Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Pope Leo XIV Beg International World Pipo To  Congo Fight Ebola

By: Mariam Ajayi Pope Leo XIV don call on di international community make dem join hands help Democratic Republic of Congo fight Ebola disease. Di Pope make dis call on Sunday after im Angelus prayer for St Peter’s Square, as e urge local communities to also join di effort to save lives. He say di suffering wey Ebola don cause for Congo serious, and e don worry am say instead of blessings to spread, na disease dey spread. Pope Leo […]

todayAugust 24, 2026 18

OBODO NAIJA

Atiku Camp Knock FG Say  Petrol Subsidy Dey Do Nigerians Sufferly Dey Dey

By: Mariam Ajayi Wahala still dey, as ADC presidential candidate Atiku Abubakar pikin, Kenneth Okonkwo, don drag Federal Government over di removal of petrol subsidy. Di former Nollywood actor say di policy don make economic hardship worse for Nigerians and increase di suffering wey people dey face. Okonkwo talk dis one during one television interview on Sunday, saying di value of naira don fall badly since di subsidy removal. According to am, people wey dey get money before now dey […]

todayAugust 24, 2026 8

Local

Lagos Gornment Install New Onise, Charge Am To Unite Ise Kingdom

By: Mariam Ajayi Lagos State Government don officially install Ibrahim Saliu as di new Onise of Ise Kingdom for Ibeju-Lekki. Government present di Staff of Office and Instrument of Appointment to am last Friday, after di death of former monarch, Ganiu Adegbesan. Special Adviser to di Governor on Rural Development, Nurudeen Agbaje, charge di new monarch to unite all di royal families and promote peace for di kingdom. He also urge am to work with oda traditional rulers and community […]

todayAugust 24, 2026 15

Politics

Wike Claim Say Adeleke Join Tinubu Camp Ahead 2027

FCT Minister, Nyesom Wike, don drop another political bombshell, say Osun State Govo, Ademola Adeleke, na member of im political camp and dem all dey support Presido Bola Ahmed Tinubu. Wike talk dis one for Abuja on Friday, as political realignment dey gather momentum ahead of 2027. He say more politicians and groups still dey prepare to join Tinubu camp, while he dismiss claims by some ADC members say dem get credit for Adeleke victory.

todayAugust 21, 2026 21

Politics

INEC Set January 16 For 2027 Presidential Election

INEC don confirm say Presidential and National Assembly election go hold January 16, 2027, while Governorship and State Assembly election go follow on February 6. INEC Chairman, Prof. Joash Amupitan, say di Commission dey prepare well to make voting smooth, secure and transparent. He point to di recent Osun election as example of wetin INEC fit achieve, with most polling units opening on time and BVAS working well. INEC also plan to deploy about 1.4 million ad-hoc workers across more […]

todayAugust 21, 2026 18

Sports

Arsenal Sign Konsa To Boost Defence After Saliba Wunjury

Arsenal don sign England defender Ezri Konsa from Aston Villa to strengthen dia defence after William Saliba suffer back injury. Konsa fit make im Arsenal debut against im former club, Aston Villa, on August 31. Di defender say e happy to join Arsenal and hungry to win trophies with di club. Arsenal sporting director Andrea Berta describe Konsa as a quality defender with strength, calmness and good tactical understanding.

todayAugust 21, 2026 19

Politics

Tinubu Knock Atiku Over Plan To Bring Back Fuel Subsidy

By: Kofoworola Olayinka Presido Bola Tinubu don criticise former Vice Presido, Atiku Abubakar over im plan to bring back fuel subsidy if e win di 2027 presidential election. Tinubu talk dis one on Thursday for State House, Abuja, saying Atiku plan show say e no understand gofnance and economy well. Di President say before fuel subsidy comot, 27 states no fit pay worker salary and gofrnors dey come Abuja dey ask for bailout.

todayAugust 21, 2026 20

Politics

Benue Assembly Wan Suspend Kwande Chairman For 3 Month

By: Kofoworola Olayinka Di Benue State House of Assembly don recommend three-month suspension for Kwande LGA Chairman, Vitalis Neji, over allege gross misconduct and abuse of office. Di recommendation come after an ad hoc committee investigate di tuk against am. Di committee chairman, Peter Ipusu, say Neji appear before dem but e no fit properly defend himself against di allegations.

todayAugust 21, 2026 22

obodo oyinbo

DR Congo Get 70,000 Ebola Vaccine Doses To Fight Outbreak

By: Kofoworola Olayinka Di International Coordinating Group don release 70,000 dose of Ervebo vaccine to Democratic Republic of Congo to help fight Ebola outbreak. 50,000 dose go reach health worker, while 20,000 go dey used for clinical trial to check whether di vaccine fit protect people against Bundibugyo virus. WHO and Africa CDC say dem never confirm whether di vaccine fit protect humans against di virus, although early tests show say e fit provide some protection.

todayAugust 21, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds