Blog masonry

Background

Politics

Seriake Dickson Beg NDC Aspirants Wey Dey Vex Over Primary Election Gbege

By : Jolayemi Olajide Di National Leader of Nigeria Democratic Congress, Senator Seriake Dickson, don beg all the aspirants wey dey vex because of the scatter-scatter wey hapun for their recent primary elections. Dickson yarn dis one for TV down, say he know say di arrangement no too hold water, but make dem chillax, say na for di greater good of all. E explain to di once wey dey vex say make dem try understand, because NDC na new party […]

todayJune 11, 2026 8

Sport Yarns

Roberto Martinez Hail Eric Chelle, Say Him Workings Dey Show 

By : Shalom Ovie Portugal coachie,  Roberto Martinez, don talk say e dey impressed with Super Eagles coachie, Eric Chelle, as e dey build im own football style for Nigeria side. Martinez talk dis one for him pre-match interview before di match, say Nigeria na strong side and Chelle don give dem clear football identity wey dey show. Even though some key players no dey, Martinez still talk say Nigeria no be small team at all and dem fit give […]

todayJune 11, 2026 8

obodo oyinbo

Ukraine Accuse Russia say Dem Use Girls Target Dem

  By : Shalom Ovie Ukraine police boss don accuse Russia say dem dey recruit teenage Ukrainian girls to carry out attacks against Ukrainian soldiers, after dem arrest one 17-year-old girl wey link to poisoning and killing of one soldier. For interview wey Ukrainian news outlet Cenzor.NET publish, Ivan Vyhivskyi talk say Russian agents don arrange 6 contract killings this year through Telegram, and Ukrainian authorities only manage block 1 of di plans. He add say dem dey use messaging […]

todayJune 11, 2026 10

south west

Stage Collapse For Inside Osun State as Adeleke Dey Do Rally

By : Jolayemi Olajide For Inside Osun State, fear gbab everybody on Wednesday, as di stage wey Osun State Govo, Ademola Adeleke and other big men dem dey use for rally burst enter ground for Ijebu Jesa. Dis particular gbege dey for inside 30 seconds video wey tori pipo collobi during di rally. Inside di video, musicians still dey perform for stage when di MC wan announce di next thing for programme before we know wetin happen, di stage just […]

todayJune 11, 2026 6

International

Di first batch of Nigerians from South Africa don land on Thursday

By: Shalom Ovie Di first batch of Nigerians wey leave South Africa because of anti-foreigner attacks dey expected to arrive Lagos on Thursday. Officials say di return follow weeks of violence against immigrants for the country. Armed groups don threaten make pipo wey no get residency papers leave before June 30. Di attacks don cause fresh fear among foreigners for South Africa.  

todayJune 11, 2026 10

Politics

Bashir Ahmad throw jibe on Obi And Kwankwaso say dem Go still commot NDC

By : Jolayemi Olajide Bashir Ahmad don throw jibe for Peter Obi and Kwankwaso, make dem chest am, say if thins nor go as plan, dat dem go sti comot Nigeria Democratic Congress after di 2027 election Im post for X say the duo just dey look NDC as commercial vehicle to take enter power. According to am, party leader Seriake Dickson dey play long-term for 2031, why Obi dem dey think different thing. Dat if NDC nor give dem […]

todayJune 11, 2026 9

Lagos

APC Aspirants clear Obasa name say Nor be im Sponsor Lagos Protest

By: Shalom Ovie Some All Progessives Congress aspirants for Lagos don explain how Speaker Mudashiru Obasa hand nor dey inside di protest over di party primaries. According to di protesters, say na based on say many election ground nor package di wey e suppose be naim make, di election scatta Di group also reject claim say Obasa give N2 billion to support di demonstration. Dem insist say angry party members come out on their own to demand fair treatment.  

todayJune 11, 2026 14

Entertainment

Davido Carry Oyo Kidnap mata to FIFA Stage

By : Jolayemi Olajide Afrobeats superstar Davido don carry Naija security mata enter global level, as im use di FIFA World Cup countdown concert to tell Nigeria gorment to go an rescue the students and teachers wey bandits pack for Oriire LGA, Oyo State. OBO rock one bad black leather jacket wey full with green buttons, and every single button carry the name of the victims to show di world say pipo dey cry for Nigeria. To code di tragic […]

todayJune 11, 2026 10

Politics

EFCC Oga explain how Politicians take dey Chop Gorment money

By : Shalom Ovie EFCC Chairmo, Ola Olukoyede, don open secrete tuk why public money dey lost, say na based on di fact politicians dey spend too much for election. Naim make once dem enter office, dem go begin gather money wey dem spend for election and con take extra. E tuk dis one on Wednesday for one lecture for University of Ilorin about peaceful and credible 2027 elections. However Olukoyede come say EFCC go continue to fight vote-buying and […]

todayJune 11, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds