Blog sidebar

Background

National

President Tinubu Order All Appointees Wey Wan Contest 2027 Election To Exit Im Gorment

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don order, say make all im political appointees wey wan run for any election for 2027 resign from dia work before March 31. Head of Information for OSGF, Dewan Goshit, naim announce dis news on Tuesday. Baba Seyi say, dis follow Section 88(1) of di Electoral Act 2026 and di INEC timetable for party primaries. Dis order dey affect all presidential […]

todayMarch 18, 2026 4

National

President Tinubu Land London For Historic State Visit

By; Esther Ayoola Oga Presido, Bola Tinubu, wey dey go do historic state visit, don land London, United Kingdom with im wife, Oluremi Tinubu. According to president tuk, tuk, Bayo Onanuga dem touch London Stansted Airport for 3:18 pm on Tuesday. Tinubu meet Mark Bevan, Deputy Lieutenant of Essex, plus Naija acting High Commissioner Ambassador Mohammed Maidugu and other big oga dem. For di visit, King Charles III and Queen […]

todayMarch 18, 2026 3

National

Keyamo Admit Say Na Because Akure Airport Fence Weak Ni Make Jaguda Boys Enter

By: Esther Ayoola Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, tuk on Tuesday for radio, Ilese-Ijebu, Ogun State, say na one weak link for back of Akure Airport, Ondo State naim allow jaguda boys enter di airport do nonsense. Di Minister say all airports for di obodo Naija sha get dia safety packages, travellers nor suppose fear, but wetin hapun dat day for Akure airport na di weak link […]

todayMarch 18, 2026 1

Lagos

LASODA Give 50 Disabled Workers Tools To Boost Work Productivity For Lagos

By: Esther Ayoola Lagos State Office for Disability Affairs (LASODA) don do give away to 50 physically challenged workers for different ministries, give dem beta working tools and technology to make dia work easier. General Manager, Adenike Oyetunde-Lawal tuk for di programme, wey dem call “Enhancing Productivity: Supporting Civil Servants with Disabilities,” say, na part of effort to boost work efficiency. According to di LASODA General Manager, di programme na […]

todayMarch 18, 2026 2

Lagos

Naija Secure £746 Million From UK To Upgrade Apapa, Tin Can Ports

By: Esther Ayoola Federal gornment say dem don get ogbonge support of £746 million financing from UK wey go hellep upgrade Naija ports. Minister of Marine and Blue Economy, Dr. Adegboyega Oyetola, yan dis one for Abuja, say dis money go transform Apapa Port and Tin Can Island Port for Lagos, di main ports wey dey handle more than 70% of Naija trade. Say di financing agreement, dem go officially […]

todayMarch 18, 2026 2

Lagos

Wike PDP Committee Hold Lagos Congress, Pick New Leaders

By: Esther Ayoola Say like dis, di Nyesom Wike-led Pipos Democratic Party National Caretaker Committee don hold congress for Lagos State on March 17, 2026, to elect new state executive members. Di party’s National Deputy Secretary, Adedeji Doherty, say delegates from all 20 local government areas and 37 local council development areas join dis particular exercise for Lagos. According report dis dey come because di Court of Appeal cancelling di […]

todayMarch 18, 2026 2

Lagos

Govenor Sanwo Olu Promise To Take Fake Goods

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don promise say dem go improve on consumer protection because of plenty bad goods and services wey dey enter di Lagos market. Oga Govo, Babajide Sanwo-Olu tuk dis one yesterday for World Consumer Rights Day wey dem dey call “Safe Products, Confident Consumers.” E press tuk say pipo dey lose billions of naira every year from fake medicine, defective goods, and misleading adverts. Sanwo-Olu, […]

todayMarch 18, 2026 3

National

Ondo Police, FAAN Disagree Over Who Dem Arrest For Akure Airport

Ondo State Police Command don disagree with Federal Airport Authority of Nigeria (FAAN) over di pipo wey dem arrest for Akure Airport on Sunday. Di Police tuk say di people wey dem arrest no be bandits, na ordinary criminals, and dem want make FAAN no misrepresent di case. Managing Director of FAAN, Olubunmi Kuku,  bin konfamate dat dem gbab four suspected bandits for Ondo airport. Say dem don alert di […]

todayMarch 17, 2026 7

National

Oyo State Gorment Tell Resident To Avoid Streams With Dia Waste

By: Esther Ayoola Oyo State Gornment don warn residents make dem stop open defecation and di way pipo dey dump waste anyhow for streams and waterways, say e fit weaken efforts to control erosion. Commissioner for Environment and Natural Resources, Ademola Aderinto, give di warning on Monday afta dem finish final inspection of some project sites under di Naija Erosion and Watershed Management Project supported by European Investment Bank. Places […]

todayMarch 17, 2026 5

National

FG Arrange Plan To Evacuate Nigerians From Middle East

By: Esther Ayoola Federal gornment say, dem dey arrange how to evacuate Nigerians wey dey trapped for some Middle East countries because of di ongoing crisis. Nor be amebo say di tension for di region rise afta United States and Israel carry out military strike against Iran on February 28. Tuk, tuk of di Ministry of Foreign Affairs, Kimiebi Ebienfa, say gornment dey work on administrative arrangements and release of […]

todayMarch 17, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app