Blog masonry

Background

National

Peter Obi Clear Nigerians Not To Blame Any Tribe For Criminality For Naija

By: Esther Ayoola Naija Democratic congress, presidential candidate, Peter Obi don drop some wisdom word (oro ogbon), say make Nigerians make nor tagget any particular tribe for all di security badness wey dey sup for Naija. For message wey e post for im verified X handle on Monday, Obi tok say as Igbo man, e don face plenty name calling and say many Fulani people dey suffer di same thing because of all di rubbish character of some pipo Di […]

todayJune 8, 2026 8

Sports

Portugal Star Rafael Leão Out Of Naija Match Afta Red Card

By: Esther Ayoola Portugal winger Rafael Leão no go play for dia  final World Cup warm-up match against Naija on Wednesday afta im collect red card against Chile on Saturday. Referee bin comot Leão for pitch before half-time because he give Chile defender, Ivan Román, one heavy blow for face. Even though Portugal play with ten men, dem sti bounce back beat Chile 2-1 as Gonçalo Guedes and Bruno Fernandes score for second half before Román manage score one for […]

todayJune 8, 2026 10

Sports

How Denmark Star Christian Eriksen Faint Again For Field

By: Esther Ayoola Say nor be small fear catch fans on Sunday as Denmark midfielder, Christian Eriksen, fall down for pitch during dia friendly match against Ukraine. Dis badness dey hapun for di second time to di 34-year-old player afta im heart first stop during di Euro match against Finland five years ago. Di Danish Football Association don bring statement say Eriksen eye dey open and im dey receive treatment for hospital. Di  team doctor, Morten Boesen, yarn say di […]

todayJune 8, 2026 9

obodo oyinbo

Iran Threaten To Fire America And Israel As Dia War Clock 100 Days

By: Esther Ayoola Iran don threat say dem go drop tins for  America and Israel sake of bombing wey hapun for Beirut on Sunday, as the Middle East war clock exactly 100 days. This new round of wahala dey spoil tins,  hope say peace go soon reign, don jam rock, like dis Tehran clear everybody, say any peace tuk to end the war permanently must also stop the fight inside Lebanon, wia Israel dey pursue Hezbollah fighters wey Iran dey […]

todayJune 8, 2026 10

Sports

Afta Four Hours, Zverev Colobi First Grand Slam Trophy

World number two tennis player, Alexander Zverev, don finally carry im first Grand Slam trophy after he beat Flavio Cobolli from Italy inside one heavy five-set match for di French Open final on Sunday. As di Senior player dey court di paly di game, na so im family dey church dey fire prayer. Di German guy play for four hours and 16 minutes before he fit win Cobolli 6-1, 4-6, 6-4, 6-7, 6-1 to break di jinx. With dis win, […]

todayJune 8, 2026 11 1

National

Works Minister Umahi Threaten To Sack Contractor Wey Go Delay Road Project

By: Esther Ayoola Di Minister of Works, Senator David Umahi, don warn contractors on Saturday, say im go clear out anyone, whether na Nigerian or foreigner, wey go try am delay gornment project. Umahi tuk dis one during inspection of de Mararaba-Keffi and Zuba-Kaduna road work. Im press tuk say any company wey no fit invest dia own money to move work forward while dem dey wait for federal gornment payment, no really get di progress of Nigeria for heart.

todayJune 8, 2026 6

National

President Tinubu Again Promise To Fight Insecurity And Reduce Hard Life For Nigerians

By: Esther Ayoola Di Federal Government don assure Nigerians again say dem dey work hard to fight insecurity and bad economy, and di country no go ever bow down for terrorists or criminals. Secretary to di Gornment of di Federation, Senator George Akume, na him clear dis one on Sunday when he represent President Bola Tinubu for one national church service for Abuja to mark di 2026 Democracy Day. Akume yarn inside one statement for X say President Tinubu gornment […]

todayJune 8, 2026 11

south west

Oyo Police Kpai Two Kidnappers As Dem Rescue Former Power Minister Adelabu Sister

By: Esther Ayoola Oyo State Police Command don kpai two suspected kidnappers inside di sharp operation wey dem do on Saturday night to rescue former Minister of Power sister,  Busayo Adelabu-JohnPaul, and her 12-year-old twin boys. Di Commissioner of Police for di state, Abimbola Olugbenga, naim sunch dis mata for Ibadan on Sunday, unto how dem take recover heavy weapons,  juju wey dei kidnappers dey use. CP Olugbenga explain say di gang na dem block and kidnap di woman and […]

todayJune 8, 2026 11 1

south west

Adelabu Family Thank Security Say Dem Rescue Im Sister, Her Twins

By: Esther Ayoola Family of former Minister of Power, Adebayo Adelabu, don tank Naija security agents for dia doings say dem rescue im sister, Olaide Adegoke John-Paul, and her 12-year-old twin pikins wey dem from kidnappers hand. Di former minister mama, Olufunmilayo Adelabu, naim con dey fry mouth give tori pipo, unto how her body dey sweet her thank everybody for di support and prayers during di wahala. As she dey jubilate, di mama sti pray di God wey do […]

todayJune 8, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds