Blog no sidebar

Background

National

PDP Turaki Faction Drag Police Go Court

By: Esther Ayoola One group of di Pipos Democratic Party wey Kabiru Turaki (SAN) dey lead, omo don vex oh, send SMS give wi Federal High Court for Abuja, say make court sharpaly order police to open PDP national secretariat and comot all barricade. Dem say police lock di secretariat since November afta small rakkies wey hapun between di Turaki group and  FCT Minister, Nyesom Wike group. Police intervene dat […]

todayDecember 22, 2025 11

National

FG Rescue 130 School Pikin Wey Gunmen Kidnap For Niger State

By: Esther Ayoola Wi Federal Government like commando wey dem be, don do commando rescue movement recue all di 130 school pikins wey jaguda boys kidnap from St. Mary’s Primary and Secondary School for Papiri, Niger State. Presidential tuktuk, Sunday Dare, ni dey confamate di matter on Sunday, say all di pikin don free and nobody remain for captivity. E post di update for im official X page with picture […]

todayDecember 22, 2025 7

Lagos

Lagos Gorment Charge Motorist N5.7m Say Im Spoil Solar Streetlight

By: Esther Ayoola Starting from Lagos, say nor be small yawa for area, dat Lagos State Gorment don clear mata, wetin make dem bill one motorist N5.7 million for allegedly damage one of di new solar streetlights. Di Lagos State Electrification Agency (LSEA) tuk say di driber S. Islamiyatus, ni use im Ford Motor, hit di streetlight wetin nor good, igboweii for Abeokuta Road last week. Say, as driber ma, […]

todayDecember 22, 2025 18

Lagos

Residents Drag Mata Say Why Isolo-NNPC Road Dey Take Time

By: Esther Ayoola Unto matas!  says motorists and commuters don dey vex say di Isolo-NNPC road construction too slow, dat di ogbolor dragging don make pass 19 month we dem suppose take finish am. Dis road wey no reach six kilometre, dem start to build am 39 months ago. Say na late president Buhari government approve dis road three years back. Residents dey, question dey beg authorities make dem do […]

todayDecember 19, 2025 19

National

Presido Tinubu Arrange Nepa Man Dr. Mulisiu Oseni As Nerc Chairmo

By: Rilwan Agbomeji Presido, Bola Ahmed Tinubu don appoint  ogbonge  nepa man Dr. Mulisiu Oseni, as new chairman of di Nigerian Electricity Regulatory Commission afta senate confirm di board members for abuja. Dis one mean say,  presido Tinubu don drop Abdullahi Ramat wey im nominate earlier to replace former Chairman, Sanusi Garba. According to presido tuk tuk persin, Bayo Onanuga, di move na to make sure say strong and effective […]

todayDecember 19, 2025 33

National

NNPC Run Emergency Marrs Afta Escravos–Lagos Gas Pipeline Explosion For Delta State

By: Esther Ayoola NNPC Limited omo comeout yarn marras dat say NGIC don start word afta one explosion hit part of Escravos–Lagos Pipeline System for Delta State. Dem say afta inspection, dem don isolate di affected pipeline sections and everywhere dey safe for host communities and environment. Joint team from NNPC, NMDPRA and maintenance contractors don visit di site make dem check wetin happen. NNPC add say dem dey communicate […]

todayDecember 19, 2025 25

foreign

EU Give Ukraine €90 Billion Loan Say Make Dem Use Am Guide Dia Economy

By: Rilwan Agbomeji Unto marras for di Ukraine war, say like dis, European union don join bodi arrange €90 billion loan for Ukraine say make dem use am take guide, as dia economy dey cry because of war blood. According to report, di Ukraine economy don worwor and that I worwor pass atutuporyoyo Di deal come afta plenty talks for brussels summit, wey Ukraine request more fund because of dia […]

todayDecember 19, 2025 6

National

Fuel Tanker Blow Auchi Road

By: Esther Ayoola Gobe burst for Auchi, Edo State, as one tanker wey explode kpai kpai pipo for di areas. According to police tuk tuk of Edo state, Eno Ikoedem, wey confamate di tori, na Wednesday around 6:30pm for evening na dis gbege sup. People dey ask, who dey involved, how e take happen, and how many pipo dem fit don jam. Once more detail come, u go get am […]

todayDecember 19, 2025 16

Sports

Junior D’tigress Naija Jump Nine Places For FIBA World Ranking

By: Rilwan Agbomeji Right now, na junior dey hot for basket ball , say dem climb nine places for di latest FIBA world ranking for girls, moving to 26 for world. Di ranking wey come out for Thursday, show say Naija na di fourth biggest movers as dem jump from 30 to 26. For Africa, Junior d’tigress dey for number three with 469.5 points, behind Mali wey dey 16th and […]

todayDecember 19, 2025 39

National

Oil Regulators Say Dem Wan Hawk Naija Crude Oil For Showglass

By: Esther Ayoola Hear mata, say di presidential nominees for Nigeria petroleum regulatory agencies don go promise wi senate, say dem go make sure local production become number one, di champion for Naija petrol mata, and say import go be only last option to cover supply gap. Based pressure wey dem face for dia screening for senate on Thursday, omo, dem nor know wen dem promise heaven and earth oh, […]

todayDecember 19, 2025 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds