Blog masonry

Background

General

How Kidnappers Dey Target Victims Through Social Media

For old days, if kidnappers wan pick person, dem go need informant, follow person physically, or get insider wey know di victim well well. But nowadays, things don change. Na so-called “harmless” social media post don turn their biggest tool. Plenty criminals no even need stress again, na victims dey give dem full informate like gift. Security experts don warn say kidnappers and other criminals now dey use Facebook, Instagram, TikTok, Snapchat, WhatsApp Status and other platforms take monitor pipo, […]

todayJune 9, 2026 13

Sports

Chelsea, Man City Drag Over Maresca Deal For Guardiola Job

By: Esther Ayoola Chelsea and Manchester City negotiations for Enzo Maresca to replace Pep Guardiola don enter go slow because of compensation mata. Guardiola don already announce say im go leave City afta many successful years, and City want Maresca take over. But Chelsea dey insist say dem suppose pay money because Maresca sti get contract with dem before he comot Stamford Bridge. As things stand, both clubs sti dey drag as legal and financial issues dey slow di deal.

todayJune 9, 2026 14 4

Sports

Edo Queens Hammer FC Robo 4-1 For Super Six Clash

By: Esther Ayoola Edo Queens of Benin don beat FC Robo 4-1 for dia second match of di 2026 NWFL Premiership Super Six wey happen for Port Harcourt. Dem bin lose dia first game 1-0 to Nasarawa Amazons, so, dem need dis win to stay inside competition. Esther Moses open scoring for 15th minute, while Chioma Moses add second goal before halftime to put Edo Queens ahead. For second half, Precious Oscar and Mary Mamudu complete di 4-1 victory with […]

todayJune 9, 2026 13

National

Warri–Itakpe Train Askident Kpai Three Passengers

By: Esther Ayoola Nor be small thing, say na Three passengers naim sadly kpai afta train wey dey run Warri–Itakpe get askident on Monday. NRC naim dey konfamate di incident for news statement. Di Nigerian Railway Corporation tuk say emergency teams and other authorities rush go di scene to help handle dsi situation. Di corporation add say dem sti dey monitor wetin hapun and promise say full statement go come out later.

todayJune 9, 2026 10 1

National

Naija, Madagascar Link Up As Tinubu Receive New Leader

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don welcome Madagascar Presido, Colonel Michael Randrianirina, for Aso Villa, Abuja, on Monday. Di Madagascar leader visit Naija as part of efforts to strengthen relations between both countries. Randrianirina become presido for October 2025 afta dem remove  president Andry Rajoelina from office. Before e enter power, na im lead one army unit wey join anti-gornment protesters and later announce military control of di country.

todayJune 9, 2026 9 1

Lagos

LNSA Enter Criminal Hideouts, kramp 279 Suspects For Lagos

By: Esther Ayoola Nna men, things dey hapun for Lagos o! di Lagos State Neighbourhood Safety Agency (LNSA) don show say dem no dey sleep when e come to area security, as dem burst a total of 279 suspected criminals inside one massive statewide operation. Oga boss of di agency, General Manager Prince Ifalade Oyekan, na him parade all di suspects on Monday for dia headquarters inside Oshodi. According to di Oga, di operation start from Sunday night enter Monday […]

todayJune 9, 2026 7

south west

Ogun Gorment Set Up Committee To Secure Schools

By: Esther Ayoola Ogun State Gornment don decide oh say dem nor wan hear dem shoot bird mama fly, like dis don set up security Committee to tackle jaguda boys for schools. Na oga Commissioner for Education, Prof. Abayomi Arigbabu, naim carry dis mata tuk give tatafo, say di committee go hellep improve safety, emergency response and beta learning environment for students and teachers. Di senior man commissioner explain say di team go include sabi mehn and stakeholders wey go […]

todayJune 9, 2026 6

Sports

Super Falcons Show Power

Nigeria Super Falcons show say dem ready oh for WAFCON 2026, beating  Senegal 3-0 for dia second friendly match for Ikenne, Ogun State. Di win complete double victory for di African champions after dem first beat di Teranga Lionesses 2-1 on Friday. Coach Justin Madugu and im players dominate di game from start to finish, create plenty chances even though Senegal defence try hold ground for first half. Di result don boost di team confidence as dem dey prepare for […]

todayJune 9, 2026 9

obodo oyinbo

WHO Give Uganda Big Respect

Di head of di World Health Organization, Tedros Adhanom Ghebreyesus, don hail Uganda as dem dey try well-well to stop di Ebola virus from spreading enter inside dia country. Oga Tedros, wey visit Mulago National Referral Hospital for Kampala on Monday, talk say Uganda really dey handle di matter sharply. Dis praise dey come after WHO declare di Ebola outbreak a heavy international emergency, as di sickness don kpai 91 pipo and catch 515 others for neighboring Democratic Republic of […]

todayJune 9, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds