Blog sidebar

Background

Lagos

Lagos Govt Don Arrest 20 Street Beggars For Ketu, Mile 12

By: Rilwan Agbomeji Di Lagos State Government on Tuesday arrest 20 street beggars during enforcement for Ikosi Ketu and Mile 12 areas. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, talk say di operation na part of government plan to restore order and make sure public spaces dey used responsibly and safely. Wahab explain say KAI operatives carry out di latest enforcement around Ketu, Mile 12, Ikosi Road and di […]

todayDecember 2, 2025 23 2

Lagos

Lagos Govt Don Seal Yakoyo Abula Joint For Dirty Wastewater Dumping

By: Rilwan Agbomeji Di Lagos State Wastewater Management Office don seal Yakoyo Abula Joint Restaurant for Victoria Island because dem dey pour untreated wastewater and oil inside public drainage. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, reveal di action for im X handle. Dem shut down di restaurant on Tuesday morning afta officials see say dem dey deliberately discharge dirty water wey don block drainage and fit cause waterborne […]

todayDecember 2, 2025 11

south west

Adeleke Shock Pdp – Osun Governor Dump Party As National Wahala Burst Open!

By: Alice Iduh Osun state Govo Ademola Adeleke like dis dis  don pack im kaya comot from di peoples’ democratic party, PDP, say the wahala wey dey shake the party for national level don too much. According to aproko wey de go up an  down, di dancing govo package the mata for inside letter, November 4, 2025,  drop for him Ward, Sagba Abogunde, Ede North. Adeleke talk say e thank […]

todayDecember 2, 2025 11 2

foreign

UK PM Starmer – China Na Big Security Wahala, But Trade Still Dey

By: Rilwan Agbomeji UK PM Keir Starmer don yarn say China na gbege wahala for UK security, but im still talk say dem no fit chop Beijing belle, because money and business no dey play. Na for Monday night meeting im yarn am sharp, drag di old Conservative government say dem sidon sleep make UK–China mata turn complete yawa, with espionage gist dey scatter everywhere. Starmer remind everybody say since […]

todayDecember 2, 2025 6

National

Tinubu, Otti Dey Push For Kanu Release!

By: Alice Iduh Presdo Bola Tinubu don receive Abia Govo Dr. Alex Otti for presdo Villa, Abuja on Tuesday, but di agenda no clear for public yet. Sources yarn say di meeting fit get connection with effort to release IPOB leader Mazi Nnamdi Kanu, wey dem jail for Sokoto prison dey serve life sentence. Dia visit follow Governor Otti own recent waka go Sokoto meet Kanu, wey di matter dey […]

todayDecember 2, 2025 9

Sports

Salah Go Bounce Enter Egypt Camp Dec 15 – Slot

By Rilwan Agbomeji Liverpool oga Arne Slot don burst confirm say Mo Salah go waka comot Anfield go link up wit Egypt for AFCON on December 15. Slot drop di tori before Liverpool face Sunderland, yarn say na FIFA order say December 15 na di final day wey club must release players. Egypt sef no dey dull dia AFCON camp don open and dem get friendly match wit Nigeria on […]

todayDecember 2, 2025 8

National

Army Rescue 12 Kidnap Victims As Boko Haram Scatter For Borno!

By:Alice Iduh Troops of Operation HADIN KAI don rescue 12 kidnapped people 7 women and 5 pikin  wey Boko Haram carry when dem dey travel for Gwoza–Limankara Road on November 14. Army yarn say na for Mandara Mountains, Borno State, dem rescue dem on Sunday after dem run coordinated attack under Operation Desert Sanity IV and Diligent Search. Di soldiers, 26 Task Force Brigade with hunters, vigilantes, and Hybrid Forces, […]

todayDecember 2, 2025 13

Sports

Maresca Talk Say Palmer Ready To Jam Leeds

By: Rilwan Agbomeji Chelsea Oga, Enzo Maresca don open mouth say Cole Palmer dey fit and ready to jam Leeds United for Elland Road dis Wednesday wey dey come. Maresca yarn say Palmer dey try gain im full fitness back, but di plan na to push am small-small until e fit run full 90 minutes like before. Di coach add say everybody dey okay, but Romeo still dey recover and […]

todayDecember 2, 2025 5

National

Tinubu Pick Ex-Cds Musa As New Defence Minister After Badaru Quit

By: Alice Iduh Presdo Bola Tinubu don drop fresh nomination as e pick former Chief of Defence Staff, General Christopher Musa, to take over Defence Ministry after Mohammed Badaru step down on Monday. Na through letter wey presdo send give Senate Presdo Godswill Akpabio for Abuja, dem take announce di new pick and confirm say Musa na di man to run Defence waka next. General Musa,wey be 58 years old, […]

todayDecember 2, 2025 20 1

National

Bandits Don Waka Adamawa Community For Sokoto, Burn Houses and Shops

Bandits don bring dia werey come anoda attack for Adamawa community for Kalgo Ward, Sabon Birni LGA, Sokoto State, dem even burn three houses and one shop, dey waka waka dey put fear for pipo mind up and down. Di gbege burst yesterday night, but We thank God say dem no carry and kill anybody as dem dey do dia yeye operation. Among di house wey dem burn na dat […]

todayDecember 2, 2025 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app