Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

We Don Handle Election Problems Before Election Day

By: Mariam Ajayi INEC Chairman tok say any administrative or field palava wey show before election day, di Commission don already tackle am from di beginning. E make di statement as e dey explain how INEC prepare to make sure say di election process run smoothly. According to am, di Commission no wait make di problems become bigger before dem take action.

todaySeptember 21, 2026 21

obodo oyinbo

Trump Threatens Iran Say Economy Fit Destroy

By: Mariam Ajayi US Presido Donald Trump don warn Iran say if dem no reach agreement with America, e fitĀ  wipe Iran out or make dia economy rot. Trump give di warning during Fox News interview on Sunday, as tension dey rise ahead of United Nations General Assembly for New York dis week. Meanwhider, Iran military don warn say any fresh US attack go bring painful retaliation across Middle East, […]

todaySeptember 21, 2026 22

Sports

Valverde Injure After Madrid Derby Loss

By: Mariam Ajayi Real Madrid don suffer serious blow after dem lose 2-1 to AtlƩtico Madrid for LaLiga on Sunday. Di club confirm say dia captain, Fede Valverde, injure im ankle after AtlƩtico player Kang-In Lee tackle am hard during di match. Referee no give any punishment for di tackle, as Valverde injury now add to Real Madrid worries after di derby defeat.

todaySeptember 21, 2026 17

OBODO NAIJA

Naija Go Put National Interest First for UN Meeting

By: Mariam Ajayi Vice PresidoĀ  Kashim Shettima don reach New York to represent Presido Bola Tinubu and lead Naija delegation for di 81st United Nations General Assembly. Shettima say Naija go follow dia national interest and support multilateralism as e dey meet world leaders for di UN meeting. E also say Naija go push for reforms wey go make global institutions more fair, representative and responsive to today economic and […]

todaySeptember 21, 2026 13

OBODO NAIJA

JTF Rescue 23 Kidnap Victims, Kram 4 for Sokoto

By: Mariam Ajayi Joint Task Force troops North-West troops don rescue 23 kidnap victims and arrest four Lakurawa suspects for Sokoto. Di operation wey happun on Sunday, also stop terrorist attacks for Wurno, Sabon Birni and Isa Local Government Areas. Media Information Officer of JTF North-West, Lt-Col. Aliyu Danja, tok say troops of Sector 2 respond quickly after terrorists attack Sabon Gari for Wurno LGA. According to am, di terrorists […]

todaySeptember 21, 2026 14

Local

Nonye Soludo Happy as Rehab Inmates Ready to Go Home

By: Mariam Ajayi Anambra First Lady, Nonye Soludo, don express happiness as some inmates for Rehabilitation Home for Nteje don recover and medically ready to return home. Soludo visit di home on Sunday, where she see inmates wey don learn different skills and dey show wetin dem sabi do. She also donate relief materials and cash to di inmates, saying rehabilitation suppose help dem regain confidence and fit contribute well […]

todaySeptember 21, 2026 17

OBODO NAIJA

Olawande Call for More Investment for Youth Health.

By: Kofoworola Olayinka Minister of Youth Development, Ayodele Olawande, don call for more investment in young pipu health, education, skills and economic empowerment to help dem contribute to society. Olawande, wey Permanent Secretary Dr Maryam Ismaila Keshinro represent, tok am for youth meeting wey SWAG Initiative organise for Abuja. Keshinro say youth development na serious investment, as young pipu still dey face health, nutrition, substance abuse and gender violence challenges. […]

todaySeptember 21, 2026 14

obodo oyinbo

US Don Send Over 25,000 Migrants Go Third Countries

By: Kofoworola Olayinka US gornment don deport at least 25,447 migrants go countries wey dem no get connection with, since Presido Donald Trump enter office for January 2025. Ā US don make secret agreements with 35 countries to receive migrants wey America no fit legally send back to dia own countries, with about $410 million set aside to support di deportation programme. About 20,000 of di migrants don go Mexico, while […]

todaySeptember 21, 2026 14

obodo oyinbo

Iran Guards Warn US Say Any Strike Go Bring New Attack

By: Kofoworola Olayinka Iran Revolutionary Guards don warn America say if US attack Iran, dem go respond by hitting new targets as tension between both countries continue to rise. Di Guards issue di warning on Monday, saying any US military strike against Iran go bring serious retaliation and make di situation for Middle East worse. Iran say dia forces ready to respond to any attack from America by targeting new […]

todaySeptember 21, 2026 17

obodo oyinbo

Rape Survivors Get Private Court Entrance, Fixed Trial Dates

By: Mariam Ajayi Rape survivors for England and Wales go soon get private court entrances and waiting rooms, as UK gornment bring new plan to reduce delays and improve treatment for victims. Under di new plan, every Crown Court for England and Wales go get at least one courtroom specially equipped to handle rape and serious sexual offence cases within di next two years. Gornment say di special courts go […]

todaySeptember 21, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds