Blog masonry

Background

Sports

Portugal Beat Super Eagles

Nigeria super eagles fall hand and leg go  lose 2-1 to Portugal for international friendly match. Pedro Neto open naim open di scoring for Portugal before Akor Adams equalise for Super Eagles to make am 1-1. Later, substitute Francisco Conceição bend one fine shot enter net to restore Portugal lead and seal di win. Di result mean Portugal go enter di World Cup with back-to-back victories.

todayJune 11, 2026 11

obodo oyinbo

US, Iran Exchange Blow

US Presido Donald Trump, don cut chain say United States go hit Iran “hard” again after both sides exchange strikes overnight. Di white house presido put dis one for X, say dis action na based on say Iran go shoot down US Army helicopter. Iran President Masoud Pezeshkian respond for X say Iran go stand firm against any pressure or threat from America, showing say dem no go back down. US Central Command later announce for social media say dem […]

todayJune 11, 2026 10

OBODO NAIJA

Bad Boys Storm Kogi, Kpai School VP, Kidnap Students

Armed bad boys don storm Iluke community for Kogi on Wednesday morning, kpai three people join school VP. Di gunmen operate for hours, dey shoot scatter-scatter to tension di whole town. Dem come pack students wey wan write WASSCE English paper run enter bush. Residents don enter heavy mourning, dey beg government for sharp-sharp security help to rescue di kids.

todayJune 11, 2026 8

OBODO NAIJA

Senate Vex Order Kyari Arrest

For Abuja, Senate Committee on Public don order security agencies make dem arrest former NNPCL Group Chief Executive Officer, Mele Kyari, after e fail appear before di committee hearing. Committee Chairmo, Senator Ibrahim Dankwambo naim lead di session wey dey touch light di allegation about ₦210 trillion wey miss road between 2017 and 2023. Some lawmakers say, make dem give Kyari anoda chance because reports say e dey Germany for medical treatment. Di committee later approve arrest warrant after Senator […]

todayJune 11, 2026 10

Lagos

IKOSI-KETU Pipo Cry Out Over Cost of Living

Normally na di duty of every gorment of a country to balance tins, for citizen to survive, however e be like water don pass garri for obodo Nigeria. Complain here and there, unto di rising cost of living, konfam news tatafo, Esther Ayoola enter di street of Lagos, to tell us, how Lagos dey cope with di new cost of living.

todayJune 11, 2026 9

Lagos

Lagos Gorment, Agencies Join Hand Take Improve Waste Collection

Di Lagos State Gornment don receive 10 new waste trucks to boost waste collection and improve environmental sanitation across di state. Di trucks come as donation from Lagos State Lottery and Gaming Authority to support beta waste management system and reduce environmental challenges for Lagos. Untop yarnings for di handover ceremony, Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, say di donation na beta collabo between gornment agencies. E add say di partnership go help Lagos handle waste betta as […]

todayJune 11, 2026 10

Sports

Omar Artan Return Mogadishu For Hero Welcome

Somali referee, Omar Artan, wey United States deny entry for World Cup duty, don come back Mogadishu for hero welcome on Wednesday as supporters gader for airport wave flag greet am. Artan tuk say e no go give up, promise say e go still participate for 2030 World Cup despite di rejection. di referee land for Mogadishu main airport through Turkish Airlines flight, where more dan 100 fans celebrate am for VIP section.

todayJune 10, 2026 13

foreign

Gunmen Kpai 12 For South Africa

Nor be small jogolo for South Africa, say 12 pipo don kpai after gunmen attack one small community, midnight on Tuesday. Police say about 10 attackers naim run dis package, enter different sides and begin shoot residents ratata for different locations. Police tuk tuk woman, Colonel Dimakatso Nevhuhulwi, say di suspects escape, while investigators begin touch light wetin really play for di area

todayJune 10, 2026 10

OBODO NAIJA

Obi Lawyers Drag Kenneth Okonkwo, Demand N5bn

Nor be small thin oh, as two best frens don turn enemies, say like dis, di Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, NDC, Peter Obi, don tell im lawyers say make dem drag former actor- wey turn-politician Kenneth Okonkwo to pay N5 billion damage dat im spoil im name for public According to tatafo, Kenneth go tv sit down tuk use yamchop call di former Anambra state govo bad name, dat im nor be beta leader, and dat im dey […]

todayJune 10, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds