Blog masonry

Background

south east

Two Die As Road Crash Happen For Anambra

By: Kofoworola Olayinka Two people don die while two others sustain injury for road crash wey happen opposite Jezco Filling Station along Awka-Enugu Expressway for Anambra State. Di crash happen late Thursday and e cause serious traffic jam for di road, as di vehicles block large part of di expressway. Eyewitnesses say four adult men dey inside di two commercial vehicles when di accident happen. Two die for di spot, while two others sustain different levels of injury.

todayAugust 21, 2026 11

crime

EFCC Don Withdraw Cybercrime Case Against BUK Student

By: Kofoworola Olayinka Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, don withdraw di cybercrime charge against final-year Bayero University student, Maryam Shehu, and another Nigerian, Abubakar Abdulhamad. Di two of dem face separate case for Federal High Court for Abuja on Thursday over alleged cybercrime and spreading bad information about EFCC. EFCC accuse Maryam of making social media post wey allege say some EFCC pipu beat one man and collect N20 million bribe.

todayAugust 21, 2026 24

Sports

Fury Say Fight With AJ Fit Scatter Over Money Matter

By: Kofoworola Olayinka Fight between Tyson Fury and Anthony Joshua never officially confirm yet, as money matter don dey cause problem for di proposed fight. Fury, 38, say negotiation don stall because Eddie Hearn and im team dey demand more money. Fury talk dis one for video while e dey exercise, saying di financial disagreement fit stop di fight from happening.

todayAugust 21, 2026 20

Politics

Peter Obi Say Him And Kwankwaso Get One Goal For Nigeria

By: Kofoworola Olayinka NDC presidential candidate, Peter Obi, don say im and im running mate, Rabiu Kwankwaso, get one common goal despite say dem come from different backgrounds to improve di life  of Nigerians, especially poor people. Obi talk dis one for Onitsha, Anambra State, during press conference ahead of di 2027 election. He say Nigeria must invest in people, create jobs and move from importing goods to producing more of wetin Nigerians dey use.

todayAugust 21, 2026 19

Politics

Peter Obi Challenge 2027 Presidential Candidates

By: Mariam Ajayi Peter Obi don officially start campaign for di 2027 presidential election and e challenge other people wey wan become president to come face Nigerians and answer questions about dia plans for di country. Obi talk dis on Friday for press conference for im residence for Onitsha to mark di start of di 2027 presidential and National Assembly campaigns. Di former presidential candidate say nobody wey dey seek Nigeria presidency should hide behind power or send people to […]

todayAugust 21, 2026 17

OBODO NAIJA

Primate Ayodele Don Predict Say Tinubu Fit Move Nigeria Capital Go Lagos If E Win for 2027

By: Mariam Ajayi Primate Elijah Ayodele, Popular cleric don predict say Oga Presido Bola Tinubu fit move capital of Naija from Abuja go Lagos if e win di 2027 presidential election.   Di cleric make di prediction for one video for X as Tinubu dey prepare to get anoda term for office.   Ayodele say if Tinubu win again, Lagos architecture go change and di capital fit move to Epe, Lekki or any other part of di state.   But […]

todayAugust 21, 2026 17

Sports

Arsenal Legend Warn Club Make Dem Think Twice Before Signing Osimhen

By: Mariam Ajayi Arsenal legend Alan Smith don warn di club say Galatasaray striker Victor Osimhen fit no be di right tactical or financial choice for Arsenal as di Premier League champions dey consider whether to sign di Nigerian striker dis summer. Smith tell tv tatafo pipo say Arsenal need a proper centre-forward but dem must make sure say whoever dem sign fit well into Mikel Arteta squad without disturbing di team chemistry.   Osimhen, wey dey play for Galatasaray […]

todayAugust 21, 2026 17

obodo oyinbo

Plane Crash Kill Eight People For Remote US Military Base For Alaska

By: Mariam Ajayi Eight people don die after one civilian plane crash for a remote US military base for Cape Newenham, Alaska, on Thursday, with rescue workers wey reach di scene confirming say nobody survive.   Di Alaskan Command say di plane crash for di airport of a radar station wey dey monitor aircraft movements for Alaska, but dem never reveal who di victims be or wetin dem dey do for di area.   Military say dem don start investigation […]

todayAugust 21, 2026 26

Politics

Imo PDP Dey Demand Arrest Of Orlu Chairman Over Alleged Threat To Opposition

By: Mariam Ajayi Imo State PDP don call for arrest and prosecution of Orlu LGA Chairman, Chris Mbarie, after alleged video wey dey circulate for social media show say e talk say opposition parties no go operate freely for Orlu ahead of di 2027 election.   PDP spokesperson, Lancelot Obiaku, make di demand in a statement on Thursday, saying di alleged remark no be ordinary talk as e fit amount to political intimidation and incitement against opposition members and voters […]

todayAugust 21, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds