Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Sam Amadi Knock APC Over Alleged Fake Catholic Statement

By: Esther Daniel Former NERC Chairman, Sam Amadi, on Wednesday call on APC through im X page make di party stop alleged forgery, say dem fit defend dia position without using fake documents. Amadi react after Catholic Youth Organisation of Nigeria (CYON) deny one statement wey circulate online, claim say e come from one group called Catholic Youth Association of Nigeria (CYAN). CYON describe di document as false, fraudulent and unauthorised, insist say CYAN no exist and di statement no […]

todayAugust 5, 2026 12

Sports

Super Falcons Fit Top Group C If Dem Beat Egypt

By: Esther Daniel Super Falcons go battle Egypt on Wednesday night for Rabat as dem chase victory and chance to finish top of Group C for 2026 Women Africa Cup of Nations. Nigeria need beat Egypt while Zambia defeat Malawi for all three teams to end di group stage with six points each. If dat happen, CAF tie-break rules go decide who go finish first and second for di group. Egypt don already crash out, while Nigeria still get strong […]

todayAugust 5, 2026 22

south west

Ooni Of Ife Donate ₦100 Million, Hilux To Sunday Igboho Security Group

By: Esther Daniel Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi, don donate ₦100 million and one brand-new Hilux vehicle to support Iru Ekun Security Network wey Sunday Igboho establish. Di donation happen on Tuesday during courtesy visit by Sunday Igboho and members of di security outfit to Ooni Palace for Ile-Ife. Palace announce di donation for statement wey come out on Wednesday through Director of Media and Public Affairs office. Di support na to strengthen di operations of di community-based security […]

todayAugust 5, 2026 23

Entertainment

Davido Say Nobody Fit Beat Am for Free and Fair Election

By: Esther Daniel Afrobeats star Davido tok during one livestream with content creator Carter Efe say nobody fit beat am for any free and fair election, but im no get plans to join politics now because e believe say Nigeria election process no straight forward. Di singer say im rather focus on im music career until elections for Nigeria become free, fair and transparent. Davido add say im no fit accept any election wey dem go manipulate results, insis say […]

todayAugust 5, 2026 19 3

Lagos

Senate Deny Say Dem Sponsor Bill Wey Go Fine People Wey Dey Preach For Bus

By: Esther  Daniel Di Senate don deny reports say Senate Leader Opeyemi Bamidele and spokesman Yemi Adaramodu sponsor di bill wey propose ₦50,000 fine for people wey preach, trade or hawk inside commercial buses. Yemi Adaramodu tok dis one during interview as public debate over di FRSC Amendment Bill 2026 continue. Di bill still retain di ₦50,000 fine after Senate pass am as part of plan to strengthen road safety enforcement. Many Nigerians, religious groups and civil society organisations don […]

todayAugust 5, 2026 19

National

FG Approve Plan To Give Hospitals 24-Hour Light

By: Esther Daniel Federal Gornment don approve new plan to give at least 30 percent of Nigeria health facilities steady 24-hour electricity before end of 2026. Health Minister of State, Dr Iziaq Salako, tok dis one after di Nigeria Power for Health Initiative meeting on Tuesday. Di committee approve new funding and governance plans plus shortlist eight private sector proposals for further engagement. Di move na to improve power supply for public hospitals through public-private partnership.

todayAugust 5, 2026 21

OBODO NAIJA

Federal Fire Service Raise Interest Free Loan to ₦500,000

By: Esther Daniel Federal Fire Service Controller-General, Olumode Adeyemi, on Tuesday announce for Wuse, Abuja, say di Service don increase interest-free loan for officers from ₦300,000 to ₦500,000 and launch Medical Intervention Scheme to improve staff welfare. Adeyemi tok say di welfare package go help reduce medical expenses and support officers and men across Nigeria. Im also reveal say instead of accepting one grand reception after e assume office, im use di money buy mattresses and other welfare items for […]

todayAugust 5, 2026 10

OBODO NAIJA

Abia Pass Law To Regulate House Rent

By: Esther Daniel Abia State House of Assembly don pass law to regulate house rent and protect both tenants and landlords for di state. Speaker Emmanuel Emeruwa preside as lawmakers Augustine Okezie and Mandela Obasi sponsor di bill. Di new law come after plenty complaints from tenants for Umuahia and Aba over high rent and house agents wey dey inflate prices. Lawmakers also pass another law to help courts handle criminal cases faster.

todayAugust 5, 2026 25

OBODO NAIJA

Senate Say State Police Bill Work No Go Stop

By: Esther Daniel Di Senate don assure Nigerians say work on State Police Bill no go stop despite National Assembly recess. Senate spokesman Yemi Adaramodu tok say committees still dey work to harmonise di bill with House of Representatives. According to am, di recess no go delay di constitutional amendment process. Di bill don get support from gofnors, state assemblies and oda stakeholders wey want better security.  

todayAugust 5, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds