Thursday. Dem rush am go Federal Medical Centre, Yenagoa, but doctors confirm say im no survive. In reaction, Southern Governors’ Forum chairman, Governor Dapo Abiodun, say di news shock am and describe Ewhrudjakpo’s death as painful.

todayDecember 12, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app