Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

Senate Push FG Make Dem Rescue Kidnap Victims

By: Mariam Ajayi Senate don resume Tuesday, as Akpabio call for stronger action to rescue kidnapped Nigerians and protect communities. Akpabio make di call as senators return after dem go on recess since July 23, 2026. E say Senate go bring laws, money through budget and stronger monitoring to fight insecurity, flooding and di high cost of living wey Nigerians dey battle. Di Senate President also tell security agencies make […]

todaySeptember 29, 2026 8

OBODO NAIJA

US, Nigeria Move To Strengthen Security With 12 New Helicopters

By: Mariam Ajayi America and Naija don dey push dia security cooperation forward, as Naija plan to buy 12 AH-1Z Viper helicopters to boost di country defence power. US Mission for Naija reveal dis one for dia official X account on Tuesday, as e describe di planned purchase as part of di efforts wey both countries dey make to tackle current and new security threats. Di mission say America value […]

todaySeptember 29, 2026 10

OBODO NAIJA

Tinubu Meet Otedola For Private Dinner For Paris

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu on Monday meet billionaire businessman, Femi Otedola, for one private dinner for Paris, France, as di Presido continue im extended stay for Europe. Otedola reveal di meeting for im X account on Tuesday, as e share picture of imself and Tinubu dey smile together. Otedola show support for Tinubu economic policies, as e point to wetin e describe as gains from di government reforms. […]

todaySeptember 29, 2026 9

OBODO NAIJA

Tinubu Leave France, Dey Go Lagos For Political Meetings

  By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu don round off im vacation for France, as e don comot Paris dey head Lagos, where e dey expected to meet political big men and im loyalists ahead of 2027 election. According to statement wey im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, release on Tuesday, Tinubu plane go land for Murtala Muhammed Airport, Lagos, later today. Tinubu comot Abuja on August […]

todaySeptember 29, 2026 8

obodo oyinbo

Former Snooker Champ Graeme Dott Jailed Seven Years

By: Mariam Ajayi Former world snooker champion Graeme Dott don collect seven years prison sentence after court find am guilty of sexually abusing two primary school-age children. Di 49-year-old Scottish man repeatedly abuse one girl between 1993 and 1996, while di offences against one boy happen between 2006 and 2010. Dott appear before Lord Harrower for High Court in Edinburgh on Tuesday, where di judge say his actions take away […]

todaySeptember 29, 2026 10

National

Anambra To Prosecute Pipu Wey Deny Women Inheritance

By: Kofoworola Olayinka Anambra State Gornment don tell police make dem investigate cases where pipu dey stop women and girls from inheriting dia parents property because of gender. State Attorney-General, Tobechukwu Nweke, SAN, make dis known for letter wey e send to Naija Police Force on Tuesday. Nweke say di practice dey against court decisions and na crime under Anambra Violence Against Persons Law, wey fit carry up to four […]

todaySeptember 29, 2026 10

National

National Assembly Go Translate Laws Into Igbo Hausa Yoruba

By: Kofoworola Olayinka National Assembly Library Trust Fund say dem go soon translate Naija laws into Igbo, Hausa, Yoruba and other local languages to make legislative information easier for Naija pipu to understand. Executive Secretary of di Fund, Henry Nwawuba, yarn dis on Monday for Abuja during di 2026 National Assembly Library Week. Nwawuba say dem also dey upgrade di e-library and develop mobile app plus Bills Tracker wey go […]

todaySeptember 29, 2026 10

Sports

Iwobi Go Captain Super Eagles Against Guinea Bissau

By: Kofoworola Olayinka Fulham midfielder Alex Iwobi go captain Super Eagles tonight for dia 2027 AFCON qualifier against Guinea Bissau. Regular captain Wilfred Ndidi go start di match from bench, as Iwobi lead di midfield. Iwobi, wey don make 102 appearances for Nigeria, go hope say e fit help di team build on dia 2-1 win over Madagascar for dia first qualifier Iwobi go dey lead one reorganised midfield as […]

todaySeptember 29, 2026 10

Business

Minister Say Naija Get 26 Minerals Wey US Dey Find

By: Kofoworola Olayinka Industry, Trade and Investment Minister Jumoke Oduwole say Naija get about 26 out of 60 critical minerals wey United States dey look for around di world. Oduwole tuk dis during interview, say di recent US critical minerals agreement na MOU and e no legally bind both countries. She say Naija  no go export di minerals raw, as gofment dey work with US to develop local processing, battery […]

todaySeptember 29, 2026 19

National

NYSC Mourns Former DG Colonel Obasa

By: Kofoworola Olayinka National Youth Service Corps[ NYSC] don mourn former Director-General, Colonel Peter Kolawole Obasa, wey kpai on Monday, September 28, 2026. During condolence visit to di family for Ilorin, di current NYSC DG, Brigadier General Olakunle Nafiu, describe Obasa as one of di pipo wey build strong foundation for di scheme. Obasa serve as di third NYSC Chief Executive from 1979 to 1984, with General Nafiu saying di […]

todaySeptember 29, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds