Blog masonry

Background

National

Oyo Princes Drag Alaafin Owoade Go Court

By: Esther Ayoola Say Alaafin of Oyo, Oba Akeem Owoade, don dey chest court wahala wey some Oyo princes file against am. Di princes, Ladigbolu Adegboyega, Owoade Tesleem, Adeyemi Adesina, and Adeyemi Adebayo, dey ask court make stop Oba from some function wey im nor suppose attend. Dem sti tell court make e no dey act like say e dey below any other Oba for Yorubaland. Dem say, Alaafin office na very important one, wey get history for Nigeria, West […]

todayFebruary 10, 2026 3

National

Tinubu Boost Say Im Economy Reform Don Dey Show Beta Workings

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu tuk say di economic reforms wey im gornment bring don start to show beta result, as di country macro-economy dey stabilize small small and money wey federal dey share to states and local governments don increase. Im yarn dis one on Monday for Abuja, as e open di two-day National Economic Council conference. According to Di presido, sai Naija dey face plenty wahala like economic imbalance, bad infrastructure, unemployment, poverty, climate problem […]

todayFebruary 10, 2026 6

National

Appeal Court Back Senate, Say Suspension Of Natasha Dey Right

By: Esther Ayoola Court of Appeal for Abuja don tuk say Senate no do anything wrong when dem suspend Senator Natasha Akpoti-Uduaghan wey represent Kogi Central because of misconduct. Three judges wey sit for di case agree say her parliamentary privilege and constitutional rights nor spoil as Senate suspend am. But di court cancel di contempt case and di ₦5 million fine wey dem give her over di satirical apology wey she make to Senate President Godswill Akpabio. Justice Abba […]

todayFebruary 10, 2026 5

National

Former Councillor For Benue Explain How Jaguda Boys Kidnap Worshippers For Church

By: Esther Ayoola Former councillor wey represent Ukwuenyo Ward for Ado Local Government, Emmanuel Udah, Benue state don Konfamate jaguda boys doings for im state, say dem con kidnap some pipo for church on Monday. Untop yarnings with tori pipo, e describe di mata as planned attack against di church, say dem carry innocent worshippers while dem dey pray and no get anything to defend demself. Udah say pipo for di area don dey fear for dia lives, calling on […]

todayFebruary 10, 2026 6

obodo oyinbo

Nigerian Community For South Africa Protest For Anti-Drug Raid

By: Esther Ayoola Naija community for South Africa don dey ginger area dey protest say, security go kpai one Nigerian man, Emeka Uzor, during anti-drug operation for Gauteng, Johannesburg. Say, di shooting hapun around 3pm on February 8, 2026, for Carltex garage, Windsor East, Randburg. ActionSA Konfamate say Uzor, wey dem say dey involve for drug business, say dem shoot am during di operation wey include Ekurhuleni Mayoral Candidate, Cllr Xolani Khumalo. Say person kpai, nor concern dem and dat […]

todayFebruary 10, 2026 5

obodo oyinbo

South Africa Prepare To Recall Dia Soldiers From Congo UN Mission

By: Esther Ayoola South Africa say dem don wash hand comot DR Congo mata say dem dey remove  dia soldiers wey dey for UN peacekeeping mission for Democratic Republic of Congo (MONUSCO) afta almost 30 years. President Cyril Ramaphosa nai dey yarn dis one give  UN Secretary-General Antonio Guterres. U sabi say, South Africa na one of di top 10 countries wey dey give troops to MONUSCO, with over 700 soldiers. Oga Ramaphosa say, dem don too use South African […]

todayFebruary 10, 2026 6

obodo oyinbo

UN Beg World Pipo To Stop Di Killings For Sudan

By: Esther Ayoola UN human rights chief Volker Türk don beg di world make dem stop di killing and war crimes wey dey happen for Sudan. Di war between di national army and di Rapid Support Forces (RSF) don dey go for almost three years and no sign say e go stop anytime soon. Survivors tuk say RSF don kpai plenty pipo for El Fasher, some because of dia non-Arab ethnicity like di Zaghawa people. Di UN want make arms […]

todayFebruary 10, 2026 10

Sports

Chukwuebuka Enekwechi Finish Fifth For Madrid Shot Put

By: Esther Ayoola Olympic finalist Chukwuebuka Enekwechi, for men’s shot put, don muscles finish fifth for Madrid World Indoor Tour afta him throw 20.38 metres for men shot put. Di Naija record holder try wella as him compete with plenty world-class athletes wey dey throw pass 21 metres early for season. American Jordan Geist carry di first place, as e match him world lead with 22.04m. Jamaica man Rajindra Campbell come second with 21.94m, and American Roger Steen finish third […]

todayFebruary 10, 2026 8

Sports

Chelle Explain Wetin Sup Between Osimhen, Lookman For AFCON 2025

By: Esther Ayoola Super Eagles coach, Éric Chelle, don tok for di first time about wahala wey happen between Victor Osimhen and Ademola Lookman for 2025 AFCON. Di fight hapun during Nigeria Round of 16 match wey dem play against Mozambique. Chelle tuk for interview say, for di pitch, Victor tell Lookman say, Make im stop to dey play in front of goal, say na di gbege wey hapun be dat. Di Coachie say, Dem don settle di mata, and  […]

todayFebruary 10, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app