Blog masonry

Background

Sports

Super Falcon Lose World Cup Ticket To South Africa

By: Kofoworola Olayinka Super Falcon don lose 2-1 to South Africa on Thursday for WAFCON play-off in Morocco, ending Nigeria hope of reaching 2027 Women’s World Cup. Nigeria had already miss qualification after dem lose to Cameroon for quarter-final on Sunday. Di defeat also end Falcon record of reaching at least semi-final for every WAFCON. The loss mean Nigeria go miss the Women’s World Cup for di first time since di tournament start for 1991.

todayAugust 14, 2026 27

Local

Edo Record Over 70 Child Abuse Cases, Fathers Top List

By Kofoworola Olayinka Edo State Gornment say over 70 child abuse cases don happen between January and July 2026, with fathers responsible for more than half. Women Affairs Commissioner Eugenia Abdallah yarn this on Thursday during press conference for Benin City. She say di pipu include children between two and 10 years, while one 14-year-old girl wey her father allegedly abuse dey eight months pregnant. Abdallah say government dey keep some victims under protection and cases wey dem report dey […]

todayAugust 14, 2026 19

south west

Customs Seize N3.57bn Smuggled Goods For Ogun

By: Kofoworola Olayinka Nigeria Custom don seize cannabis, foreign rice and other ban goods wey worth N3.57 billion for Ogun State. Acting Area Controller Oladapo Afeni announce di item wey dem seize on Thursday for Idiroko. Di item include 6,035 parcel of cannabis, 2,339 bag of foreign rice and over 13,000 litre of petroleum product. Custom say dem seize di goods between June 24 and August 13 as part of stepped-up fight against sneaking goods enter or comot country illegal […]

todayAugust 14, 2026 19 1

Sports

Super Falcons Falll Hand Miss World Cup 2027

By: Yusuf Abuh Super Falcons don finally fall hand oh lose 2-1 to South Africa for WAFCON play-off match for Morocco, and dem go miss di 2027 Women’s World Cup for Brazil. Di defeat mean say Nigeria, wey don play for every Women’s World Cup since di tournament start, go miss di competition for di first time. Thembi Kgatlana and Refiloe Jane score naim for South Africa before Christy Ucheibe pull one goal back for Nigeria through penalty for added […]

todayAugust 14, 2026 23

obodo oyinbo

Iran Drag Trump Say Na Dem Dey Control Hormuz

By: Yusuf Abuh Iran military don reject US Presido Donald Trump claim, wey say na America dey control Strait of Hormuz, dat Trump mouth dey smell, say na Iran dey control di waterway. Iran military tuk, tuk, Ebrahim Zolfaghari, say if na tru say na US dey control di Strait of Hormuz, why e be say no commercial ship or tanker fit pass through di strait without permission and supervision from Iranian armed forces, Oh. And Trump bin dey rake […]

todayAugust 14, 2026 21

OBODO NAIJA

President Tinubu Rake Say Fuel Subsidy Removal Dey Show Workings

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu don rake again say removal of fuel subsidy dey benefit ordinary Nigerians, dat very soon im soon share di report card. Senior man presido fry dis mata as im receive Naija oil workers oganization, NUPENG leaders for Presidential Villa. Baba Seyi say, im nor understand why bad belle pipo dey drag about subsidy, say na di subidy money dem take dey package di common man for local level. Im sti shake everywia […]

todayAugust 14, 2026 15

Lagos

Lagos Residence Give Lamentation How Pipo Take Dey Spoil Lagos

By: Yusuf Abuh Report wey dey reach our left ear say, some pipo wey get coconut head sti dey throway dirty for Agege railway corridor, Lagos, and dat na so di place dey smell, even after gorment warning. Dis na according one local official Oyeniran Prince, say, na so pipo park park dirty for di place for almost two years. Residents dey worry say di dirty environment fit cause disease and pollution, and dat fit scata di railway last last. […]

todayAugust 14, 2026 15

Sports

Motsepe Say Election Go Decide Infantino Fate

By: Olabisi Olatunji CAF boss Patrice Motsepe say na election suppose decide Gianni Infantino fate as FIFA president, as Ireland don join countries wey withdraw dia support for am. Infantino dey under serious pressure after e face backlash over plan to sell part of World Cup ownership to private investors. UEFA, CONCACAF and AFC don also turn against am, accusing am of breaking di trust wey football bodies put for im hands. Reports say dem want Infantino to comot before […]

todayAugust 13, 2026 30 1

obodo oyinbo

Japan PM Reject Putin Visit To Disputed Kuril Islands

By: Olabisi Olatunji Japan Prime Minister Sanae Takaichi don reject Russian President Vladimir Putin visit to disputed Kuril Islands, calling di move “absolutely unacceptable”. Russian state media report say Putin visit Iturup Island, wey Japan dey call Etorofu, on Thursday, one of four islands wey Russia and Japan dey claim. Takaichi say di visit dey hurt Japanese people feelings and no agree with Japan position on di Northern Territories, while Foreign Minister Toshimitsu Motegi say di islands na Japanese territory. […]

todayAugust 13, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds