Blog masonry

Background

south west

Osun Police gbab 3 Suspected Cultists, jaguda boys, Recover Pistols

By : Shalom Ovie Osun State Police Command say dem don arrest three suspected cultists and political thugs during separate operations for di state. For statement wey Police Public Relations Officer, DSP Abiodun Ojelabi release on behalf of CP Ibrahim Gotan, dem identify di suspects as Adekola Olayinka Abdulazeez, Omolara Ezekiel and Babatunde Azeez. Police say dem recover dangerous weapons from dem including three English Beretta pistols, cut-to-size gun, live ammunition, cartridges, cutlasses and axes. di command add say investigation […]

todayJune 10, 2026 9

OBODO NAIJA

Kenneth Okonkwo Blow Whistle On Top Peter Obi Head

Popular Nollywoord Actor, Kenneth Okonkwo don come out clear marras say, he get duty to report any crime against di state wey come to him knowledge and that South-East pipo don too suffer. He yarn dis one for him X social media page on Wednesday say, no person suppose still dey take dem or any Nigerian citizen play or carry out wayo wayo without challenge. He say, Obunike na just one among many others wey dem allegedly scam through NDC […]

todayJune 10, 2026 16 2

Economics

IMF Raise Alarm Say Nigeria External Debt Fit Reach $72.6bn Before 2027 Election

International Monetary Fund (IMF) don warn say Nigeria public external debt fit jump by over $20 billion reach $72.6 billion by 2027. Dem talk say election year spending pressure fit make borrowing even worse. For dia 2026 Article IV report wey dem release on Tuesday, IMF show say Nigeria external debt go rise from $51.9bn for 2025, go $66.5bn for 2026, before e finally reach $72.6bn for 2027, that one na almost 40% increase inside two years. IMF talk say […]

todayJune 10, 2026 22

Sports

Atletico Madrid Reject Real Madrid €150m Bid For Julián Álvarez Deal

By: Esther Ayoola Real Madrid don reportedly offer €150 million to sign Argentine striker Julián Álvarez from city rivals Atlético Madrid. Dis na according to statement wey appear for dia website. Di club say di proposal come afta board meeting wey dem hold as dem dey look for top striker to strengthen dia attack. But Atlético Madrid quickly reject di offer, say Álvarez dey very important for dia project and dem no go sell am anyhow.

todayJune 10, 2026 7

Sports

Ebola Scare Shake Dr Congo World Cup Prep

By: Esther Ayoola Democratic Republic of Congo dey fall hand oh, losing 2–1 to Chile for friendly match wey dem play for France on Tuesday, put am for Ebola head Di match suppose hapun for southern Spain, but di mayornor gree based on Ebola concern, naim make dem con move go France, and now dem con lose World Health Organization don declare international health emergency over di Ebola outbreak wey start for northeastern DR Congo on May 15, and e […]

todayJune 10, 2026 9

National

Abure Point Finger To Obi, Otti Say Na Dem Scata Labour Party

By: Esther Ayoola Former Labour Party Chairman Julius Abure don accuse Peter Obi and Abia State Governor Alex Otti of causing di leadership crisis wey dey shake di party. Abure, wey tuk for TV sit down tuk on Tuesday, say Labour Party dey peaceful until Obi and Otti carry dia problem come, create caretaker committee for Umuahia. According to am, na dat decision scata di party stability and start di fight, fight for di fight today.

todayJune 10, 2026 11

National

SGF Akume Cast Atiku Say Im Join Leaders Weh Push Rotational Presidency

By: Esther Ayoola Secretary to Gornment of Federation (SGF), George Akume, don go cast wi former Vice Presido, Atiku Abubakar, say im na one of di leaders wey support, make dem dey rotate presidency for Naija like barbar chair afta dem cancel June 12, 1993 election. Akume yarn dis one for World Press Conference for Abuja as part of Democracy Day celebration. Im say di annulment of di election wey late MKO Abiola win make political leaders take hard decision […]

todayJune 10, 2026 9

National

Shettima Rake Say EFCC Make Foreign Investors Trust Naija More

By: Esther Ayoola Wi Vice Presido, Kashim Shettima, nor be small tin oh, don rake full newspaper say, na di  strong work by EFCC make Naija name nor loud for money laundry mata. Shettima yarn dis one during di commissioning of EFCC new zonal office for Ado-Ekiti, Ekiti State. He also assure Nigerians say Federal Gornment go continue to strengthen anti-corruption agencies through beta infrastructure, staff welfare, training and operational independence.

todayJune 10, 2026 8

Lagos

Lagos Assembly Back Royal Family For Oko-Ado Land Mata, Push Make Dem Collect C Of O

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly on Tuesday don accept recommendation on petition wey concern land mata for Oko-Ado Village, Sangotedo. Dem dey ask, make gornment issue Certificate of Occupancy (C of O) give Igbaro Oteshade Royal Family. Na Chairmo of Judiciary and Public Petitions Committee, Oladipupo Ajomale, tuk dis tuk, say dem go check di land with Surveyor-General office and other agencies like Land Bureau and NTDA. E sti show say part of about 20 hectares don […]

todayJune 10, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds