Blog no sidebar

Background

Lagos

LSHD1 Launch Training To Stop Pregnant Women And Pikin Deaths

By: Esther Ayoola Lagos State Health District One (LSHD1) don start one ogbonge hospital programme on Monday for Orile Agege General Hospital to bring quick response for pregnant women, to reduce maternal and neonatal deaths. Permanent Secretary of LSHD one, Dr Sola Pitan, clear tori pipo say di programme go make PHCs and secondary hospitals dey work together and hellep health workers sabi danger signs early. According to W.H.O report, […]

todayMarch 24, 2026 11

Lagos

Lagos Taskforce Gbab Five “Omotaku” Wey Dey Extort Motorists

By: Esther Ayoola Lagos State Taskforce don arrest five street boys wey dem dey call “Omotaku” for Aboru–Abule-Egba area of Abeokuta Expressway on Monday. Di suspects, wey include Alade Olarewaju, Oluwadamilare Alabi, Sunday Idowu, Rabiu Ibrahim, and Raji Yusuf, say dem catch dem, afta one motorist call di Taskforce say dem wan extort am. Chairmo of di Taskforce, CSP Adetayo Akerele, yarn for statement say dem bin dey even track […]

todayMarch 24, 2026 7

Lagos

APC Govos Gather For Lagos To Plan Next Convention

By: Esther Ayoola Say nor be small tin, dat Govos wey dey under All Progressives Congress gather demselves for Lagos on Monday oh, to strengthen unity and plan ahead for coming political activities. Di meeting wey happen for Victoria Island, say na part of effort to align leadership and prepare di party wella for future elections. Untop yarnings with tori pipo afta di meeting, Chairmo of APC Govos family meeting, […]

todayMarch 24, 2026 7

Lagos

Dangote Explain How Global Oil Wahala Fit Make Life Hard For Africa

By: Esther Ayoola Oga Presido of Dangote Group, Aliko Dangote, say global oil wahala fit make life hard for Africa if world pipo nor settle di mata fast, fast. Senoir man Dangote tuk dis tuk for meeting with wi oga presido, Bola Tinubu on Monday. Dangote warn say if oil price sti climb, pipo go suffer oh, like barbers, bakers, and those wey dey run generator, and gornments nor go […]

todayMarch 24, 2026 5

Lagos

Lagos Govo Sanwo-Olu Sign Mou For Digital Learning

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, say like dis now, dem don sign MoU with digital learning company, to bring digital learning to all gornment primary and secondary schools. Im yarn dis one for him verified X page on Monday. Say, di MoU go make sure say modern digital learning platforms and Korect infrastructure enter public schools. Sanwo-Olu sti tuk say, di partnership go hellep students sabi both […]

todayMarch 24, 2026 4

Sports

Nigeria Shock Ghana, Win By 136 Runs For Patricia Kambarami Cup

Nigeria carry better all-round play beat Ghana by 136 runs for di Patricia Kambarami Cup wey dey happen for Lagos. Naija captain Piety Luck and Victory Igbinedion na im wan finish Ghana, make 44 runs for three overs, while Christabel Chukwuonye carry di innings go reach 159 for four. For Ghana side, matter scatter as dem lose five wickets for only 13 runs early, never fit recover. Nigeria bowler Peace […]

todayMarch 23, 2026 8 2

Sports

NPFL Match Day 31: Katsina, Kano, Remo, Rangers Record Win

For Sunday matas, the NPFL nor dey slack at for match day 31  as top teams  fight for points. Katsina United FC beat Shooting Stars FC 1-0, while Kano Pillars FC show power with 2-0 win over Enyimba International FC. Remo Stars FC carry 3-1-win comot for Kwara United FC, and Enugu Rangers FC waka go 2-0 against El-Kanemi Warriors FC. Some games like Warri Wolves FC vs Bendel Insurance […]

todayMarch 23, 2026 7

Sports

Lookman Score Historic Goal, But Real Madrid Still Shock Atletico 3-2

Ademola Lookman don make history as e become first Nigerian wey score for Madrid derby, but e goal no sti hellep as 10-man Real Madrid turn game around to win 3-2 against Atletico Madrid for La Liga on Sunday. Lookman don score two goals dis season for im debut campaign in Spanish top flight. Di win give Real Madrid (69 points) reduce Barcelona (73 points) lead to just four points […]

todayMarch 23, 2026 4

Sports

Man City Beat Arsenal 2-0 To Carry League Cup

Manchester City don win dia first trophy for dis English season as Nico O’Reilly score two goals for di second half to hellep dem beat Arsenal 2-0 for di League Cup final. Arsenal wey be Premier League leaders come as favourites, but power pass favourite for Wembley stadium. Di first half no too get action, but O’Reilly first goal come after Arsenal goalkeeper Kepa Arrizabalaga fumble. Four minutes later, O’Reilly […]

todayMarch 23, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app