Blog no sidebar

Background

Lagos

Lagos Gorment, Police Join Hand Give Free Eye Care to 1,000 Officers

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment and Zone 2 Police Command don join hand to tackle poor eye sight among police officers. Senoir Special Assistant to Ekiti State govo, on Public Health, Dr. Opeyemi Ogunsaki, na dey convasate dis one as dem dey do di eye check for Zone 2 Police Command Headquarters, Onikan, Lagos Island. Ogunsaki, say Govo Babajide Sanwo-Olu free eye care programme for security men na di […]

todayMarch 13, 2026 13

Lagos

Lagos Taskforce Deny Say Dem Nor Do Bribery And Corruption

By: Esther Ayoola Lagos State Environmental and Special Offences Taskforce say dem nor collect any bribe to release motor wey dem seize. Di agency tuk, tuk, Abdulraheem Gbadeyan, ni tuk dis on Thursday for Lagos, afta one online report accuse dem wrongly of bribery and corruption. Him explain say all dia operations dey follow law, and offenders dey charged to court if necessary. Gbadeyan also defend dia chairmo, CSP Adetayo […]

todayMarch 13, 2026 11

National

Seyi Makinde Disciples Call Wike Faction To Come Back To Di PDP

By: Esther Ayoola Seyi Makinde Disciples don dey beg members wey dey follow Minister Nyesom Wike an im caretaker committee make dem return back for Pipos Democratic Party leadership. Leader of di  disciples , Laja Adeoye,  ni dey drop dis one for interview for Lagos, say di party dey ready for  reconciliation. E call on Mohammed Abdurahman, Sen. Samuel Nwanyanwu and dia team make dem embrace peace, come join di […]

todayMarch 13, 2026 8

National

Ondo Gov Aiyedatiwa Call Court Ruling Premature

By: Esther Ayoola Ondo State Govo, Lucky Aiyedatiwa, don react to di Federal High Court judgement wey say im nor fit contest for governorship again, say na distraction. U sabi say, Aiyedatiwa take office 2024 afta im former boss Rotimi Akeredolu  kpai for office, before e con start another tenure on di 24th February 2025. E tuk dis one as im dey do guest for tv sit don tuk on […]

todayMarch 13, 2026 5

Entertainment

Broda Shaggy Land Hospital Afta Dem Shoot Am For Sango-Ota

By: Esther Ayoola Popular comedian and skit maker, Samuel Perry, AKA, Broda Shaggy, say im don land hospital afta dem reportedly shoot am for Sango-Ota, Ogun State. According to report, di thing hapun under Sango-Ota bridge. Police source wey tell tori pipo say, Broda Shaggy suffer di gunshot while e dey film comedy skit for di area. Dem rush am go Hospital for Alakuko, Lagos, an dat e dey receive […]

todayMarch 13, 2026 10 1

National

Nine Senators Dump Parties Join ADC, Shake Senate Politics

By: Esther Ayoola Nine senators from different political parties’ don dump dia old parties join African Democratic Congress (ADC), change Senate arrangement. Among di lawmakers wey defect, na Aminu Tambuwal (Sokoto South), Enyinnaya Abaribe (Abia South), and Binos Yaroe (Adamawa South). Others wey also move go ADC na Victor Umeh, Tony Nwoye, Lawal Usman, Ogoshi Onawo, Austin Akobundu and Ireti Kingibe. Say, na Senate Presido, Godswill Akpabio, read dia defection […]

todayMarch 13, 2026 3

National

Defence Minister Drop Updates, Say Di Fight Against Terrorist Continues

By: Esther Ayoola Defence Minister, Christopher Musa, don tell Nigerians to hold di calm, dat gornment dey really battle terrorism. Na afta security meeting wey President Bola Tinubu hold for Aso Rock with service chiefs and new Police IGP Tunji Disu, Musa take dey tuk dis one E say di meeting na to update oga presido on di security situation, especially afta di deadly attack for Ngoshe community for Borno […]

todayMarch 13, 2026 6

National

Former IGP Egbetokun Hand Over To Disu As New IGP

By: Esther Ayoola Former Inspector-General of Police, Kayode Egbetokun, don charge im successor, Olatunji Disu, make e carry Naija Police go higher level. Egbetokun tok dis one on Thursday during im pull-out parade wey hapun for Louis Edet House, Force Headquarters for Abuja. For im farewell speech, Egbetokun officially hand over leadership of di Force give Disu as di new IGP thank wella, wella.

todayMarch 13, 2026 5

National

FG Receive 371 Solar light From Gavi, UNICEF

By: Esther Ayoola Di Coordinating Minister of Health and Social Welfare, Prof Ali Pate, on Thursday for Abuja say di Global Vaccine Alliance and UNICEF don officially hand over Primary Health Cares Solarisation Project give wi Federal Gornment. According to am, di project wey di National Primary Health Care Development Agency organise say na to put solar light for 371 primary health centres across 17 states to hellep clinics. Pate […]

todayMarch 13, 2026 5

National

Police Commission Promote 13 CPs Go AIG Rank

By: Esther Ayoola Police Service Commission don approve promotion for 13 Commissioners of Police (CPs) go higher rank of Assistant Inspectors-General of Police (AIGs) afta dem pass written exam and interview for Abuja. Names of di promoted officers include Emmanuel Ado Christopher, Joseph Eribo, Dantawaye Miller, Uche Ifeanyi Henry and Olarenwaju Peter Ogunlowo among odas. For di same exercise, 17 Deputy Commissioners of Police (DCPs) sef don rise go Commissioners […]

todayMarch 13, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app