Blog masonry

Background

Local

Sunday Igboho Stop Police Arrest of Tani Olohun

By: Mariam Ajayi Yoruba Nation activists, Sunday Igboho, block police attempt to arrest Isese advocate, Abdulazeez Adegbola, popularly known as Tani Olohun. Footage shared on Tani Olohun Facebook page show confrontation between police officers and residents who gather as dem come to arrest am. One of di videos show one police officer pin Olohun to ground while residents gather around di scene. Di reason for di planned arrest no dey clear from di report, while di confrontation happen.

todayAugust 26, 2026 12

OBODO NAIJA

Ogun Introduce Rent-to-Own Housing Scheme for Residents

By: Mariam Ajayi Ogun State Gornment don introduce Rent-to-Own housing scheme to make house ownership easier and create jobs for artisans across di state. Commissioner for Housing, Jamiu Omoniyi, disclose dis during an X Space on Tuesday, say di scheme go help tackle high construction costs and inability to pay for houses at once. Gornment dey partner Gateway Mortgage Bank on Prince Court Estate, Kobape Phase IV, where residents fit spread dia house payment over time. Di state also introduce […]

todayAugust 26, 2026 10

Politics

Amaechi Say E Pay Pregnant Women N10,000 for Antenatal

By: Mariam Ajayi ADC presidential running mate, Rotimi Amaechi, don reveal say as Rivers State gorfnor, hin dey give pregnant women N10,000 each for antenatal care to help reduce maternal and child deaths. Amaechi make dis disclosure while explaining say Rivers State rank second for maternal-child mortality during hin time as governor from 2007 to 2015. hin say di payment na part of measures wey hin administration introduce to encourage pregnant women to attend antenatal care and improve maternal health. […]

todayAugust 26, 2026 13

Sports

Tottenham Use £60m Take Sign Omar Marmoush on Loan

BY: Blessing Aminu Tottenham Hotspur don agree loan deal to sign Manchester City forward Omar Marmoush, wit Spurs expect to make di move permanent for £60 million next summer. Di 27-year-old Egypt international join City from Eintracht Frankfurt for £59 million in January 2025, but e struggle to get regular playing time, wit Erling Haaland often ahead of am for di attack. Marmoush come as second-half substitute during City 3-0 Community Shield defeat to Arsenal, but e no play for […]

todayAugust 26, 2026 12

OBODO NAIJA

Umahi Blasts Benin-Asaba Road Company

By: Kofoworola Olayinka Di Federal Gornment don say e go check all di roads wey private company dey manage across di country, to make sure say dem dey do wetin dem promise and make things easier for Nigerians. Works Minister, David Umahi, tok dis yesterday when e visit Benin-Asaba road to see di situation by imself. E blame di company wey dey handle di road, BAECC, say dem no do di work well and dem don fail. Umahi say gornment […]

todayAugust 26, 2026 10

crime& security

Oyo Police Arrest Two Suspects Over Stolen Exotic Vehicles

By: Kofoworola Olayinka Oyo State Police don arrest two suspects, Adewale Abiola and Kabiru Abobarin, over alleged trafficking of stolen exotic vehicles across Nigeria borders. Police say di suspects dey move di stolen cars go other countries to sell dem. Operatives of di Violent Crime Response Unit, VCRU, arrest dem, according to police spokesperson, Olayinka Ayanlade, for statement on Wednesday.

todayAugust 26, 2026 10

OBODO NAIJA

VeryDarkMan Accuse Security Operatives Say Dem Be Di ‘Unknown Gunmen’

By: Mariam Ajayi Social media critic, Martins Vincent Otse, wey pipu know as VeryDarkMan, don accuse Nigerian security operatives of being behind di ‘unknown gunmen’ wey dey cause insecurity for di country. VeryDarkMan make di allegation on Tuesday while im dey talk for di 2026 NBA Annual General Conference for Port Harcourt, Rivers State. E claim say military, immigration and customs officers fit dey behind some of di attacks, despite di many security checkpoints across major roads.

todayAugust 26, 2026 12

OBODO NAIJA

How Oshiomhole Lead Protest When Obasanjo Comot Fuel Subsidy.

By: Mariam Ajayi Edo North Senator, Adams Oshiomhole, don recall how e organise residents for Ogun State to protest against fuel subsidy removal during former Presido Olusegun Obasanjo University of Lagos government. Oshiomhole make dis disclosure during national discourse wey The Companion organise for University of Lagos, as e say e fear say corruption fit swallow di money from di subsidy removal. E tok say at di time, e bin dey lead Nigeria Labour Congress, NLC, while Obasanjo dey serve […]

todayAugust 26, 2026 10

Politics

Makinde Pick Former DSS Oga As Im Running Mate For 2027

By: Kofoworola Olayinka Oyo State Govo and APM presidential candidate, Seyi Makinde, don pick former DSS Director-General, Lawal Daura, as im running mate for di 2027 presidential election. Makinde unveil Daura on Thursday during APM national convention for Bauchi, say e choose am to help tackle Nigeria security challenges. E also promise to lift millions of Nigerians out of poverty and work with like-minded politicians to build better Nigeria.

todayAugust 26, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds