Blog masonry

Background

National

INEC Chairmo to Lead Big Tuk on Nigeria Election Mata for April 29

Chairmo of Independent National Electoral Commission, INEC, Prof Joash Amupitan,  say like dis  dey prepare body to deliver  keynote speech for one big stakeholders meeting wey go talk about Nigeria election process. Di programme dem title am, Law Corridor, one Abuja law firm, naim dey organise am and dat e go shelle  April 29, 2026 for Abuja. According to report,  say big men and women from political parties, civil society groups, plus local and international election observers go show face […]

todayApril 17, 2026 14

south west

Ogun Police, NDLEA Join Body to War Against Drug Abuse

Ogun Police Command don call for beta join-body work wit NDLEA to tackle drug abuse and trafficking for di state. Police tuk, tuk person, DSP Oluseyi Babaseyi,  naim dey konfamate dis mata, say Commissioner of Police, CP Bode Ojajuni, don even visit NDLEA office for Abeokuta for di collabo mata sef. Say dem agree to dey share intelligence, do joint operations, and also carry public awareness go communities. NDLEA also honour CP Ojajuni wit War Against Drug Abuse (WADA) ambassador […]

todayApril 17, 2026 13 1

OBODO NAIJA

Former Ondo State Govo, Mimiko Resign Officially from PDP

Former Ondo State Govo, Dr Olusegun Mimiko, don resign from Peoples Democratic Party (PDP) on April 10, 2026. E make di announcement through letter wey he write give PDP Ward 7 chairman for Ondo West Local Government Area, Ondo State, so na through official letter he take do am. Di Former govo tuk im reason, say di reason na to clear all speculations and questions wey people dey ask about im party membership status. Mimiko, wey rule Ondo State from […]

todayApril 17, 2026 11

Lagos

Lagos CP Fatai Tijani Beg Police Job Applicant to Round up Screening

Oga Commissioner of Police for Lagos State Command, Fatai Tijani, don dey ginger boys wey  apply for di 2025/2026 Police Constable Recruitment Screening, to sharpaly  finish dia screening before Saturday deadline. E yarn dis one on Thursday as e visit screening centre for Police College, Ikeja, where e go check how di exercise dey go and ensure say everything dey follow di rules. Say, di Commissioner also meet officials from Police Service Commission, Federal Character Commission, and Police Community Relations […]

todayApril 17, 2026 13

Sports

D’Tigress Enter Seed 2 for Women Basketball World Cup Draw

Nigeria women's national basketball team don land Seed 2 for 2026 FIBA Women's Basketball World Cup draw wey go happen for Berlin on April 21. Say like dis, dem fit jam strong teams like USA, Germany, France or Australia wey dey Seed 1. Other Seed 2 teams na China, Belgium and Spain, while Seed 3 get Japan, Puerto Rico, Italy and South Korea. Seed 4 include Turkey, Czech Republic, Mali and Hungary, as D’Tigress qualify after dem win dia fifth […]

todayApril 17, 2026 10

Sports

AFN Presido, Tonobok Open Door for Ofili Return After Switch to Turkiye Jam Rock

AFN President Tonobok Okowa say like dis Favour Ofili still get chance to represent Nigeria after World Athletics reject her move to switch nationality to Turkey. Di decision hapun for World Athletics headquarters when dem review di application wey Turkey Athletics Federation submit, and dem finally turn am down for 2026 after checking all the details. Ofili bin apply for di switch around May 2025 because she no dey satisfied with how Nigerian athletics officials dey manage her career, naim […]

todayApril 17, 2026 13

Sports

Sporting Lagos Climb Back to NPFL After Late 1-0 Win Over Osun United

Sporting Lagos don secure dia return to Nigeria Premier Football League (NPFL) after dem beat Osun United 1-0 for Ileogbo, Osun State. Na Alex Leme score di only goal, while goalkeeper Clinton Lawal make serious key saves wey help dem hold di win. Dem finish top for NNL Conference B with 36 points, just one point ahead of Akwa United wey get 35 points. Na dat win make sure say Sporting Lagos nor allow Akwa United carry di promotion ticket […]

todayApril 17, 2026 45 1

obodo oyinbo

Armed Robbers Strike Naples Bank, Hold 25 Hostage for 2 Hours

Say Three masked armed robbers enter a Credit Agricole bank for Naples, Italy on Thursday rob wetin nor good for dia. According to a police source, dem carry out the robbery for safe deposit boxes. Say di robbers, take about 25 customers and staff hostage inside the bank, as dem force control person  to search for money and valuables. According to Naples Prefect Michele di Bari, di robbers later escape through a tunnel wey lead to a  sewer system, and […]

todayApril 17, 2026 12

obodo oyinbo

Lebanon Ceasefire Start officially as US, Iran prepare for Peace Deal

Lebanon dey celebrate today Friday say, US State Department don  announce 10-day ceasefire wey go allow Israel and Lebanon officials sit down negotiate permanent peace and security agreement. Di US Presido, Donald Trump  also tuk say, di deal to end di war with Iran dey very close, and say negotiations fit resume this weekend. Iran Foreign Ministry, according to Iranian state media, don also konfamate di update, welcoming di ceasefire for Lebanon, and dat e go help ease di tension […]

todayApril 17, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds