Blog no sidebar

Background

obodo oyinbo

Zelensky Fire Trump, Tell Putin Make Hin Drop Gun For 60 Days

By: Mariam Ajayi Ukrainian Presido, Volodymyr Zelensky don drop hin mouth odour unto how dem go take end di war for Urkain, say US presdio  Donald Trump go tell Russia to  agree  60 days ceasefire. Dis one dey come after Trump cast everywia with hin mouth odoour on Saturday say Ukraine need new president wey go agree peace deal. Zelensky dey respond for  interview with ABC News on Sunday say, […]

todayOctober 12, 2026 10

OBODO NAIJA

Mama Remi Take Dey Beg Nigerians To give Tinubu Second Term

By: Mariam Ajayi Wi First Lady, Mama Oluremi Tinubu, Aka Iya alakara, like dis dey beg Nigerians say make dem support her hubbi, Presido Bola Tinubu for second term. She drop dis micro soft word on Sunday for Lafia, Nasarawa State, during rally wey North-Central Grassroots Mobilisation Network organise to gather support for Tinubu and Vice Presido Kashim Shettima. Senior mehn like, APC National Chairman, Nentawe Yilwatda, Imo State Govo, […]

todayOctober 12, 2026 7

Lagos

LASTMA Show As Dem Take Save 670 Pipo For Lagos Askidents

By: Mariam Ajayi Update for lagos, Senior mehn lagos traffic pipo don drop bomb, bring report card say  inside just nine months, na  1,409 road askident dem don witness con  save about  670 souls. Na number one tok tok person of traffic marras, Adebayo Taofiq, dey  yan dis on  Sunday. Hin say na every day di oga kpatakpata of traffic marras, Olalekan Bakare, dey shout, emergency team need to join […]

todayOctober 12, 2026 8

obodo oyinbo

Trump Send men to Meet Ukraine Leaders To End Russia War

By: Kofoworola Olayinka According to di latest update, US Presido,  Donald Trump mehn, mehn dey arrangr ground to meet Ukraine and Europe leaders for Miami today Friday to find how dem go take stop Russia war against Ukraine. Trump main man naim tie di mata for head like gele, Steve Witkoff, and im son-in-law, Jared Kushner, go bring new plans wey dem dey  hope say go help stop di war. […]

todayOctober 9, 2026 12

National

INEC Don Set Up AI Unit Ahead Of 2027 Election

By: Kofoworola Olayinka INEC don set up special unit wey go use Artificial Intelligence, AI, to help check election results and protect im computer systems before di 2027 general election. INEC Chairman, Professor Joash Amupitan, announce dis one for Abuja for meeting with stakeholders to mark 100 days to di first vote for di 2027 election. E say INEC wan put AI tools inside di system wey dem dey use […]

todayOctober 9, 2026 15

National

Lassa Fever Don Kpai 263 People For Nigeria

By: Kofoworola Olayinka Lassa fever don kpai 263 pipo and infect 1,115 others for 24 states for Naija, according to di Nigeria Centre for Disease Control and Prevention, NCDC. For di agency report wey cover September 14 to 20, 2026, NCDC say dem record 11 new cases, compared to 17 cases di week before. Di new cases come from Ondo, Edo and Taraba states, and 119 local gornment areas don […]

todayOctober 9, 2026 8

Lagos

Train Jam Car For Lagos, But Di Driver Escape Wunjure

By: Kofoworola Olayinka Ehwooo, make God shout for satan, na so devil one bin take di life of One 55-year-old driver, but hin  escape with  serious wunjure after train jam im Honda car for PWD railway crossing for Lagos. according by lagos traffic oga, Olalekan Bakare-Oki, Di train bin dey go Agege when di askident happen, and di car spoil wetin nor good. Beofr LASTMA officials and security men rescue […]

todayOctober 9, 2026 10

Sports

Eagles Coach Chelle scarra Say Young Boys to Enter Senior Team

By: Kofoworola Olayinka Super Eagles coachie Eric Chelle don go drop micro soft word dey shake everwia, jigijigi, say the young players wey play 3-3 draw with Russia get doings to play with di senior boys. U sabi say, Di coach use experimental squad wey get nine debutants, including three boys wey just be 19 years old play russia. Chelle explain say after how the boys take fight for Nizhny […]

todayOctober 9, 2026 10

Politics

FG tuk on how Tinubu reforms take reposition Naija economy

By: Kofoworola Olayinka Di Federal gornment don fire defence for wi oga Presido, Bola Tinubu, say hin economic reforms, like fuel subsidy removal, dey work wonders for di naija economy. Minister of Information, Mohammed Idris, and Finance Minister, Taiwo Oyedele, naim settle down fire dis mata wetin nor gud inside press conference wey dem do for Abuja. Dem explain say na di iron hand wey Tinubu take hold di naija […]

todayOctober 9, 2026 8

Lagos

Lagos Fire Service Records 1,324 Emergency Call In Nine Months

By: Kofoworola Olayinka Lagos State Fire and Rescue Service don record 1,324 emergency incidents between January and September 2026, including 1,135 fire calls, as di state gorment beg resident to take fire prevention serious during dry season. Di service Senior Public Affairs Officer, Fadairo Maria, yarn dis for di third-quarter activity report, wey show say di incidents include 79 rescue calls, 100 salvage operations, nine collapsed-building incident and one gas-related explosion. Di […]

todayOctober 9, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds