Blog no sidebar

Background

National

Fayose Tell Fubara Make E Climb Down From High Horse

By: Esther Ayoola Former Ekiti State Governor, Ayo Fayose, on Tuesday advise Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, make e reconcile with Minister of FCT, Nyesom Wike, instead of dey engage in political confrontation. Fayose make dis statement during interview with media tuk tuk for Lagos. E explain say all di governors, including Fubara, get dia strength from other people, so humility dey important for leadership. Di former governor add say […]

todayJanuary 13, 2026 7

Lagos

FG Order Night Repair For Lagos–Ota–Abeokuta Road

By: Esther Ayoola Di Federal Government on Tuesday order immediate palliative repair work for Lagos–Ota–Abeokuta Road to fix serious damage and restore free traffic movement. Minister of Works, Dave Umahi, give di directive when e inspect di federal highway wey link Lagos State and Ogun State. Umahi explain say dem assess about 22 kilometres of di road, but repair work go focus on about 18 kilometres wey don bad well-well. […]

todayJanuary 13, 2026 5

foreign

French Far Right Politician, Marine Le Pen Face Court Appeal

By: Rilwan Agbomeji Marine Le Pen, wey be far-right French politician, say go nor appeal court decision wey ban her from public office for five years. U sabi say, dem find her guilty last year say she embezzle EU money, but she talk say she never do any wrong. If court hold di ban, she no go fit run for 2027 presidential election. Jordan Bardella, wey be her party president, […]

todayJanuary 13, 2026 3 3

National

Makinde Wire SMS To Oyo Residents Say Make Dem Watch Dia Back

By: Esther Ayoola Oyo State Govo, Seyi Makinde, once again don clear im state member, say make dem dey alert and security-conscious. Govo Makinde yarn dis on Monday wen e dey address public and civil servants during interfaith service wey dem hold for Ibadan to usher in di New Year. E press tuk say, im gorment go always do wetin e suppose do to protect lives and property.

todayJanuary 13, 2026 6 7

National

Bandits Kpai 5 For Otobi, Benue State

By: Esther Ayoola Nor be small thing oh, eehooo, say Bandits don kpai kpai pipo for Benue again oh, say  five pipo kpai for Otobi community, Otukpo LGA, Benue State. One of di people wey dem say die, na 2019 PDP House of Assembly candidate, Igbabe Ochi. According to report, di attack happen around 1:30am on Tuesday, after community volunteer guards do better commando scarra some jaguda boys wey wan […]

todayJanuary 13, 2026 5 1

Lagos

Lagos Council declare Seven-Day Mourning For Badagry King

By: Esther Ayoola Di Chairmo of Badagry Local Gornment, Babatunde Hunpe, on Tuesday don go declare, say dem go observe seven days of mourning for di late Akran of Badagry, Aholu Menu Toyi I, wey die on Monday, January 12. Hunpe make dis announcement for Badagry through im Chief Press Secretary, Kriko Augustine. Di govo of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu, approve di announcement as Akran join him ancestors peacefully afta […]

todayJanuary 13, 2026 3 3

National

Lagos APC Tell Obi Say Tinubu Dey Active For Governance

By: Esther Ayoola Di Lagos State chapter of di All Progressices Congress on Tuesday don tuk dia tuk, say, wi oga Presido, Bola Tinubu no dey miss and dat e dey active for him duties. Di comment follow question wey Peter Obi, Labour Party presidential candidate for 2023, raise about di president’s presence yesterday. APC spokesman, Seye Oladejo, tell newsmen for Lagos say Tinubu still dey fully involved for governance, […]

todayJanuary 13, 2026 4 6

Sports

CAF To Arrange Draw For 2027 AFCON Qualifiers

By: Esther Ayoola Di Confederation of African Football (CAF) go do draw for di preliminary round of di 2027 Africa Cup of Nations (AFCON) qualifiers on Tuesday evening, wey go officially start di journey to di tournament. CAF on Monday don release di official pots for di teams wey go play for di preliminary stage. Pot 1 get Lesotho, Burundi, Ethiopia, Eswatini, South Sudan and Mauritius. Pot 2 get Chad, […]

todayJanuary 13, 2026 9 3

Lagos

Okpebholo Address Marras On Di Shops Wey Jaguda Boys Burn For Ekpoma

By: Esther Ayoola Following di Badness wey sup for Ekpoma over di weekend, Edo State Govo, Senator Monday Okpebholo, on Tuesday don drop promise, say di state gorment go hellep rebuild di shops wey fire burn for Ekpoma Police Division, for Esan West Local Government Area. Okpebholo tuk dis one when e visit di police station to assess di damage to di shops wey Police Officers Wives Association build. According […]

todayJanuary 13, 2026 4

National

How Jaguda Boys Do Warling Film For Obajana Police HQ

By: Rilwan Agbomeji Say nor be small war start film play for Obajana Police Divisional Headquarters for Kogi State, dat jaguda boys enter di area and begin shoot wetin nor good kill one civil defence guide, but last last face and scata dem. Several security personnel and vigilante members sustained gunshot wunjor for di mata oh. Resident say di mata wey sup from Sunday to Monday night nor allow dem […]

todayJanuary 13, 2026 5 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app