Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

500-level Student Kpai For Football Field

One 500-level Building Technology student for Covenant University, Ogun State, Toluwase Jesutunmise, don kpai as im dey jim jim bodi for campus. For statement wey University Vice-Chancellor, Professor Timothy Anake release on Wednesday say di late student bin dey train before e comot, go rest afta e complain of leg pain and fatigue. Di VC add say few moments later, im teammates notice say e dey gasp for air, come rush am go di university medical centre wey dey opposite […]

todayApril 9, 2026 10

obodo oyinbo

Two Ships Pass Strait Of Hormuz After Cease Fire Deal

Say like dis, two ships don pass through di Strait of Hormuz since US and Iran do ceasefire deal overnight from Tuesday night go Wednesday. According to Marine Traffic for dia X page, dem say one Greek-owned bulk carrier NJ Earth cross di Strait by 08:44 UTC, while one Liberia-flagged Daytona Beach don pass earlier by 06:59 UTC, shortly after e depart from Bandar Abbas by 05:28 UTC. According to reports, dem estimate say around 800 ships don dey stuck […]

todayApril 9, 2026 14

Sports

Lookman Hail Atletico After Dem Beat Barcelona

Ademola Lookman don hail Atletico Madrid Champions League victory against Barcelona on Wednesday inside Camp nou. Lookman say na good result, especially as dem no concede any goal for there and im team show workings based on dia unity. On di other hand, Barca coachie, Hansi Flick yarn for post match interview say im team play well for first and second half even with less players. E sti add say dem go try and fight back, even though semi finals […]

todayApril 9, 2026 14

OBODO NAIJA

NASS Backs Bayo Ojulari, Tantita Security Services Nigeria Limited For Beta Oil Production

Lawmakers for National Assembly for one joint committee meeting on pipeline security tuk oh, say, dem dey fully support Bayo Ojulari and Tantita Security Services Nigeria Limited, say dia collabo dey bring beta result. Chairmo of House Committee on Petroleum, Ikenga Imo Ugochinyere, say no evidence dey against Tantita, and na why dem clear di company name after dem review all petitions. Dem explain say under Nigerian National Petroleum Company Limited, Ojulari dey give beta leadership while Tantita dey use […]

todayApril 9, 2026 10

OBODO NAIJA

CJN Kudirat Kekere-Ekun Blast ‘Cash-and-Carry’ Lawyers

Senior woman chief justice of Nigeria, Kudirat Kekere-Ekun don warn say dis “cash-and-carry” way wey some lawyers dey carry practice law now dey spoil di image of di profession and fit damage justice system for Nigeria. She yarn dis one for 2026 NBA Legal Practice conference, say make lawyers wake up and return to correct ethical behavior wey go protect clients and di law. Kudirat still use di opportunate  tuk say even though lawyers deserve beta pay, dem nor suppose […]

todayApril 9, 2026 12

Sports

AFCON 2025 Wahala, Patrice Motsepe Promise To Follow Court Order

Caf Presido, Patrice Motsepe say like dis now Confederation of African Football go follow wetin Court of Arbitration for Sport go decide on di 2025 AFCON wahala. E yarn dis one for Senegal as dem go collect the trophy from Teranga Lions and give Morocco. CAF Appeal Committee tok say Morocco na im be di winners with 3-0 even though dem lose 1-0 for pitch, because Senegal players waka comot for match. Dis decision don cause serious gbege for Senegal, […]

todayApril 9, 2026 12

obodo oyinbo

Israel Fire Big Air Strike For Lebanon,182 Die, 890 Wound

Israel don fire plenty air strike for Lebanon, dem talk say na di biggest one so far. Dem target more than 100 Hezbollah place for 10 minutes. Lebanon health ministry talk say at least 182 people don die and 890 na im wound. For Beirut, pipo still dey find survivors from rubbles, while families dey mourn and pick wetin remain of dia life.

todayApril 9, 2026 11

National

Makinde, PDP Faction Waka Go See ADC For Abuja To Show Support

Oyo State Governor, Seyi Makinde, together with some members of di Turaki-led faction of di Peoples Democratic Party (PDP), don waka go see African Democratic Congress (ADC) leaders for Abuja. Makinde talk say di visit on Wednesday na to show support for ADC leadership and to discuss matter wey dey affect Nigeria democracy. According to Makinde, dem come through consultation and solidarity to help strengthen democratic process for Nigeria.

todayApril 9, 2026 12

Lagos

Governor  Sanwo-Olu Insists New Opebi-Ojota Bridge Go Cut Traffic For Lagos 

Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu, say like dis Lagosians suppose to dey dance kokoma, dat  new Opebi-Ojota Link Bridge go hellep reduce traffic wahala for residents. E yarn dis one on Wednesday during di commissioning of di bridge and other projects like di Bola Ahmed Tinubu Administrative Complex and Lagos State GIS. According to am, di bridge go make movement easier, reduce pressure for road, and improve how traffic go dey flow for Lagos.

todayApril 9, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds