Blog masonry

Background

Politics

INEC Stand Ground say any  Primaries wey nor follow timetable, Otilor

By : Jolayemi Olajide   INEC don warn political parties say any primary election wey dem do after May 30 deadline no go  count oh, except higher court cancel the earlier judgment. National Commissioner Mohammed Kudu Haruna naim package for statement on Friday, say parties suppose still follow the Electoral Act 2026 until Court of Appeal decide on INEC appeal. Dis  mata sef sup based on one Federal High Court judgment wey nullify some parts of INEC timetable and guidelines […]

todayJune 5, 2026 10

OBODO NAIJA

Atiku Drag Tinubu Again Over Oyo Kidnap Victims

By : Jolayemi Olajide Former Vice Presido, Atiku Abubakar don tackle Presido, Bola Tinubu and First Lady Oluremi Tinubu over the continued kidnapping pupils and teachers  for Oyo State. For statement wey im media aide, Phrank Shaibu, release on Friday, Atiku accuse di Federal Gornment of failing to show enough energy to rescue di victims. Di African Democratic Congress presidential candidate say e dey difficult to understand why gornment still dey project celebration mood while innocent children and their teachers […]

todayJune 5, 2026 11

OBODO NAIJA

NCDC Raise Red Alert, Say Ebola Fit Enter Naija Anytime

By : Jolayemi Olajide Nigeria Centre for Disease Control and Prevention, NCDC, don make am clear say Ebola Virus Disease entering Nigeria dey very high cause e dey spread Uganda and Democratic Republic of Congo. NCDC Director-General, Dr Jide Idris, naim sorosoke dis announcement during media briefing for Lagos as e explain Nigeria preparedness level against di disease threat. According to am, as e dey increase for international, movement of people across borders fit cause serious gbege E also warn […]

todayJune 5, 2026 9

OBODO NAIJA

FG Join Body With FAO to Fight Birdflu Out

By : Jolayemi Olajide Federal Gornment don join body with Food and Agriculture Organization, FAO, to block and fight bird flu virus inside di country with $350,000 cash. Di Ministry of Livestock Development naim yarn dis one on Thursday night say di cash go train 240 animal health workers to trace di sickness. Dis new project go help upgrade lab setup, track animal diseases, and make sure say information dey flow wella. Minister Idi Maiha tuk say poultry business get […]

todayJune 5, 2026 10

Entertainment

Flavour N’abania Drop Rakings Say Nobody Fit Cage Me

By : Jolayemi Olajide   Highlife superstar Flavour N’abania don blow broadside say he be explorer wey belong to di wild world and nobody fit cage am. Flavour tuk dis tuk inside video broadcast, say some men na house men, but im own na for street. Di singer get three daughters with two heavy beauty queens, Sandra Okagbue and Anna Banner, plus one blind boy wey he adopt from Liberia.  

todayJune 5, 2026 10

Sport Yarns

Calvin Bassey Explain How Dem To Loose Guard Nack Poland

By : Jolayemi Olajide Super Eagles bouncer defender, Calvin Bassey don yanyanpu say Poland get luck for dia international friendly match wey dem nack for Warsaw on Wednesday. Bassey clean mouth, sit down tuk say na small small mistake na make Poland cancel di beta lead wey Terem Moffi and Paul Onuachu bin give Nigeria. According to di senior man defender, dat one mean say dem gat work on dia defending moving forward.

todayJune 5, 2026 7

OBODO NAIJA

Police Ggab Seven Bad Boys for Ogun State After Dem Raid Area

By : Jolayemi Olajide Ogun State Police Command don scata some jaguda boys after dem corner dem inside heavy raid across Sango-Ota, Owode-Egba, and Agbado areas. Police tuk tuk, DSP Oluseyi Babaseyi, naim use im yamchop mout onFriday tuk di mata, unto how di boys run enter di armed robbers. Inside di movement, police boys trace three of di suspects go Alasia community after di boys attack one house and collect im properties. Dem recover one local cut-to-size pistol and […]

todayJune 5, 2026 16

Lagos

Hamzat Select Senior Politician Obanikoro to Run im 2027 Campaign

By : Jolayemi Olajide Lagos State APC gofnorship candidate, Obafemi Hamzat, don point fingers hand give Nigeria former High Commissioner to Ghana, Senator Musiliu Obanikoro, say nothing wey im go tell am, dat n aim go lead im 2027 campaign. Hamzat drop di tuk on Wednesday for one meeting wey di campaign council hold to log dia plans. According to Amebo pipo, President Bola Tinubu don already sign di paper and give Obanikoro clear road, before Hamzat con bring di […]

todayJune 5, 2026 7

obodo oyinbo

US Senate Dash Trump $70 Billion Make E Tighten Grip For Immigration Mata

By: Esther Ayoola United States Senate on Friday approve $70 billion funding to support President Donald Trump hardline immigration enforcement plan, giving am major victory on one of im key campaign promises. Di approval come afta lawmakers spend long hours voting on different amendments, as disagreement show among Republicans over some other controversial policies wey Trump dey push. Di money go fund Immigration and Customs Enforcement (ICE) and Border Patrol operations till di end of Trump tenure, as government dey […]

todayJune 5, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds