Blog masonry

Background

National

Remi Tinubu Launch Food Bank For N’East

By: Esther Ayoola Wi first lady, Oluremi Tinubu don launch National Community Food Bank Programme for Borno State Naija, say di project go hellep fight hunger and malnutrition for di region and Naija at large. She tuk dis one during unveiling of di programme on Monday, explain say na her first assignment for Borno, especially to support children and mothers wey need hellep. Earlier on April 3 for Abuja, Ali Pate bin announce say di programme don receive over N66 […]

todayApril 27, 2026 10

Sports

JUST IN: Anthony Joshua Pick Date for First Fight After Car Askident

By: Esther Ayoola Anthony Joshua don finally decide say im wan return to boxing ring on July 25 for warm-up fight ahead of im long-awaited clash with Tyson Fury. Saudi boxing chief, Turki Alalshikh, naim dey announce dis ogbonge update, say Joshua go fight Albanian heavyweight Kristian Prenga for Riyadh, Saudi Arabia, as part of Esports World Cup event. Di fight na Joshua first appearance since im knockout win over Jake Paul for December, before him later get minor injury […]

todayApril 27, 2026 13

Lagos

BREAKING: Sanwo-Olu Back Hamzat for Lagos Governorship Race

By: Esther Ayoola Lagos state govo, Babajide Sanwo-Olu like dis don join endorse im deputy, Kadri Hamzat, as All Progressives Congress candidate for 2027 governorship election for Lagos. Sanwo-Olu make di announcement for Lagos House, Marina, in presence of state executive council members, APC leaders, and all 57 local government and LCDA chairmen. Di governor say Hamzat get enough experience and deep knowledge to lead di state, na why e support am to contest for di top seat. E add […]

todayApril 27, 2026 11

Lagos

LASTMA Give Report Say Na 69 Kpai, 246 Wunjure For Lagos Road Crash Q1 2026

By: Esther Ayoola Lagos State Traffic Management Authority tuk say na about 69 pipo don kpai like dis for road askident across Lagos between January and March 2026, while 246 others get wunjuries. LASTMA General Manager, Olalekan Bakare-Oki naim yarn dis one for interview with News tatafo on Sunday. Say drivers just dey drive wawa and naim dey cause all these askidents. E sti tuk say dem clear over 600 accident scenes and handle more than 900 truck-related offences, plus […]

todayApril 27, 2026 10

National

FG To Ban Unrated Textbooks For Schools From September 2026

By: Esther Ayoola Federal Government of Naija don announce say dem go introduce National Textbook Ranking System for primary, junior and senior secondary schools to improve education standard for Naija. Director of Press for Ministry of Education, Folasade Boriowo, naim dey tuk dis one for statement on Sunday, say, di plan na to stop bad textbooks from entering classrooms. She explain say Nigerian Educational Research and Development Council go dey in charge of approving textbooks, while dem go rank all […]

todayApril 27, 2026 12

National

Kano Gorment Advice Dia Youths Over Shameful Behaviour Before First Lady

By: Esther Ayoola Kano State Govo, Abba Yusuf don condemn di action of some youths wey reportedly show dirty character of giving underwear to women, during an official visit of Oluremi Tinubu for Kano State Naija. For statement wey Govo Chief Press Secretary, Mustapha Muhammad release on Sunday, Yusuf tuk say di behaviour nor represent Kano culture at all. E yarn dis one during Third Special Prayer for lasting peace for Gornment House, where 4,444 Qur’anic reciters gada pray for […]

todayApril 27, 2026 15

Lagos

How Lagos Gorment Enter 60MW Power Deal With 3 Electricity Company

By: Esther Ayoola Lagos State gorment, don do small megege movement sign Power Purchase Agreements with three companies, Fenchurch Power, Mainland Power and Viathan Group to generate about 60MW electricity for di state. Senior man govo, Babajide Sanwo-Olu naim lead di way, put dis one for statement on Sunday, say di agreement as part actions to improve power supply under Lagos Electricity Law 2024 and Nigerian Electricity Act. Di signing hapun for Lagos House, Marina, where state representative Abiodun Ogunleye […]

todayApril 27, 2026 9

obodo oyinbo

Suspected Shooter For Trump Dinner Arrange Bodi For Court Today

By: Esther Ayoola Di ogbonge senior gunman wey dem accuse say go scatta U.S Presido Donald Trump gala dinner for Washington D.C. USA on Saturday night, say like dis now go make first appearance for court today. According to U.S officials, say di suspect allegedly bin wan kpai Trump and other top officials during di press dinner before. Trump himself post video and pictures of how security agents rush am comot from ballroom, while surveillance video show gunman wey dey […]

todayApril 27, 2026 9

National

Army Explain How NYSC Member Take Kpai Robbery Operation for Abuja

By: Esther Ayoola Nigerian Army, through im Acting Assistant Director, Army Public Relations for Guards Brigade, Lt. Olawuyi Odunola, don konfamate say NYSC member Abdulsamad Jamiu sadly kpai during security operation against armed robbery for Abuja. Di incident hapun for early hours of April 25, 2026 for Shagari Estate, Dei-Dei inside Federal Capital Territory. According to wetin Army tuk, Guards Brigade Quick Response Group wey dey do routine night patrol hear distress call say armed robbers dey operate for di […]

todayApril 27, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds