Blog no sidebar

Background

Sports

Saka Fire Arsenal To Victory As Gunners Knack Aston Villa 1-0

By: Mariam Ajayi Arsenal don continue dia flawless run for Premier League as dem knack Aston Villa 1-0 for Villa Park on Monday night. Na Bukayo Saka score di single goal for second half to give di Gunners full three points and keep dia clean-sheet record intact. Dis win na di perfect way for Mikel Arteta to celebrate hin 250th Premier League match as Arsenal gaffer. Arteta maintain di exact […]

todaySeptember 1, 2026 17 4

obodo oyinbo

Trump Drag Iran as War Vibe Rise High for Middle East

By: Mariam Ajayi US Presido Donald Trump don vex enter street, say e go reset Iran boys software  after dem fire missile attack US pipu for Jordan. Iran Guards brag say dem don shoot down American MQ-9 drone over Strait of Hormuz. Trump don warn Iran say even after dem don hammer dia money and military, dem fit still land one hot slap if Iran try test dem patience. As […]

todaySeptember 1, 2026 10

OBODO NAIJA

Tinubu Hails Soldiers, Local Hunters Over Kogi Rescue Mission

By: Mariam Ajayi Presido Tinubu don hail security operatives and local hunters wey rescue 21 kidnapped pipu, with 15 NYSC corpers, from kidnappers’ hideout for Kogi. Di team enter di forest for Ofu LGA and rescue eight men and 13 women. Di victims don dey hospital where dem dey receive treatment before dem go take them to dia family Tinubu say gorment no go stop until dem crush kidnappers and […]

todaySeptember 1, 2026 20

Lagos

Lagos Gorment press marras Against Gender-Based Violence

By:Mariam Ajayi Lagos State Government don raise serious alarm, say domestic violence for house don reach level wey everybody must put hand stop am immediately. Lagos Justice boss, Lawal Pedro, SAN, through Titilola Vivour-Adeniyi, don raise alarm over domestic and sexual violence for Lagos. Gorment reveal say Lagos don record over 33,000 domestic and sexual violence cases between September 2021 and July 2026. Di state gorment say e no go […]

todaySeptember 1, 2026 15 2

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty pipo. According to reports, 2Baba and Annie meet around 1999/2000 for Lagos wen dem start as padi. By 2004, Annie […]

todayAugust 31, 2026 23

OBODO NAIJA

Tinubu Tell North-Central Make Dem Join Body Fight Insecurity

By: Blessing Aminu Presido Bola Tinubu don call traditional rulers, religious leaders, youths, women and communities for North-Central make dem join body wit gorment and security agencies fight insecurity. Tinubu tok dis for 2026 North-Central Security Summit for Makurdi, Benue State. Di Presido, wey SGF George Akume represent, tell traditional and religious oga make dem dey alert security agencies anytime dem notice danger. E also beg Nigerians make dem share […]

todayAugust 31, 2026 17

OBODO NAIJA

Court Giv 55-Year-Old Woman Bail On Top Turkey Oil Marras

By: Blessing Aminu Chief Magistrate Court No. 1 for Gombe, wey Chief Magistrate Musa-Saleh Kilawa dey stay, don grant bail to one 55-year-old woman, Antine Amadu, wey dey face allegation say she receive stolen property. Amadu, wey dey stay for Dawaki Quarters, Gombe, show for court over allegation say she dishonestly collect one gallon of Turkey oil wey worth N60,000. Prosecution tell di court say di incident happen around 1am […]

todayAugust 31, 2026 21

Politics

IPOB Give Gorment Deadline Over Nnamdi Kanu Appeal

By: Kofoworola Olayinka IPOB don give gorment last warning over sme sme wey dey surround di hearing of Nnamdi Kanu appeal against im conviction. IPOB Directorate of State, DOS, Head, Mazi Chris Nwaogu, issue di last warning on Monday for video broadcast. Dis one come after Nnamdi Kanu family don raise alarm say dem dey delay to hear im appeal and ask make court list di matter immediately. Di family […]

todayAugust 31, 2026 15

Politics

Peter Obi Ask Why Tinubu Wan Hide Im Past Records

By: Kofoworola Olayinka NDC presidential candidate, Peter Obi, don question  Presido Bola Tinubu on why e dey ask foreign court make dem withhold records about im past. Obi raise di matter for statement wey e post for im official social media page on Monday. E say Nigerians deserve answers on matters wey concern public interest, especially issues around di Presido educational records. Obi say sitting Presido suppose get courage to […]

todayAugust 31, 2026 13

crime& security

Bandits Kill Two For Kano, APC Ward Leader Among Victims

By: Kofoworola Olayinka Bandits don reportedly kill two residents for Rantan community, Bebeji Local Gornment Area of Kano State. Di attack happen on Sunday night, when gunmen storm di community and open fire on residents. Residents reportedly run for safety as di attackers unleash terror for di area. One of di victims na Alhaji Garba Buba, wey be APC ward leader for Rantan community. Report say Garba Buba sustain gunshot […]

todayAugust 31, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds