Blog masonry

Background

National

Vice Presido Shettima Carry Swear Go Swear For New Côte D’ivoire Presido

By: Esther Ayoola Wi Vice Presido, Kashim Shettima don enter Abidjan, Côte d’Ivoire, to stand in for im oga  President Bola Ahmed Tinubu for President Alassane Ouattara fourth-term inauguration wey on shelle today. The update come from Senior Special Assistant to the President on Media and Communications, Stanley Nkwocha. Shettima go join plenty African leaders and international big names take swear for the new presido inside the ceremony wey go hold for the Presidential Palace cote de ivore,  capital, abijan.

todayDecember 8, 2025 7

National

Oluremi Tinubu Yan Marras Dat Nigeria Go Soon Dey Borrow Other Countries Money

By: Alice Iduh First Lady, Senator Oluremi Tinubu, dey show doings,  yanyanpu  say, one day Nigeria go dey  borrow  money to other countries, and that better prosperity dey front.   She yarn this one on Sunday for Ile-Ife, Osun State, after dem give her chieftaincy title, Yeye Asiwaju Gbogbo Ile Oodua.   The event still mark the 10th coronation anniversary of Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi, wey attract big names like former President Olusegun Obasanjo, VP wife Nana Shettima, […]

todayDecember 8, 2025 9

National

PDP Factional Bot Support NWC To Stabilise Party

By: Esther Ayoola Di pipos democratic party factional Board of Trustees (BOT) wey dey follow FCT Minister, Nyesom Wike, don talk say dem go work hand-in-hand wit di PDP National Working Committee (NWC) to make sure di party balance well. Di Chairman of di factional BOT, Senator Mao Ohuabunwa, yarn dis one on Sunday for di opening of dia meeting wey dem hold for di Minister Life Camp residence for Abuja. Ohuabunwa talk say di faction dey serious to strengthen […]

todayDecember 8, 2025 7

Lagos

Akinsanya Olojo Family Beg Sanwo-Olu Make E Install Prince Abiola As Oloja Of Lagos

By: Esther Ayoola The Akinsanya Olojo family wey dey king Kosoko royal dynasty for Lagos don beg Governor Babajide Sanwo-olu make e approve prince Abiola Olojo-Kosoko as the next oloja of lagos. Dem talk say prince Abiola don dey oloja-elect since December 12, 2020, but dem never install am even after more than four years. Dem put the request for one statement wey dem send go the governor and copy other important oga dem like secretary to the state government […]

todayDecember 8, 2025 3

south east

Imo Hotel, Mortuary To Face Sanctions Over Organ Harvest Issues

By: Alice Iduh Imo State Government don lock one hotel and mortuary for Umuhu, Ngor-Okpala, afta officials jam dead bodies wey dem keep for one kain dirty dirty wey raise organ-harvest gist.   Police say na part of dia tough crackdown on top jaguda boiz for Owerri–Aba Expressway under Commissioner Aboki Danjuma.   Di matter burst from statement wey police drop Saturday and post for X on Sunday by spokesperson DSP Okoye Henry.

todayDecember 8, 2025 5

Lagos

Umahi Show New Safety Plan For Lagos–Calabar Coastal Road

By: Esther Ayoola Wi Minister of Works, David Umahi, don Tuk oh,  say, the Lagos–Calabar Coastal Highway go get relief stations, solar light, and CCTV cameras to make the road safer and ensure emergency people fit respond sharp sharp  within ten minutes. The minister yarn this one on Sunday as im go inspect the Calabar–Itu Road and Sections 3A and 3B of the 71.4-kilometre, wey inside the  750-kilometre highway wey dem dey build for Cross River State. Umahi hail the […]

todayDecember 8, 2025 1

obodo oyinbo

Burkina Faso Free 8 NGO Members Wey Arrest For Spying

Burkina Faso military don finally free eight NGO members wey dem hold tight for months for alleged spying, include foreigners from France, Czech, Mali plus four Burkinabe nationals. Dem arrest di people for July, but junta no yarn anything till October, after dem dash ban to 21 NGOs, including Netherlands-based INSO. INSO yarn say dem dey happy well-well say dia colleagues don finally free and dem thank everybody wey help make am happen. But Burkina Faso authorities still dey yarn […]

todayDecember 5, 2025 16

obodo oyinbo

EU Sama Musk X Wit €120m, Fit Shake Trump Mood

EU don sama Elon Musk X wit €120m fine for breaking digital rules, and e fit scatter Trump side. Na first-ever fine under Digital Services Act, as X no clear transparency, dey play wit blue check for verified account. EU tech oga, Henna Virkkunen, yarn say na transparency mata, no be censorship, but US VP JD Vance don fire warning make dem no dey attack American company.

todayDecember 5, 2025 9

National

Tinubu Collect Diplomatic Letters From 21 Envoys

President Tinubu don collect diplomatic letters from 21 new envoys, 17 ambassadors and four high commissioners, inside Council Chamber. Tinubu talk say Naija ready to strengthen friendship, push cooperation and stand strong for peace and progress across borders. Japan ambassador, Suzuki Hideo, call di ceremony historic and hail Nigeria as ECOWAS heavyweight. Envoys come from Japan, Chad, Gabon, Türkiye, Palestine, Spain, Indonesia, Mauritania, Austria, Thailand, Bangladesh, Sweden, Czech Republic, Liberia, Ghana, India, Poland, Italy, Slovakia, Iran and Barbados.

todayDecember 5, 2025 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app