Blog masonry

Background

Lagos

Ogun Police Arrest 3 Suspects, Recover Local Gun, Charms

By: Esther Ayoola Ogun State Police Command say dem don do small jet li arrest three suspects for different operations for Mowe and Sagamu area, and dem recover local gun, cartridges and charms wey dem believe say dey linked to cult and crime activities. According to police tuk tuk, Oluseyi Babaseyi, statement on Sunday, dem carry out di arrest between April 14 and 18, 2026 through intelligence work and stop-and-search. Say For Mowe side, police act on information say one […]

todayApril 20, 2026 7

Lagos

Lagos Prepare To Gather Big Men, Kings, Soyinka For Ogbonge Art Exhibition

By: Esther Ayoola Say like dis lagos State dey prepare to host one big art exhibition wey dem call “Gregorian Art Exhibition” to honour legendary artist Bruce Onobrakpeya. Organisers wey be St. Gregory’s College Old Boys Association put for news statement, say di event go bring top dignitaries, traditional rulers and art lovers come together to celebrate am. Dem also tuk say Nobel laureate Wole Soyinka, Obi of Onitsha Nnaemeka Alfred Achebe, and ex-Ogun governor Gbenga Daniel go attend di […]

todayApril 20, 2026 12

Lagos

How Lexus Jeep Askident Kpai Hawker For Okokomaiko, Lagos

By: Esther Ayoola Road accident wey hapun for Okokomaiko area for Lagos State don go kpai one roadside hawker. According to Statement on Sunday by LASTMA tuk, tuk, Adebayo Taofiq, e tuk say di victim, wey be adult man, kpai for di spot. E explain say di crash involve one Lexus Jeep wey hit di hawker for road. Taofiq sti tuk say LASTMA officers quickly respond to di distress call, secure di scene and don evacuate di body from di […]

todayApril 20, 2026 11

Lagos

Lagos Launch Cybersecurity Rules To Protect People And Businesses

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don bring new cybersecurity guidelines wey go hellep improve digital safety for businesses, gornment offices and pipo wey dey Lagos. Commissioner for Information and Strategy, Gbenga Omotoso, tuk dis one for statement, say, di policy dey timely, as cyber risks dey increase for Naija every day. Say di framework go set protection rules and systems wey go help secure online activities as Lagos dey try become strong global digital tech place. He sti explain […]

todayApril 20, 2026 11

National

JAMB Boss Ishaq Oloyede Say UTME 2026 Dey go Smooth

Registrar for Joint Admissions and Matriculation Board, Ishaq Oloyede, don clear matas say di  ongoing Unified Tertiary Matriculation Examination waka well for most parts of Nigeria. He yarn dis one for University of Ibadan CBT centre during im monitoring visit for Oyo State. According to am, na only small wahala like light issue and minor technical faults naim dem see for about 16 centres out of di nearly 980 nationwide. He still add say dem don successfully conduct exam for […]

todayApril 18, 2026 22 1

Sports

Usyk Back Anthony Joshua to Beat Tyson Fury

Oleksandr Usyk don tip Anthony Joshua to beat Tyson Fury if dem finally enter ring for di long-awaited British heavyweight clash. Usyk, wey never lose fight and don face both boxers before, talk say im believe say Joshua get wetin e take to win di bout. Recently, Usyk dey train with Joshua for Spain as di former champion dey recover and prepare well after di car accident wey happen for December. According to am, Joshua dey show strong work rate […]

todayApril 18, 2026 16 2

National

Edun Explain How Tinubu Economic Reforms Dey Hold Ground

Say like dis wi oga Presido  Bola Tinubu economic reforms dey show workings. According to Finance Minister Wale Edun, di reforms strong wetin nor good, steady and fit carry Nigeria enter real growth instead of just survival. Edun tuk dis one for press briefing during World Bank and IMF Spring Meetings for Washington DC. Im say since mid-2023, di reforms really help stabilise di naija economy and make am strong against global economic shocks.

todayApril 18, 2026 16

National

JAMB Release 2026 Result for Dia Thursday April 16 Candidates

Joint Admissions and Matriculation Board don release result for candidates wey write 2026 Unified Tertiary Matriculation Examination on Thursday, April 16, as 632,788 results don dey ready to check. For statement wey dem release Friday, spokesperson Fabian Benjamin tuk say make candidates send “UTMERESULT” go 55019 or 66019 with the same number wey dem use register take check their score. JAMB talk say for now, na only to view result dey possible, as printing option never ready. Dem still warn […]

todayApril 18, 2026 25

Sports

Onyeka Carry Coventry Back To Premier League After 25 Years Wait

Super Eagles midfielder Frank Onyeka don helep Coventry City secure promotion enter Premier League, playing 1-1 draw with Blackburn Rovers. Say Coventry bin  just need one point for Ewood Park, and dem get am as Bobby Thomas score late equaliser for 84th minute to seal di return after 25 years. Onyeka play 62 minutes for the match, show solid performance for midfield before dem comot am put Victor Torp. The Nigerian complete 26 out of 32 passes, plus e still […]

todayApril 18, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds