Blog masonry

Background

Lagos

Cement Truck Crush LASTMA Officer, Two Okada Riders For Badagry

By: Esther Ayoola Tragedy hapun for Badagry Roundabout, Lagos on Monday, say one cement-loaded truck run LASTMA officer plus two okada riders, and all kpai on di spot. Eyewitness tuk say di truck dey rush anyhow, e lose control, and na so e scara area. Police and FRSC pipo rush to di scene, while traffic jam everywia. Divisional Police Officer of Badagry Police Station, CSP Folajimi Agosile, also konfamte dis mata, Say police don arrest di driver, and di truck, […]

todayFebruary 24, 2026 3

National

President Tinubu Make Plan To Start State Police For Rascal Jaguda Boys

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don announce ogbonge plan say, like dis, na to create state police be di way forward for di plenty security wahala for di kontri. Baba Seyi dey yarn dis one  wia im dey do wakies with governors of di obodo Naija for Abuja on Monday Mehn dey waka for di dinner,  Tinubu  dey think security,  say di reason na to make sure say, everywia dey secured for di obodo Naija.

todayFebruary 24, 2026

National

Kaduna Police Go Hard On Bandits, Gbab Suspected Drug Suppliers

By: Esther Ayoola Kaduna State Police Commissioner, Rabiu Muhammad, don share report card say dem do commando neutralise plenty suspected bandits for Kajuru, Tafa, Igabi, and Kauru Local Government Areas during dia February 2026 operation. Im dey yarn dis one for force headquarters, say na based on  intelligence-doings, dem take locate di  bandits’ camps and criminal hideouts. Mohammed say nor be small gun battle dem do with di jaguda boys, dem catch some, some kpai and others run away with […]

todayFebruary 24, 2026 3

National

El-Rufai Drag ICPC, I-G & AGF Go Court Over Abuja House Raid

By: Esther Ayoola Former Kaduna State Governor, Nasir El-Rufai, don drag Independent Corrupt Practices Commission, ICPC, go court for ₦1 billion, say dem enter him Abuja house without permission. Im lawyer, Oluwole Iyamu, SAN, clear tori pipo for Abuja say di search warrant wey Chief Magistrate for FCT issue on February 4 nor follow at all. For di suit wey dem file on February 20, El-Rufai name ICPC, di Magistrate, I-G of Police, and AGF as respondents, say all of […]

todayFebruary 24, 2026 3

National

How APC Chairmo Package Big Move For Naija Politics

By: Esther Ayoola Di National Chairmo of di All-Progressives Congress (APC), Prof. Nentawe Yilwatda, don officially open di governing board of di Progressives Institute (TPI) to think out ways for 2027 election. Dis ceremony hapun on Monday for di APC National Secretariat for Abuja. Yilwatda say, dis move na big step wey go hellep not just di APC but improve Nigerian politics.

todayFebruary 24, 2026 3

obodo oyinbo

Trump Say War For Iran Na Easy War Despite General Warnings

By: Esther Ayoola Oga Presido of United States, Donald Trump, dey vex wetin nor good say im Joint Chiefs of staff chairmo, General Dan Caine, warn am say, Iran attack fit be big problem. Trump write for social media on Monday say, Caine believe say Iran get power well, well.” Washington Post report say Caine tell Trump say dem dey short of important ammo and dat dem nor go fit stand di pressure of Iran. Say US don use plenti […]

todayFebruary 24, 2026 3

obodo oyinbo

Mexico Send 9,500 Soldiers To Guide State Properties Afta Drug Lord Kpai

By: Esther Ayoola Mexico don send plenty soldiers to control wahala for di kontri afta di death of one strong drug lord scarra everywia. Defence Secretary Ricardo Trevilla tell tori pipo say, dem don carry 2,500 soldiers go west Mexico on Monday, and dat di total soldiers, wey dey now, na 9,500 since Sunday. Plenti states, almost 20, don see nonsense, since Nemesio Oseguera Cervantes, wey dem sabi as "El Mencho", die for Jalisco. Nor be amebo say, di Jalisco […]

todayFebruary 24, 2026 1

obodo oyinbo

US Embassy For Beirut Evacuate Staff As Trump Threaten Iran

By: Esther Ayoola US gornment don tell all non-important workers, make dem comot for embassy for Beirut, Lebanon, for security purpose. Dis one dey hapun, as tension dey increase for di region, afta US Presido Donald Trump, say, im fit attack Iran if dem no agree on dia nuclear deal. Iran say, if US attack, dem go fight back, and American bases for Middle East ni go be di target. Meanwhile, Secretary of State Marco Rubio don delay him trip […]

todayFebruary 24, 2026 5

Sports

Anthony Joshua Set To Return To Boxing For July

By: Esther Ayoola Anthony Joshua dey plan return to boxing for July afta e survive serious car askident for Naija wey kpai two of im close friends, Sina Ghami and Latif Ayodele. Im promoter, Eddie Hearn, sha tell reporters say, di man never ready physically yet. Di March fight wey im suppose fight and fight with Tyson Fury dey cancel because of  say im never ready for fight. However, Joshua uncle, Adedamola, tuk say, di family dey fully support any […]

todayFebruary 24, 2026 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app