Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

 Atiku Salute Ngozi Okonjo-Iweala Based on Her Younger Brother Wey Kpai

By : Jolayemi Olajide Former Vice Presido, Atiku Abubakar don send im condolence message to di Director-General of di World Trade Organization (WTO), Dr. Ngozi Okonjo-Iweala, after her younger brother, Prince Ikechukwu Okonjo, kpai. Inside one post on top im X account on Monday, naim Atiku take salutate di former Nigeria finance minister and her entire family over di painful loss wey hit dem. Atiku describe di late Prince Ikechukwu […]

todayJune 8, 2026 12

Lagos

Protesters Storm Lagos Assembly Demand For Ajiran Community Leader

By : Jolayemi Olajide Some Lagos pipo storm State House of Assembly on Monday to protest because police lock up one Ajiran community leader, Hammed Tajudeen Akanbi. Di protesters march from Ikeja Shopping Mall go give di Speaker petition, as dem dey shout make gornment release di man. Dis rally hapun after Akanbi lawyers cry out say di court dey do partial for the mata, so fresh investigation must start. […]

todayJune 8, 2026 11

OBODO NAIJA

Senator Victor Umeh Tuk Why Lawmakers Dey Use Big Official Cars

By : Jolayemi Olajide Senator Victor Umeh wey dey represent Anambra Central don clear matas on why dem give National Assembly lawmakers big motors, say, dem need am to do dem legislative duties well. Umeh tuk dis tuk for one interview on Monday, say, pipo nor get any right to vex over the mata, sake of say di official motor na official work. When dem ask am if he collect […]

todayJune 8, 2026 14

Sport Yarns

Florentino Pérez Win Real Madrid Presidential election, Go Lead Till 2030

By : Jolayemi Olajide Florentino Pérez don collobi another win to rule Real Madrid  as dia presido  till 2030. For the election, he gather 21,741 votes (65%) while challenger Enrique Riquelme get 11,814 votes (35%). Na For  acceptance  victory speech, Pérez take clear every body im mind unto how e wan to move di club forward. Di  long-serving president say di election result show say, fans support im plan to […]

todayJune 8, 2026 10

obodo oyinbo

Heavy 7.8-Magnitude Earthquake Hit Philippines, Kpai 15 Pipo

By : Jolayemi Olajide Chai, heavy  problem for  southern Philippines on Monday, dat  one massive 7.8-magnitude earthquake shake the area. Dis na according to di United States Geological Survey, and USGS, wey konfam di mata, and  at least 15 pipo don kpai  near General Santos City. According to Philippine authorities, the earthquake hapun inside water for the southern part of the city. Based on dis,  Philippine gornment  don  order make  […]

todayJune 8, 2026 10

OBODO NAIJA

Delta Police Burst jaguda boys, gbab Four Suspects Across Bayelsa And Imo 

By : Jolayemi Olajide Delta State Police Command don arrest four suspected jaguda boys wey bin con show dem self with one Beretta pistol, na so  police sieze di gun, for Effurun, Uvwie Local Government Area, as part of investigation into illegal firearm movement. Police Commissioner CP Yemi Oyeniyi, naim knack dis mata for  news tuk, tuk on Monday. Oga Oyeniyi  say, na beta intelligence and beta touch lighting naim […]

todayJune 8, 2026 8

OBODO NAIJA

Oyo Gornment Bulldoze House Wey Jaguda boys take  Hide Adelabu Sister 

By : Jolayemi Olajide Oyo State Gornment don pull down di building wey kidnappers use hide Olaide Adegoke John-Paul, sister to former Power Minister Bayo Adelabu, and her twin pikins. Di demolition happen on Monday, less than two days after police rescue di woman and her pikin dem from di kidnappers. Gornment tok say dem discover say na for di building di criminals keep the victims during dia captivity. Authorities […]

todayJune 8, 2026 9

Lagos

Lagos Police command clear mata, Say e nor get any jaguda boy wey dey plan attack Schools

By: Jolayemi Olajide Lagos State Police Command don assure residents saydem mout oh unto di aproko of bandits attacking or kidnaping school children for di state, despite threatening notice wey circulate on Monday. Di Command, through Police Commissioner CP Tijani Fatai, immediately order security to mout di affected areas, schools and other important places. Oga commissioner dey insist say Lagos dey safe and any bandit, kidnapper or anybody wey wan […]

todayJune 8, 2026 10

OBODO NAIJA

Fg Pay Over 700 Billion Naira To Local Contractors To Boost Economy

By : Jolayemi Olajide Wi Federal gornment don konfamate say dem package 700 billion naira for local contractors, with 436.6 billion naira comot for inside May alone to clear old debts. Finance Ministry image-maker, Efe Ovuakporie, yarn for statement on Monday say over 1,240 contractors across different agencies benefit from di money. Di Minister of Finance, Taiwo Oyedele, naim sign di funds after dem do proper screening to make sure […]

todayJune 8, 2026 6 5

OBODO NAIJA

Akpabio Clear Nigerians Why Everybody Need To Fire Prayer

By : Jolayemi Olajide Nor be small tin, wi Senate Presido, Godswill Akpabio don tell Nigerians on Sunday, say wi need to fire payers oh, unto di way, wey pipo take dey lose for di country. Akpabio drop dis one for im abuja office, say, like im don start monthly prayer session to block kidnapping and killing, an im run same thin when im be Governor for Akwa Ibom State. […]

todayJune 8, 2026 12 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds