Blog masonry

Background

Sports

Serena Williams Return with Big Win for Queen’s Club Doubles

Senior woman, Serena Williams don make ogbonge winning return to tennis for Queen’s Club doubles on Tuesday. Di American legend wey don win 23 Grand Slam titles team up with Canada teenage Queen, Victoria Mboko, and dem beat Erin Routliffe and Nicole Melichar-Martinez 7-6 (7/2), 6-2 for first round. Mama Sere, Sere, wey shock plenty pipo last week unto say, seh tuk say, she wan return to playing, say she sha shake small for di match but sti get di […]

todayJune 10, 2026 8

obodo oyinbo

Trump Promise Iran Backyard Movement

Baba Presido of America, Donald Trump drop one or two on Tuesday say hand go touch Iran, say e nor get wetin person go tell am,  hand go touch Iran say dem get mind shoot down one US military helicopter wey dey patrol near Strait of Hormuz. Trump tuk for im truth social on Tuesday say, im hear report say di attack hapun for night, even as dem dey try find way to end di war. For Iran side, parliament […]

todayJune 10, 2026 11

OBODO NAIJA

President Tinubu Approve ₦10B Emergency Fund

Oga Presido Bola Tinubu don approve make dem set up Presidential Task Force to prepare Nigeria against Ebola virus and other health issues. Di Presido also order, make dem release ₦10 billion emergency fund sharply to help build wall of Jericho against di  disease. Dis na According to im tuk tuk person, Bayo Onanuga, say di money go hellep di NCDC, how dem dey respond to sickness. Dis task force, wey Chief of Staff, Femi Gbajabiamila go lead, come out […]

todayJune 10, 2026 10

Lagos

Lagos Gorment Set Compass To Rascal Ebola

Lagos Health Commissioner, Prof. Akin Abayomi, don shake table drop micro soft word say Lagos State get strong doings in place to package Ebola. Im tuk dis one during Invest Lagos 3.0 event on Tuesday. According to am, even as COVID-19 loud reach for 2020, say e dey choir practice for Ebola mata, but dat, Lagos don package tools for di Ebola.

todayJune 10, 2026 10

Lagos

Lagos-Apapa Expressway Askident Kpai Minibus Driver

One commercial driver don lose im life for serious askident wey happen for Lagos-Apapa Expressway. Di gboza crash, involve commercial tuke tuke motor and Toyota Tundra. According to Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) tuk tuk person, Adebayo Taofiq, di driver wunjure wetin nor gud and im kpai for di spot because of di heavy impact. Authorities don begin investigate to know wetin cause di askident.

todayJune 10, 2026 13

Sport Yarns

Man United Don Finalize Busy Pre-Season Play With AC Milan For Poland

By : Jolayemi Olajide Manchester United don announce on Tuesday say dem go finish dia tight pre-season preparation against AC Milan for Wroclaw inside Poland. Di big match go hold on August 15 as coach Michael Carrick dey plan to build on top di beta third position wey di club carry last season before di new Premier League start. United go start di matches against Wrexham for Helsinki on July 18, before dem move go Norway go face Rosenborg di […]

todayJune 9, 2026 12

Entertainment

Comedian Bovi Say He Dey Happy When Pipo Divorce If Di Marriage Don Turn Into Suffer-Suffer

By : Jolayemi Olajide Popular Naija comedian, Bovi Ugboma, don open mouth yarn for sit down tuk say he dey happy when pipo divorce if di marriage don change to suffer-suffer. Bovi yarn inside the show say marriage no suppose be do-or-die marra and he go celebrate divorce because e mean say di couples fit breathe well now. Dis marra trend as Bovi change narrative on top how pipo dey see divorce for Nigeria, yarn say to comot for bad […]

todayJune 9, 2026 10

OBODO NAIJA

Military Jets Kill Eight Terrorists, Scatter Their Hideout For Borno State

By : Jolayemi Olajide Nigerian military jets don bomb terrorist hideout for Borno State on Sunday, June 7, where dem kill at least eight jaguda boys and destroy dia supply motor. The Air Component of Operation HADIN KAI wire this heavy attack for Cross Kauwa axis after security show where di boys dey gather. Surveillance aircraft first spot di jaguda boys where dem hide inside thick bush before di military command send aeroplane go wipe dem out. Di gorment carry […]

todayJune 9, 2026 7

OBODO NAIJA

Peter Obi Dey Ask Govt To Show Wentin Dem Use Almost 200 Trillion Naira Debt Do

By : Jolayemi Olajide Peter Obi don challenge Federal Government on Tuesday make dem open eye tell Nigerians wetin dem use all di money wey dem borrow do as country gbese dey load near 200 trillion naira. Di NDC presidential candidate drop dis tuk for em X handle where he complain say Nigeria gbese don jump up with pass 100 trillion naira within just three years. Obi yarn say di way President Bola Tinubu govt dey pack debt gbese country […]

todayJune 9, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds