Blog masonry

Background

National

IGP Disu Promote 374 Kwara Police Officers

By: Shalom Ovie IGP Olatunji Disu promote 374 police officers for Kwara State Command say make dem go rake out jaguda boys. Police tuk, tuk, Adetoun Ejire-Adeyemi, naim announce di promotion for Friday as part of nationwide exercise. According to am, 365 constables, two corporals, five sergeants and two superintendents benefit from di promotion. Police say di exercise na to reward officers wey dey work hard and serve well.  

todayJune 12, 2026 13

OBODO NAIJA

President Tinubu Say No Mercy For Jaguda Boys

By: Shalom Ovie Wi oga Presido, Bola Tinubu don drop micro soft word for democracy day, say make dis terrorists, bandits and kidnappers, nor too worry bodi, dat di gorement and security dey come for dem with full force. Im knack dis one for im Democracy Day speech wey e deliver on Friday to mark Nigeria 27th uninterrupted democracy anniversary. Baba seyi burst mehn bolobolo when im say, torrist killings don drop by 81 percent since 2015 because of government […]

todayJune 12, 2026 9

National

Tinubu Change Kaduna School name to Shehu Musa Yar’Adua

By : Shalom Ovie Wi oga Presido, Bola Tinubu don rename di Institute of Petroleum Studies for Kaduna to General Shehu Musa Yar’Adua University of Geological Sciences and Engineering Technology. E make di announcement on Friday during im Democracy Day speech for Nigeria. Tinubu tuk say di move na to honour di late Shehu Musa Yar’Adua for im contribution to Nigeria democracy journey.    

todayJune 12, 2026 10

Sports

South Africa Finish With 9 Men 

Mexico don show workings, start dia 2026 World Cup journey with 2–kondo win over South Africa for opening match wey hapun for Estadio Azteca. Na so south Africa players eavy for ground, nor fit carry body for di game, na so Mexico take advantage, three red cards come out, make South Africa finish with nine players for field. Julian Quinones naim score di first goal for di tournament while Raul Jimenez add another one to seal di victory for di […]

todayJune 12, 2026 7

obodo oyinbo

Oil Price Crash, Iran Peace Deal

Oil price don drop on Thursday afta US Presido, Donald Trump soft in bicycle pedal from im earlier threat to launch more attacks on Iran, and tuk say dem don ready for peace agreement. Earlier for di day, tension bin rise like 40 years olg BP, as America and Iran exchange attacks for di second day, scata tins for di middle east. Later di day, e be like  Trump tuk to im self, change tone, so Brent crude oil price […]

todayJune 12, 2026 11

OBODO NAIJA

Abike Dabiri-Erewa Complain About South Africa Attack

NiDCOM boss, Abike Dabiri-Erewa don condemn new xenophobic attacks wey dey hapun for South Africa, talk say “enough is enough” for di matter. She tuk dis on e for tv sit don tuk, say Nigeria go wait for higher authorities like Foreign Affairs Ministry and President before dem take strong decision on bilateral relationship. Dis one come afta gornment evacuate 258 Nigerians wey dey face violence and harassment, come back Lagos for safety.

todayJune 12, 2026 11

OBODO NAIJA

President Tinubu Open Kuje Road

Wi oga Presido, Bola Tinubu don commission Federal Highway 105 wey connect Airport Expressway to Kuje for Abuja. Di seniorman presido run dis parrol through Vice Presido Kashim Shettima, saying di road na proof say dis gornment, na tuk na do gorment. Im come assure Nigerians say di administration go continue to complete ongoing infrastructure projects for di benefit of all.

todayJune 12, 2026 9

Lagos

Lagos Clean Up With International Mehn

Clean lagos, clean lagos, u dey feel say na play play, yesterday, lagos environmental pipo cary some senior mehn, show dem shegge, tell dem to clean. Dis na mehn wey dey in charge of international exchange, an dem  carry di senior exchange pipo go clean lagos Marina, to mark World Environment Day 2026. Di programme hapun in collabo with Lagos State Waste Management Authority and Recyclers Association of Nigeria to promote beta waste management and clean environment. Head of Group […]

todayJune 12, 2026 8

Sports

Mboko Knee Injury End Serena Queen’s Club Comeback Run

By: Shalom Ovie Serena Williams comeback for Queen’s Club doubles don jam rock oh, as her partner Victoria Mboko don withdraw from di tournament. Williams and Mboko bin win dia first-round match on Tuesday, as Serena return to tennis after four years break.Dem suppose face Leylah Fernandez and Laura Siegemund for quarter-final on Thursday Mboko pull out after she injure her left knee during her singles match against Karolina Pliskova on Wednesday and no recover in time.

todayJune 11, 2026 13 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds