Blog no sidebar

Background

Uncategorized

Rudi Garcia Vow To Shock Spain For World Cup Quarter-Final!

By : Jolayemi Olajide Belgium coach Rudi Garcia yarn for Los Angeles on Thursday say dem dey ready to shock Spain for dis Friday quarter-final game. Him talk say dem get full belief to win because dem come ready to give Spain heavy vawulence despite wetin people dey think. The team show say dem dey standard after dem wire USA 4-1 during the round-of-16 stage to qualify for dis level. […]

todayJuly 10, 2026 6

OBODO NAIJA

How Naija Gofnors Take Fry Mouth On Di Creation of State Police Mata

By: Yusuf Abuh On Thursday for Abuja, governors, lawmakers, security experts, and gornment officials meet to discuss state police reform for Nigeria. Supporters say state police go help fight kidnapping, terrorism, banditry, and other crimes by improving security for communities. di meeting hapun after wi oga Presido, Tinubu set up a committee to create rules for di new policing system. Di law go allow states to get dia own police […]

todayJuly 10, 2026 6

obodo oyinbo

US And Iran Ready For Heavy Face-Off Over World Main Oil Route

By: Yusuf Abuh One expert don reveal say di Strait of Hormuz don officially turn di main card of conflict where di United States and Iran dey show power. Di Founding Director of di Arab Perspectives Institute, Zeidon Alkinani, talk dis one during his analysis on how Iran dey drag for more control over di water block wey one-fifth of world oil dey pass before war start. Alkinani explain say […]

todayJuly 10, 2026 5

Lagos

How Heavy Lagos Traffic Trap Drivers for Oshodi-Apapa Express

Nor be small tin sup for popular Oshodi-Apapa Expressway completely, say traffic show commuters and motorists beta shegge yesterday. According to aproko pipo say na di Nigerian Ports Authority (NPA), nor too coordinate tin naim cause di jogolo. Di whole expressway block after container trucks and fuel tankers line up anyhow to enter di nation’s busiest seaports and depots without any orderly arrangement.

todayJuly 10, 2026 10

Lagos

DRIVER LAND FOR IKOYI PRISON

One 40-year-old korope driver, Kabiru Olajide, don land imself for Ikoyi Correctional Centre. Di Police drag Kabiru go court on top five-count charge because im allegedly stab one bar owner, Chimezie Okpoechi, and his wife, Kate Okpoechi, inside Ibeju-Lekki area. Dis bloody fight hapun on May 10, 2026, inside one bar for Oribanwa Phase 2 after a serious argument burst out because of one unpaid seventy-five thousand Naira drinks bill

todayJuly 10, 2026 8

Sports

France Beat Morocco 2-0

By: Yusuf Abuh France don qualify for 2026 FIFA World Cup semi-final after dem beat Morocco 2-0 for quarter-final match wey happen for Foxborough, Massachusetts. Kylian Mbappé open score for 60th minute before Ousmane Dembélé add another goal six minutes later to seal di win for Les Bleus. Mbappé score di opening goal even after Morocco goalkeeper save im penalty for first half. Di result don end Morocco impressive World […]

todayJuly 10, 2026 13 7

obodo oyinbo

China Residents Begin Cleanup After Deadly Flood

By: Yusuf Abuh At least 39 people naim don die while nine others still dey miss after one serious flood hit Guangxi region for southern China, as rescue and cleanup work still dey go on like dis. Authorities tok say 26 of di deaths hapun after Liulan Reservoir break, while seven people still dey missing for dat area. According to report  plenty rescue vehicles and security personnel enter Liulan village […]

todayJuly 10, 2026 11 1

OBODO NAIJA

Tinubu Meet Security Senior Mehn For Aso Rock

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu dey complain oh, in fact im do closed-door meeting with top security chiefs for Aso Rock Villa, Abuja, to check how security mata be for di country. According to report Di meeting focus on fight against terrorism, banditry, kidnapping and oda security wahala wey still dey worry Nigerians. National Security Adviser Nuhu Ribadu, Defence Minister Mohammed Badaru, top military commanders, DSS, NIA […]

todayJuly 10, 2026 12

south west

Ogun Police Rescue Abducted Prince, Kill Two Kidnappers

By: Yusuf Abuh Ogun State Police Command don rescue Prince Idris, one prince from Okun Owa for Odogbolu Local Government, after kidnappers jaguda go carry am comot from im house on June 30. According to police tuk, tuk person, DSP Oluseyi Babaseyi,  wey konfam dis mata, dem put serious pressure on di kidnapping gang before intelligence operation lead to di killing of two kidnappers. During di operation, police recover one […]

todayJuly 10, 2026 10

OBODO NAIJA

Fifth Batch Of Nigerians Return From South Africa

By: Yusuf Abuh Federal Government don bring back another batch of Nigerians from South Africa as fifth evacuation flight land for Lagos on Thursday evening. Air Peace carry more dan 180 Nigerians come back after one technical problem stop di plane from flying as earlier planned. Di latest returnees, mean say about 1,000 Nigerians don now return home since di xenophobic attacks start for South Africa. Government say evacuation exercise […]

todayJuly 10, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds