Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Senate Push For State Police

Senate don drop microsoft word say dem go begin urgent discussion on state police dis week to hellep tackle di rising insecurity for di country. Senate Leader, Opeyemi Bamidele, naim tuk dis one for statement, say di mata don become top priority inside di ongoing constitutional review process. Im say dem don already dey meet stakeholders and dem go quick pass di bill so e fit move go state assemblies and later get presidential approval.  

todayJune 9, 2026 10

OBODO NAIJA

President Tinubu Replace Adelabu, Tuggar With New Ministers

Wi oga Presido, Bola Tinubu don go swear for two new ministers, Joseph Tegbe as Minister of Power and for Sola Enikanolaiye as Minister of State for Foreign Affairs for Aso Villa, Abuja. Di swearing-in ceremony hapun on Monday inside di Council Chamber with top gornment officials and family members present. Di appointment follow di resignation of former ministers Adebayo Adelabu and Yusuf Tuggar, wey leave office to contest election positions.

todayJune 9, 2026 14

Lagos

Vice Presido, Shettima Hail Tinubu

Vice Presido Kashim Shettima on Monday say Nigeria plan, na to build one-trillion-dollar economy, wey investors go package across all levels of gornment. Im tuk dis tuk one wen e open di Invest Lagos 3.0 Summit for Eko Hotel and Suites, Victoria Island, Lagos. Shettima also praise Presido, Bola Tinubu, say im  ma try oh, even though plenty Nigerians nor dey see dat oga presido try, as im take transform naija economy, say naim dey bring all this ogbonge investment

todayJune 9, 2026 11

Sport Yarns

Alex Iwobi Thank Nigerians Say im Wan Play Im 100th Game For Super Eagles

By : Jolayemi Olajide Super Eagles star midfielder, Alexander Iwobi, don send big thank you to all Nigerians for home and abroad for di heavy love and support as im prepare to play im 100th match for Nigeria against Portugal inside Leiria on Wednesday. Inside one sharp tuk on Monday, naim di playmaker take fry mouth tuk di tuk. Iwobi say im dey very proud to wear di green and white jersey and im nor get any single regret say […]

todayJune 8, 2026 11

OBODO NAIJA

 Atiku Salute Ngozi Okonjo-Iweala Based on Her Younger Brother Wey Kpai

By : Jolayemi Olajide Former Vice Presido, Atiku Abubakar don send im condolence message to di Director-General of di World Trade Organization (WTO), Dr. Ngozi Okonjo-Iweala, after her younger brother, Prince Ikechukwu Okonjo, kpai. Inside one post on top im X account on Monday, naim Atiku take salutate di former Nigeria finance minister and her entire family over di painful loss wey hit dem. Atiku describe di late Prince Ikechukwu as a respected member of di Umu Obi Obahai royal […]

todayJune 8, 2026 11

Lagos

Protesters Storm Lagos Assembly Demand For Ajiran Community Leader

By : Jolayemi Olajide Some Lagos pipo storm State House of Assembly on Monday to protest because police lock up one Ajiran community leader, Hammed Tajudeen Akanbi. Di protesters march from Ikeja Shopping Mall go give di Speaker petition, as dem dey shout make gornment release di man. Dis rally hapun after Akanbi lawyers cry out say di court dey do partial for the mata, so fresh investigation must start. Dem lock the leader put for jail because dem allege […]

todayJune 8, 2026 10

OBODO NAIJA

Senator Victor Umeh Tuk Why Lawmakers Dey Use Big Official Cars

By : Jolayemi Olajide Senator Victor Umeh wey dey represent Anambra Central don clear matas on why dem give National Assembly lawmakers big motors, say, dem need am to do dem legislative duties well. Umeh tuk dis tuk for one interview on Monday, say, pipo nor get any right to vex over the mata, sake of say di official motor na official work. When dem ask am if he collect im own motor, the Senator talk say nothing stop am […]

todayJune 8, 2026 14

Sport Yarns

Florentino Pérez Win Real Madrid Presidential election, Go Lead Till 2030

By : Jolayemi Olajide Florentino Pérez don collobi another win to rule Real Madrid  as dia presido  till 2030. For the election, he gather 21,741 votes (65%) while challenger Enrique Riquelme get 11,814 votes (35%). Na For  acceptance  victory speech, Pérez take clear every body im mind unto how e wan to move di club forward. Di  long-serving president say di election result show say, fans support im plan to protect Real Madrid identity and independence.

todayJune 8, 2026 10

obodo oyinbo

Heavy 7.8-Magnitude Earthquake Hit Philippines, Kpai 15 Pipo

By : Jolayemi Olajide Chai, heavy  problem for  southern Philippines on Monday, dat  one massive 7.8-magnitude earthquake shake the area. Dis na according to di United States Geological Survey, and USGS, wey konfam di mata, and  at least 15 pipo don kpai  near General Santos City. According to Philippine authorities, the earthquake hapun inside water for the southern part of the city. Based on dis,  Philippine gornment  don  order make  pipo wey dey live near the beach, run go higher […]

todayJune 8, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds