Blog masonry

Background

National

Iran Presido Konfamate Dat Iran Tuks Wit US Get Small Green Light

By: Esther Ayoola Iran presido Masoud Pezeshkian, don konfamate say Iran nuclear tuks wit US don show “encouraging signals,” but Iran dey ready for anything. Presido Masoud dey tell tori pipo on Sunday, say, dem want peace and stability for di region. Dat, Third round of tuks go hapun for Geneva dis Thursday wit Oman as di peacemakers. Nor be amebo say, Di first two rounds of tuks no get big breakthrough, but both side sti dey positive.

todayFebruary 23, 2026 7

obodo oyinbo

Ukraine Presido Zelensky Put Pressure Say Ukraine Must Win War Against Russia

By: Esther Ayoola Ukraine Presido, Volodymyr Zelensky don drop yarns again, based on ceasefire tuk with Russia wey nor dey go as plan, say last, last, Ukraine go win di war. Di Ukraine presido say im nor go fit give ground, wey Russia nor fit take, say like dis Russia don start World War three. Say Di only way na to make strong military and money to put pressure on Putin soldiers.

todayFebruary 23, 2026 5

National

NCDC Share Report Card Of 70 Lassa Fever Deaths, 318 Cases

By: Esther Ayoola Naija Centre for Disease Control (NCDC) don konfamate say 70 people ni don kpai from Lassa fever for di first seven weeks of 2026, with 318 konfam cases from 1,469 pipo wey dem suspect get di disease. Say di disease sti dey mostly for five states wey get 91% of di cases, and 10 local government areas dey carry 68% of di infections. NCDC tuk say Lassa fever na normal thing for Naija and e  dey sabi […]

todayFebruary 23, 2026 8

National

NASS Put Two Years Jail Term To Stop Election Wuruwuru

By: Esther Ayoola For Abuja on Sunday, Leader of di Senate, Senator Opeyemi Bamidele, don explain how  National Assembly take pass Electoral Act 2026 wey carry big reforms. According to Opeyemi, di act include two‑year jail for any Resident Electoral Commissioner wey go hide important election documents and dat e allow quick release of money to INEC, so dat election go smooth. E say di law na as a result of two years tuk, tuk, with stakeholders like INEC, AGF […]

todayFebruary 23, 2026 4

National

PDP Carry Legal Team To Challenge FCT Area Council Election Result

By: Esther Ayoola Di Peoples Democratic Party don set up special legal team to challenge di result of Saturday Area Council election for Federal Capital Territory. For statement wey im National Publicity Secretary Ini Ememobong sign, PDP say dem go challenge di alleged irregularities and di legal team go dey led by Shafi Bara’u, Esq. According to Independent National Electoral Commission, candidates of All Progressives Congress win five out of six chairmanship seats, while PDP carry Gwagwalada. Di election wey […]

todayFebruary 23, 2026 3

National

Wike Explain How FCT Election Expose Dey Pretender

By: Esther Ayoola Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike,  don bumshell again again,(say if u trust politicians na at your on kobo), say na pretenders ni full naija politics following wetin im call peaceful election for FCT E tuk dis one for live tuk tuk for tv, say di result don expose pipo wella, wey dey buy corn and groundnut for roadside just to deceive Nigerians, say dem be real opposition. Wike sha praise Presido, Bola Tinubu, say […]

todayFebruary 23, 2026 6

Lagos

Senator Abiru Ginger Lagos Youth To Put Body For Politics

By: Esther Ayoola Oga senator wey dey represent Lagos East Senatorial District, Tokunbo Abiru, don drop yarns, say Naija politics don change colour and dat na youths dey run di show now. E yarn dis one as keynote speaker for Eko Youth Parliamentary Summit wey shelle for Lateef Jakande Auditorium inside Lagos State House of Assembly premises for Alausa, Ikeja. Abiru ginger youths like motor battery, say make dem dey engage for governance and build good foundation for politics to […]

todayFebruary 23, 2026 4

Lagos

Minister Of Works Share Update For Lagos–Calabar Coastal Highway

By: Esther Ayoola Wi oga Minister of Works, Senator Engr. David Umahi, don give Lagosians assurance say One part of di Lagos, Calabar Coastal Highway go ready for commissioning by May. Im yarn dis one on Saturday, when him go inspect di project untop di coastal road wey go link Lagos to South-South and South-East. Umahi say di progress, dey show di workings of wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu administration seriousness to deliver beta infrastructure, even with di hard […]

todayFebruary 23, 2026 7

Lagos

Lagos Deputy Govo Hamzat Tell Muslims To Celebrate Ramadan With Kindness

By: Esther Ayoola Lagos State deputy govo, Obafemi Hamzat, don advise Muslims and Christians make dem use Ramadan period show empathy, kindness, and good neighbourliness. Im tuk dis one for Ramadan prayer wey United Muslim Council of Naija, Mushin branch, arrange for Ogba, Lagos. Hamzat yarn say Ramadan fit hellep Nigerians understand each other wella and make dem become responsible citizens. E sti remind pipo say true religion go only show, when we dey care for our community and environment.

todayFebruary 23, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app