Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

Tinubu Absent For Unga Don Raise Question

By: Ayobami Dada Presido Bola Tinubu no go attend di 81st UNGA for New York dis year, as Vice Presido Kashim Shettima go represent Naija. Hin absent go be the third time and some political opponents don dey use am to their advantage dey tok wetin no good untop the matta But Tinubu’s Senior Special Assistant on Foreign Affairs and Protocol, Ademola Osodi, wey appear untop television interview on sunday […]

todaySeptember 21, 2026 17

Lagos

Lagos Put Body For Patient Safety Untop Non-Communicable Disease

By: Ayobami Dada Lagos Gornment don renew promise to make treatment safer for people wey get non-communicable diseases, as experts dey call for stronger regulation and better healthcare system. Special Adviser to Gofnor on Health, Dr Kemi Ogunyemi, tok say people wey dey live with NCDs need safe, effective and consistent care throughout dia lifetime, adding say patient safety must dey inside every stage of healthcare delivery. Other health stakeholders, […]

todaySeptember 21, 2026 14

Health

Erectile Dysfunction: Why Some Gbola No Dey Stand?

By: Jolayemi Olajide  For many men, di entire wahala dey start with one embarrassing night. Di mind dey ready for action, body dey hot, but di machine go just sleep flat like bicycle tyre wey leak. When dis kind format come dey repeat back to back, shame and di fear say boys go yeye am go make di man go hide inside silence. Dis na wetin plenty men dey face […]

todaySeptember 18, 2026 52 4

Sports

Chelle Drag Osimhen Wey Get Wunjury Enter Team List For 2027 AFCON Qualifiers

Super Eagles Oga Coach Éric Chelle don shock football fans as e drag injured Victor Osimhen join team list for 2027 AFCON qualifiers, now pipo dey wonderment wetin im e wan carry am do abi na hin mask e wan use take threaten opponent. Di Galatasaray goal-machine dey suffer waist-groin pain, lack of doing, but Chelle say make e still come face Madagascar for Uyo on September 25 and Guinea-Bissau […]

todaySeptember 18, 2026 18

obodo oyinbo

Iran Army Boys Strike Oil Tanker For Strait Of Hormuz

Iran Revolutionary Guard boys announce on Friday say dem shoot one oil tanker inside Strait of Hormuz after di ship try pass without paying dem money. British maritime agency konfamate say explosive hit di vessel on Friday before di crew quench di fire. Di military boys declare say dem attack di ship because e try illegal passage through di route.   Read more tori for here:https://konfamfm.com/iran-guards-say-dem-attack-oil-tanker-for-strait-of-hormuz/

todaySeptember 18, 2026 18

OBODO NAIJA

Wear APC Cap Or Commot Park – Esan West LGA Boss Tok

E don red yo, Okpebolo promise, na di pipo dey hear am, like dis na Esan West LGA Chairmo, Oga Blessing Ebhodaghe don order transport drivers for Edo State, say dem gat wear APC caps, cause any kpoko, di person go chop fine. Ebhodaghe give dis order on Thursday for motor park to hellep baba Govo, Monday Okpebholo, gather 2.5 million votes give Presido, Bola Tinubu for 2027 election. Di […]

todaySeptember 18, 2026 13

Lagos

Jaguda Boys Attack Woman SUV For Festac

Nor be small tin for FESTAC, Over 20 jaguda boys gather on top one woman SUV inside Festac Town on Thursday after one okada rider crash enter her car. Eyewitnesses stand look like film until one good Samaritan run go call police make dem come chase dem away. As by di time wi package dis report, lagos police command never fry mouth, so di full gist never come out.

todaySeptember 18, 2026 14

Sports

Must Read: Di Reason Why Man United Comot For Carabao Cup

First Half As we enter di 10th minutes for Manchester United Carabao Cup match against Brighton, everything dey shine shine for United as Young winger,  Shea Lacey tear net with debut goal. Mason Mount follow am two minutes later with better volley wey bounce for ground before e touch net, and united dey lead 2-0, Old Trafford dey shake, and di night dey look like another step forward for Michael […]

todaySeptember 18, 2026 22

Politics

Atiku: High Food, Fuel Price Dey Make Life Hard for Families

By: Kofoworola Olayinka Former Vice-Presido Atiku Abubakar say high food, fuel and transport prices dey make am hard for plenty Naija families to afford good food, as he talk on Naija cost-of-living palava. Atiku say rising cases of child malnutrition na one of di major signs say many families dey struggle with di high cost of living across Naija. Di former Vice-Presido make di statement as food, fuel and transport […]

todaySeptember 18, 2026 21

obodo oyinbo

Iran Guards Say Dem Attack Oil Tanker for Strait of Hormuz

By: Kofoworola Olayinka Iran Revolutionary Guards don tok say dem strike one oil tanker for Strait of Hormuz on Friday, according to Iranian state news agency IRNA. One British maritime agency too report say attack happun. Iran still dey control movement for the strategic Strait of Hormuz as United States continue to put pressure on Iranian ports during the ongoing Middle East war. The Islamic Republic say e want make […]

todaySeptember 18, 2026 13 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds