Blog masonry

Background

National

Uzodimma Praise Security pipu As 20 Corps Members don Free

By: Kofoworola Olayinka Imo State Gofnor, Senator Hope Uzodimma, don clap hand for security pipu as dem sharparly  rescue di 20 corpers wey kidnappers carry for Onitsha-Owerri Road. Di gofnor say e happy say police, army and oda security pipu join hand make dem rescue di corps members safely. E praise dem for dia hard work and love for di country. Uzodimma also praise Oyo and Imo State Gornment for working together to make sure say all di 20 captives […]

todayOctober 8, 2026 10

OBODO NAIJA

20 NYSC Members Wey Kidnapers Carry Don Get Dia Freedom

By: Mariam Ajayi Twenty NYSC members wey kidnappers carry for Imo State don regain dia freedom after seven days for captivity. Police Force Public Relations Officer, CSP Anietie Iniedu, konfamate dia release on Wednesday, say dem rescue di victims safely. Police, Army, DSS and oda security agencies join hand for di rescue, as authorities don take di victims go hospital for medical check-up and treatment.

todayOctober 8, 2026 6

Lagos

ADC Candidate Clear Community NEPA Bill For Residents

By: Mariam Ajayi ADC candidate for Eti-Osa Constituency II, Ayodele Adio, don clear  NEPA bills wey pipo owe for one community wey no get light tey tey. Adio make di move during im visit with community leaders and NEPA officials on Wednesday, as residents celebrate when power return to di community. But residents later complain say light don go off again after one alleged instruction to NEPA to disconnect am, though e never clear who give di instruction, while Adio […]

todayOctober 8, 2026 10

obodo oyinbo

Japan Helep Yemen And Djibouti with $10m Emergency Funds

By: Mariam Ajayi Japan don become snior helpers fo middle east, dem don approve $10 million emergency aid for Yemen and Djibouti based on di war wey don scarra dis two both countries. According by di  Japanese embassy, Japan gornment approve di money on Tuesday. Yemen go get $8 million from World Food Programme, International Committee of di Red Cross and International Organization for Migration, while Djibouti go get $2 million through di UN refugee agency.

todayOctober 7, 2026 14

OBODO NAIJA

Umahi Comot Some Barriers For First Niger Bridge

By: Mariam Ajayi Works Minister, Dave Umahi, start to dey comot some concrete barriers wey dem put for First Niger Bridge to divide di narrow road into two lanes. Di barriers cause plenty kasala last week as road users and engineers say dem fit make traffic worse and make emergency movement hard for di bridge. Di Works Ministry bin say di barriers na to control traffic and stop reckless overtaking wey dey cause hold-up. Umahi don arrange space for U-turn […]

todayOctober 7, 2026 11

OBODO NAIJA

Donald Duke Say INEC Gats Assure Free And Fair 2027 Election

By: Mariam Ajayi Senior man, People Redemption Party, presidential candidate, Donald Duke, say fear dey di land for dis 2027 election mata, INEC gats convince Nigerians say di 2027 election go free and fair. Duke fire dis mata for news tok norbi small, say di way dem take run di 2023 presidential election don open Nigerians eyes waah for ground. Wey dem fire am question wetin change, di former Cross River State govo also press toks say im sef dey […]

todayOctober 7, 2026 8

Lagos

Passenger Kpai Inside Kenya Airways Plane Wey Dey Come Lagos

By: Mariam Ajayi One Kenya Airways plane wey bin dey come Lagos from Nairobi, say from no wia, person just kpeme for plane as hin near Lagos. Nobody sabi wetin kill di man. According by infomate wey di airline tok tok person, Michael Achimugu, bring out, di passenger just stop to respond about 20 minutes before di plane land and dem try first aid, kpokrikpor, di man don go, otilor. Di koko bi say up till now dem never sti […]

todayOctober 7, 2026 8

Sports

Messi End Argentina Career With Goal And Two Assists

By: Mariam Ajayi Lionel Messi don end im Argentina international career with one goal and two assists as Argentina beat Benin 3-0 for Buenos Aires on Tuesday night. Messi set up Nicolás Otamendi for Argentina first goal for 48th minute before e assist Nico Paz for di second goal for 61st minute. E later score penalty for 71st minute to complete Argentina 3-0 win over Benin. Di match na Messi final game for Argentina after 21 years of playing for […]

todayOctober 7, 2026 11

obodo oyinbo

Sudan Army Chief Swear To Fight RSF To Take Back Sudan Land

By: Mariam Ajayi Sudan army chief, Abdel Fattah al-Burhan, don swear say hin no go gree, da thin nor dey tok with RSF,  di ogbonge paramilitary group wey dey disturb sudan, say na force hin go take comot dem from sudan. Al-Burhan drop dis yans on Tuesday for Merowe, say, since di RSF pipo nor wan hear word,  na pure war, Idaboski doings,  be di only option to finish  paramilitary group. Dis strong warning come as di bloody fight wey […]

todayOctober 7, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds